Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,371 members, 7,822,743 topics. Date: Thursday, 09 May 2024 at 04:10 PM

I Told You Nigeria Would Kill You... - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / I Told You Nigeria Would Kill You... (1431 Views)

Kano Votes Alone Can't Make You Nigeria President - Reno Omokri To Kwankwaso / Nigeria Would Have Been A Better Place If My Husband Did Not Die: Turai Musa Yar / FFK Replies Sultan: 'If Christians Had Taken Up Arms, Nigeria Would Have Burnt" (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

I Told You Nigeria Would Kill You... by Nobody: 3:54pm On Mar 29, 2020
Tell Buhari to address these things later this evening, cos I no dey like to vex.

1. What is Buhari doing to ensure we have enough test kits to test patients with covid-19 symptoms?

Test kits no dey. The small one wey dey na for the rich. Lagos alone go get up to 30thousand corona virus victims, but who go test them? You see why we dey feel say na big man virus? Cos na only big men dem dey allow do the test. The rest of us just dey hope say we no get the virus. We just dey hope say SUN wey dey this country and SUFFER wey we don experience no fit allow virus dey our body..na only hope we fit hope..

2 Likes

Re: I Told You Nigeria Would Kill You... by moscyt(m): 3:54pm On Mar 29, 2020
Hmmnmn
Re: I Told You Nigeria Would Kill You... by APCNig: 3:56pm On Mar 29, 2020
About 100 confirmed cases and thousands of unconfirmed cases, but only one death of an already sick and weak man, definitely Nigeria has killed Corona Virus just as we killed Ebola.

2 Likes

Re: I Told You Nigeria Would Kill You... by Nobody: 3:59pm On Mar 29, 2020
2. People wey close their business for 2weeks, 3weeeks, 1month.....wetin dem go chop?
What're the arrangements on ground? Abi we go hide from covid-19 con die from hunger? We want Buhari to tell us how he intends to make sure food is given to everybody. All the billions wey I dey hear say people dey donate, how we wan take get our share? We need these information. Somebody say make dem print more money? Una wan print money? How I wan take get my share.? Abi the money na for a select few? Na politicians money? We need answers cos this wahala don too much...

2 Likes

Re: I Told You Nigeria Would Kill You... by Nobody: 4:17pm On Mar 29, 2020
3. You talk say border don close, how come things still dey enter this country? How come goods still dey enter this country? How come people still dey enter this country? Why this border dey too hard to close? Cos na still the same "closing" and "border" na make we are were we where today. Cos in children need to come back home. Them come back con begin share covid give everybody.


4. After you address Nigerians today, hope say e no go take another 2months before you talk again? Why Buhari dey run from us? Wetin we do? Why you no like to address us? You dey fear us? Abi we no reach? Abi you dey see us as slaves? Abi you no too well? Wetin be the problem? We want to know.... Nigeria needs their President.

2 Likes 1 Share

Re: I Told You Nigeria Would Kill You... by Nobody: 4:18pm On Mar 29, 2020
APCNig:
About 100 confirmed cases and thousands of unconfirmed cases, but only one death of an already sick and weak man, definitely Nigeria has killed Corona Virus just as we killed Ebola.

How? How exactly has corona being killed?

1 Like

Re: I Told You Nigeria Would Kill You... by viccipedia: 4:24pm On Mar 29, 2020
APCNig:
About 100 confirmed cases and thousands of unconfirmed cases, but only one death of an already sick and weak man, definitely Nigeria has killed Corona Virus just as we killed Ebola.
i piri u

1 Like

Re: I Told You Nigeria Would Kill You... by sonofspada(m): 4:26pm On Mar 29, 2020
DDeliverer:
3. You talk say border don close, how come things still dey enter this country? How come goods still dey enter this country? How come people still dey enter this country? Why this border dey too hard to close? Cos na still the same "closing" and "border" na make we are were we where today. Cos in children need to come back home. Them come back con begin share covid give everybody.


4. After you address Nigerians today, hope say e no go take another 2months before you talk again? Why Buhari dey run from us? Wetin we do? Why you no like to address us? You dey fear us? Abi we no reach? Abi you dey see us as slaves? Abi you no too well? Wetin be the problem? We want to know.... Nigeria needs their President.

Answer to question no.4
He is not the one running the government. E get people, strong men wey dey tell am wetin to do, him wife talk am and since then we never read better news from her again. So my guy, this shit go smell pass like this.

1 Like

Re: I Told You Nigeria Would Kill You... by Nobody: 4:31pm On Mar 29, 2020
sonofspada:


Answer to question no.4
He is not the one running the government. E get people, strong men wey dey tell am wetin to do, him wife talk am and since then we never read better news from her again. So my guy, this shit go smell pass like this.

Shey we hear say na Abba kyari dey control Buhari. And kyari no well. Abi na from sick bed Kyari dey run the government? Abi other people dey background wey we no even know? This wahala no too much?

1 Like

Re: I Told You Nigeria Would Kill You... by sonofspada(m): 7:56pm On Mar 29, 2020
DDeliverer:


Shey we hear say na Abba kyari dey control Buhari. And kyari no well. Abi na from sick bed Kyari dey run the government? Abi other people dey background wey we no even know? This wahala no too much?
. Look up Maman Daura
Re: I Told You Nigeria Would Kill You... by TooMuchStuff: 7:56am On Apr 18, 2020
Isa Funtua
Mamman Daura
Babagana kingibe
Abba kyari•••••••• dead
Sultanate
Re: I Told You Nigeria Would Kill You... by Nobody: 3:41pm On Apr 19, 2020
TooMuchStuff:
Isa Funtua
Mamman Daura
Babagana kingibe
Abba kyari•••••••• dead
Sultanate

Na the cabaal be this...wahala dey
Re: I Told You Nigeria Would Kill You... by ZombiePUNISHER: 4:24pm On Apr 19, 2020
Anyone waiting for palliative from the government is wasting his precious time...

All the funds donated including the 21 billion from the EU have been successfully looted by this administration...

The worst is that the numbers are on the rise despite the audio lock down .... So definitely it will still be prolonged

Like someone said
This sh*t go smell wella

1 Like

(1) (Reply)

FG Grants Three-year Tax Holiday To 25 Companies / COVID-19: Where Are Buhari And Osinbajo? – Reno Omokri / Bloomberg Hits At Nnpc: Oil Company That Can’t Fix Refineries Wants To Build Hos

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 28
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.