Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,160,791 members, 7,844,571 topics. Date: Wednesday, 29 May 2024 at 11:55 PM

Gun Men Demolished Nigeria High Commissioner To Ghana Staff Resident. - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Gun Men Demolished Nigeria High Commissioner To Ghana Staff Resident. (226 Views)

EndSARS: Protesters Force Odumosu, Lagos Police Commissioner To Trek 10km / Nigerians React As South Africa High Commissioner To Nigeria Denies Xenophobia / Pakistani Lady Is Secretary To Nigerian High Commissioner To UK (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Gun Men Demolished Nigeria High Commissioner To Ghana Staff Resident. by bishopmc(m): 11:54am On Jun 22, 2020
Ghana Deputy Foreign Affairs Minister, Charles Owiredu say what happun during de early hours of Saturday de unfortunate.

Owiredu tok BBC say, "what happen during de early hours of Saturday be unfortunate, de High Commission and Embassies be inviolable within de Vienna Convention."

"You no fit enter diplomatic mission without invitation, wey de responsibility to protect a diplomatic mission dey with de host which be Ghana, so go deal with that issue" Mr Owiredu add.

Mr Owiredu talk BBC Pidgin say dem gather some info say de demolishing be linked to some land ownership struggle between de Nigeria High Commission den Osu Traditional Authority for Accra.

Why Occupy Ghana dey accuse govment of 'massaging' coronavirus death figures
Filth take over parts of Accra streets after floods kill one, displace some residents
Armed men for Ghana storm de residence of Nigeria High Commission for Ghana plus bulldozers which dem take destroy some buildings on de property.

De building wey dem demolish be new property wey dem dey construct for staff den visiting diplomats to de High Commission.

According to Accra-based Joy FM, one armed man allegedly threaten de Nigeria High Commission staff present say he go 'clear dem off' if dem interfere.

Head of security for de High Commission, Emmanuel Kabutey talk Joy FM say dem get backing of National Security so "if any of us try, he go clear us off."

According to Mr Kabutey, "when police come, dem no talk dem anything, instead dem go straight to de man [leader of the armed men] wey dem have friendly chat plus am, exchange numbers wey dem allowed am to go."

Police come de property come take pictures of de demolished building but de eyewitnesses say dem no talk dem anything.

De incident wey happen last week Friday make Nigerians vex, including Foreign Affairs Minister for Nigeria, Geoffrey Onyeama.

Ghana govment condemn attack on Nigeria High Commission
Ghana govment condemn attack on Nigeria High Commission, as dem open investigations into de matter.

Ministry of Foreign Affairs for statement inside reveal say "investigations dey go on to unravel de facts of de matter den bring de perpetrators to book."

"Dis be matter dey worry, de development dey go against de Vienna Convention on Diplomatic Relations...We express regret over de incident" dem add.

Ghana authorities no give details on who dis unknown individuals be but dem assure de diplomatic community den Nigerians of dema safety.

Dem since beef up security for de premises of de Nigeria High Commission.

Re: Gun Men Demolished Nigeria High Commissioner To Ghana Staff Resident. by Okoroawusa: 12:05pm On Jun 22, 2020
Pidgin English the same from Lagos,Accra n Freetown.

Na uncompleted staff building dem demolish a part sef. News come dey talk like say na Nigerian Embassy dem demolish. Well Ghana don already apologize.

(1) (Reply)

Kogi Lawmaker, John Abah, Is Dead / Help Me With This Question Concerning The New Development In APC / Did Security Agencies Foil Planned Hezbollah Attack On Lagos?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 11
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.