Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,112 members, 7,814,901 topics. Date: Wednesday, 01 May 2024 at 10:42 PM

Faith Academy Ota Teacher Beat Semikolo Emekeme Pikin Faint - Religion - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Religion / Faith Academy Ota Teacher Beat Semikolo Emekeme Pikin Faint (1569 Views)

Winners Chapel Constructing 1000MW Plant In Ota / Canaanland Ota In Pictures / Bishop Oyedepo Preaching Near Devils Shrine In Sango Ota (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Faith Academy Ota Teacher Beat Semikolo Emekeme Pikin Faint by designking: 10:56am On Sep 27, 2019
SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER

27/09/2019

BISHOP OYEDEPO TEACHER BEAT SEMIKOLO EMEKEME PIKIN FAINT

Dem say weytin bad, nai some people dey cover make the news for nor spread. Approaching my 8 Years as Facebook Journalist, I don unravel so many atrocities for the town and beyond. Even wen people try to code things, I still dey get to know and fire the gbwa.

I nor wan too talk this morning, but make I draw the attention of Bishop David Oyedepo to one nonsense thing wey one of he teacher do one Sapele pikin for Faith Academy for Ota.

We all know say na Winners Chapel nai get Covenant University and dem dey nai still get Faith Academy wey be Secondary School for inside Covenant University for Ota, Ogun State. We all also know say the school dey inculcate and imbibe morals for the students. But if you must inculcate discipline on the children, nor be by beating.

Na one teacher wey dem dey call Chaplain Voke Ovome nai beat Deacon SEMIKOLO EMEKEME son, wey dem dey call David Emekeme. Him na SS2 student for Faith Academy for Ota. As we speak, the pikin dey for Canaan Land for Covenant University Hospital for the past 3 days and even Deacon SEMIKOLO and he wife dey yonda since the past 3 days.

Now, the school wey claim say dem be Christian School, wan try to hide this issue make e nor reach Bishop Oyedepo hand. Now, we dey update this to the whole world to draw the attention of Bishop David Oyedepo to this case. Make dem provide the teacher wey wan form James Bond for SS2 pikin body as he beat a whole Sapele pikin faint.

Bishop David Oyedepo and Winners Chapel Church, We need to practice weytin we dey preach. Take action against the teacher now before he go do the one wey worst pass so.

I Remain The Otota1 Of Sapele.
The Ukpe1 Of Okpe Kingdom.
The Asamaigor1 Of Warri.
The Eagle Eyes Of Delta State.

God Bless Sapele.

If you hate wetin this idiot do,say Hi.
If you like e actions say Nil.

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.

Re: Faith Academy Ota Teacher Beat Semikolo Emekeme Pikin Faint by HigherEd: 5:19pm On Sep 27, 2019
That's definitely Covenant uni health center but I'm not sure that's FA's uniform. Hope the church investigate and get to the root of this matter.

Lalasticlala

1 Like

(1) (Reply)

Why Does Jesus Need An Army? / Download These 40 Ebooks, Mp3 Audios And Videos By Dr. Mike Murdock {ecourse} / 7 Costly Mistakes Of People With Great Destiny

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 11
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.