Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,741 members, 7,817,047 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 12:46 AM

Somewhere Around Diobu Pt1 - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Somewhere Around Diobu Pt1 (354 Views)

Broken Pt1 (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Somewhere Around Diobu Pt1 by NanaArewa: 9:19am On Apr 30, 2019
Belema: mummy food dey?
Mama: Belema carry garri go drink no dey boda my life
Belema: But mummy no sugar for house oh
mama : Go kitchen you go see salt
Belema: Mummy no small salt remain oh
mama: Belem manage Wetin you see for diz house, if salt no dey carry d Garri drink like dat , after all your papa no drop any money before him comot

(Belema walks out with a gloomy face) some minutes later.
Belema: mummy thank you I don drink am finish
mama : Thank God my pikin
Belema: mummy my anty say make we bring 500 Naira for our report card 2moro
mama : Belem go rest 2moro I go give

NIGHT
Belema: mummy why daddy never come back na?
mama : him go soon come back him dey road
Belema: mummy your wrapper did side down tear oh wen you go buy new one?
mama: wen I get money I go buy new one
Belema: mommy since I can back you Neva chop oh
mama: Belema shutup! go sleep it's oyaoya you talk dey talk abi night never cover for our eyes if I hear pim again
Belema : sleeps off

Midnight
Belema hears sounds and wakesup daddy oyoyo !!!
papa : (drunk) Comon comot for my road stupiiiiid pikin night never cover for our eyes abi Yur mother son possess you
mama:alabo wetin day wan Kon mean na? which kind stupid and irresponsible man you be?? na now Tue fellow men dey Kom back?? since morning wey you komot you no drop money for food ohh, you no even talk where you dey go you just go drink Kaikai dey mad dey com back
papa : Tozaaaah (alabo lands mama Belema a heavy slap) Comon shurrup! yeye woman na d welcome you go give man wey manage kip you for house? yen yen yen yen yen comot for road I wan sleep no talk pass your mouth diz night if not you go get am hot
mama: (crying ) Also thunderfire you.. you go regret for all this things you dey do me and diz pikin (breaks down crying )
Belema: mummy sorry mummy no dey cry e Don do.
Papa : WOMAN!
mama: Also wetin you want again?
papa : Kim climb this bed
mama: climb which bed? so you still wan sleep with the woman wey you just harass now now in front of her piking? Chai Alabo you no get shame
Papa : If I com down from did bed I go do am anyhow oh

wait for part two, this na pidgin story oh na fiction and una new pidgin writer remain me wey dey in the person of NanaArewa feel free to email me on adamspeace2020@gmail.com for any corrections or additions thank you

(1) (Reply)

Novel-shades Of Bitter Revenge / Until I Met You - Semi Final Episode / Rain Again (A Poem)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 14
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.