Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,362 members, 7,812,030 topics. Date: Monday, 29 April 2024 at 06:39 AM

Some Interesting Warri Proverbs That Will Make Your Day - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Some Interesting Warri Proverbs That Will Make Your Day (595 Views)

Warri Proverbs That Can Make You To Crack Your Ribs / Warri Proverbs That Can Make You To Crack Your Ribs / Pidgin Proverbs That Will Crack You Up. (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Some Interesting Warri Proverbs That Will Make Your Day by jzamani(m): 10:18am On May 06, 2020
Warri Proverbs
1. Na person wey never see problem dey use English dey pray.

2. Book wey no gree enter head go enta exam hall

3. Goat wen get mind follow lion go catch fish, make e know say weda dem catch fish or not, Lion food don set oh.

4. Who naked no dey chuck hand for pocket…!


5. Wetin concern dog wit family planning?



6. Na determination dey make Okada overtake trailer for road.

7. This one good, this one good, na em mad man take dey gather plenty load.

8. Pikin wey go strong go strong…. No be say until dem name am Samson.

9. Na over confidence make February no complete.

10. Do you know who I am? Do you know who I am?..Naso hold up take dey start.

11. Head wey no wan think go carry load.

12. Hand wey stay long for pocket, know say nothing de that pocket.

13. Forget Trust If trust dey, Water nor for boil Fish.

16. No matter how lizard do press-up reach, e no fit get muscle pass crocodile.

17. E de clear pimple, e de clear pimple na so bleaching de start.



18. Feel at home, feel at home, na eim dae make visitor spoil remote.

19. Escort me, escort me naso slave trade take start.

20. It’s a small world!! No mean say you fit trek from Naija go London.

21. Christianity is free, but you must buy Bible.

22. Person nor dey use shame chop winch o.

23. Make I chop this guy money, Make I Chop this guy money. Na so ashawo take start oh.

24. You no need spoon and cutlery to chop slap.

25. Jollof Rice wey dey for bottom of pot 2day go dey for top of cooler 2moro.

26. The patient dog … Nah hungry go kill am.

27. Na I go do am later na e make fowl no fly like other birds.

28. No food for lazy man no be for pesin wey em mama get restaurants.

29. Who dey hold landlord rentage no dey fry stew way curry dey.



30. I am covered by the blood of JESUS E no mean say make u no lock door sleep oooh.


You can add yours

3 Likes

Re: Some Interesting Warri Proverbs That Will Make Your Day by sim37(m): 10:54am On May 06, 2020
[color=#000099][/color] ;Dwoman wey de fine pikin no dey wear pant sleep

1 Like

(1) (Reply)

[memes] 17 Memes You Will Get If You Attended School With Your Younger Ones / 5 Things Pained Ladies Say About The Stingy Men Association Of Nigeria(sman) / Just For Laughs

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.