Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,839 members, 7,810,229 topics. Date: Saturday, 27 April 2024 at 01:08 AM

Letter To My 90's Babies - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Letter To My 90's Babies (407 Views)

Letter To The Extroverts, From Sassynigerian / Letter To The Introverts, From Sassynigerian / Letter To The Grudgeful Soul From Anothernigerian (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Letter To My 90's Babies by Farastein(m): 3:08pm On Jun 12, 2020
How we dey?... I know say we go just say fine; Na automated reply. But really, "How we dey?" Dem born us in unique times and we all dey a unique point in our lives for this year 2020. We generally dey in our 20's now. The oldest of us dem dey 30, and the youngest dem dey 20. So, generally, we all gather dey our 20's this year 2020.

1 Like

Re: Letter To My 90's Babies by Farastein(m): 3:09pm On Jun 12, 2020
E no easy na. Na the adult life oh wey dem be dey talk that time be this. The life dey run. But the way the Nigeria is set up, a lot of us still dey part of the Dependency Ratio. In fact, e gats be the majority of us from the alarming crime rate and delinquency wey dey Nigeria as it stands. A good number of us sef still gather full school as undergraduates, as well as another increasing percentage of us wey dey return back for post-graduate; for Masters.

2 Likes

Re: Letter To My 90's Babies by Farastein(m): 3:10pm On Jun 12, 2020
We don reach the ages wey our parents take born us, yet the majority of us never even begin dey pay rents for ourselves. Jobs wey we go regard as well-paying just dey scantily available; mostly reserved for the "connected". Our times no dey exactly like our parents times at the start of the 90's. No more getting job on school cert (WAEC) again. No more bread ₦1. E dey a lot harder to make Our Daily Bread in the current Nigeria. Na why things like 419, runs girl just drastically increase with our own set.

3 Likes

Re: Letter To My 90's Babies by Farastein(m): 3:11pm On Jun 12, 2020
Yet we gats still bear the cross, and for those of us wey get parents wey still dey bear the cross reach now, we gats always dey grateful and dey thank dem. The responsibility still dey our shoulders sha, no matter how long person else dey do for us. We gats too become parents and begin pay rents and our way through the life for ourselves. We done even invent a new class of society for ourselves. We done dey become Dependent Parents. We dey try cater for children as our parents still dey cater for us.

1 Like

Re: Letter To My 90's Babies by Farastein(m): 3:12pm On Jun 12, 2020
Na we internet and social media come jam for Nigeria at this very stage for the ladder of life. Some of us dey use am dey commit the crimes, others dey use am depress themselves, the majority of us just dey, caught up with the "trend-keeping". With just a slowly rising few wey dey use am somehow add values to their lives and demselves. Fiverr and other freelance sites done dey allow a few of us offer our learn skills as services as ways to earn the égò, but exclusively for those wey get online sellable skills. Google Adsense too don provide avenue for bloggers, for YouTubers and the likes. The internet don provide avenue to generally advertise whatever service or product we get for sale.

1 Like

Re: Letter To My 90's Babies by Farastein(m): 3:15pm On Jun 12, 2020
Network marketing dey, but the era of MMM done spoil the minds of Nigerians generally towards just ventures. Bitcoin &
other cryptocurrencies, Forex dey, but the dey generally beyond the scope of those wey no get the training. And these trainings no generally dey come cheap. And there's only so much person go fit learn for free online.

So wetin be the way forward?

Oya na, follow the revolution for @afroagropower for Instagram and on Facebook where we dey always innovate on the matter.

3 Likes

Re: Letter To My 90's Babies by Farastein(m): 3:16pm On Jun 12, 2020
I be see funny Whatsapp status today wey dey ask how Whatsapp status take turns Oshodi wey everybody dey sell shoes, bags, perfumes and clothes. Maybe last-last, we all Whatsapp status go dey like Mile 12 and na foodstuffs and land we go dey sell. Maybe last-last our Whatsapp status go dey like Fiverr where we go meet clients wey go pay us sharp for skills online when Afro Agro Power done blow.

Anyhow sha, e go better. E gats better. And e must better when we all see the light and join hand to grow the Nigeria like seed, with Agriculture.

Una do well oh. Thank you.

1 Like

Re: Letter To My 90's Babies by DeejayTeeno(m): 4:04pm On Jun 12, 2020
Lol.. content writing in anOther dimensional enrOuTe! grin

E remain the yOruBa and IGBo versiOn siR.. absOLuTeLy, Love it tho!

Lol.. Meanwhile, what's your WhatsApp number?
09098092258.

Nigeria NaH ToTaL dump!
This Africa done TireD me mehnnnnnnn!!

cool

2 Likes

Re: Letter To My 90's Babies by Sheriman(m): 4:39pm On Jun 12, 2020
Farastein:
Na we internet and social media come jam for Nigeria at this very stage for the ladder of life. Some of us dey use am dey commit the crimes, others dey use am depress themselves, the majority of us just dey, caught up with the "trend-keeping". With just a slowly rising few wey dey use am somehow add values to their lives and demselves. Fiverr and other freelance sites done dey allow a few of us offer our learn skills as services as ways to earn the égò, but exclusively for those wey get online sellable skills. Google Adsense too don provide avenue for bloggers, for YouTubers and the likes. The internet don provide avenue to generally advertise whatever service or product we get for sale.
Use this internet opportunity era to create wealth for yourself

1 Like

Re: Letter To My 90's Babies by Farastein(m): 9:14pm On Jun 18, 2020
Thanks sire, I'll do well to reach you via Whatsapp ...
DeejayTeeno:
Lol.. content writing in anOther dimensional enrOuTe! grin

E remain the yOruBa and IGBo versiOn siR.. absOLuTeLy, Love it tho!

Lol.. Meanwhile, what's your WhatsApp number?
09098092258.

Nigeria NaH ToTaL dump!
This Africa done TireD me mehnnnnnnn!!

cool

1 Like

(1) (Reply)

The Christian Wife - Episode 2 / Bad Habits Successful People Do Avoid / S'oro S'oke - A Novel

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 21
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.