Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,031 members, 7,818,046 topics. Date: Sunday, 05 May 2024 at 05:56 AM

Nigerian Youth! Our Sentiment Is Letting The Elite Defeat Us - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Nigerian Youth! Our Sentiment Is Letting The Elite Defeat Us (198 Views)

Igbophobia and Anti-igbo Sentiment Is Real / North East Youth - "Our Rejection Of Shettima Stands" / Nigerian Youth! Our Destiny Is In Our Hands: Tell Everyone Hope Is On The Way (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Nigerian Youth! Our Sentiment Is Letting The Elite Defeat Us by Nightwolves: 4:39am On Jul 18, 2020
the way the matter dey do me for body make me Repost this thread.

The matter don dey pain me for body since but na this thread

https://www.nairaland.com/5170646/billionaire-lifestyle-nigerian-politicians-poverty

come make am touch my liver well well.

All of us youths need to come together as one whether Igbo, Yoruba, Hausa, Muslim, Christian, or traditionalist, e no matter.

If we go fit close our eyes to the artificial differences wey dem take dey oppress and thief us blind, una go understand say Nigeria dey salvageable, and our collective enemies wey no many reach we wey dem dey oppress go run leave this country if dem get the chance.

Person wey know himself no fit die two times, na only coward dey die before him real death come.

Nigerian matter don dey weigh me down for too long and I no fit pretend say e no concern me again. Even if I go lose my life in the process to get one better movement going to begin to reclaim our country back so that we go get something to enjoy small for the small life wey still remain for us, and to also get something and country to handover to our children wey dem don born and the one's wey dem never born, I no mind at this level abeg.

Na 2023 dey come so and na another election dem wan do. The same thieves wey don destroy our country and future don already dey warm up and the worst thing be say na youths like us dey project and sing their praises even though say dem know say these people na we collective enemies wey no care about us but for themselves and their families.

For the forty years wey I don live for this life and country, na the same people wey don rule from when dem dey their 20s and 30s still dey rule us even when dem don reach 80 years. These one's na people wey be say dem don suppose retire make we the youths dey take care of dem.

My papa na 75 years him don retire since. Me don move out comot from him house start my own family as things suppose be. The only thing wey I owe my parents na to care for dem but dem no fit decide how I want take live my life with my family. So, why the case go dey different for national or governance level.

These one's na people wey don rule my papa, rule me, rule my children wey I Don born, want still rule the one's wey I never born, before their children go still come take over from where their parents stop. Haba na, even if na juju, e suppose get expiry date.

As I dey write for pidgin so, no be say I no sabi Eliza language oh, but the level be say, I want make sure say my message reach and enter our people head well because this pidgin so, na him be the one language wey we all get in common. Whether you go school or not, this pidgin na him be the language wey we all take dey communicate so tey even our old people for village go understand wetin we dey talk and where we dey go.

You see the language issue, all the big big grammar wey the politicians dem dey speak na him dem take dey thief, alienate, sideline, confuse, threaten, and make the generality of our people docile and lack interest for the governance issue and process. Dem dey deliberately use big grammar take bamboozle and intimidate the poor people wey dey the majority and make dem lose hope for governance matter.

By the time we fit use pidgin like this take carry everybody along and make dem understand say the people wey we dey call leaders na looters and enemies of state, we all go begin see the change wey we want and a reawakening go begin happen.

Nothing stop us to come together to begin to dey angle for the 2023 through this movement wey me dey propose from here so.

The truth be say nothing wey we no go fit achieve if we come together with one mind and say "enough is enough" make we take back our country and future to determine how we want make e go.

If na money to take face the thieves dem that one no be problem we go fit raise money to match dem if we unite abi no be we be the youths wey dey control the cyber-world and fund raising? If na to create publicity for our movement that na small thing, abi no be we youths dey handle the old people social media accounts plus go sing for dem during their rallies?

The truth be say, we get everything wey we need to take change our lives and decide how we want make our country be.

This movement go be all inclusive and everybody go get chance to take talk him own on how him want make we take tackle and handle things wey we want do.

We all know say the major and number one problem wey we get with our country na the nonsense wey dem dey call the present government-bible (constitution). That constitution na wetin dem purposely arrange to take favor all the nonsense wey dem dey fit do today. So, the first thing wey we go do na to siddon, hold mock constitutional review committee online after we all don study the present nonsense to know wetin we go remove and add to make am a true government Bible, and to make am difficult for any one person to take do anyhow because by then we go don arrange well so that anybody wey do anyhow go see anyhow based on our collective agreement.

From there we go decide wetin to do with the people wey don mismanage our common wealth and corner everything for them and their children. Whether na to build zoo pack all of dem put while we negotiate for dem to refund so that we go get money take begin rebuild oh, or to forcefully strip dem of everything and waste dem oh, na we all go come decide wetin we want by then. But the truth be say things no go ever remain the same again.

As the matter dey go, we go leave their demonic APC and PDP for dem. We go find our own level to match dem one on one as we proceed.

Abeg my fellow youths, make una no believe say Nigeria no dey salvageable come dey run go another man country when e be say las las you must come back house and another man country no go ever fit be like your own country and by then na one person wey no even go primary school na him go come become political leader for your country because him no run like you and na him go dey determine how the country wan be whether you like am or not.

Me wey this matter dey so for body like this ehn, this same suffer head because of useless leaders don make me run go oyibo country go do all sorts of rubbish just to survive and at the end of the day I don come back to my country na still the same bullshit wey make me run before still dey go down and even worse sef.

Any time una dey say Nigeria don finish, e no fit change again, or "the best thing na to run comot for this country no look back again", the thieves mind dey sweet because dem know say nobody dey challenge dem.

Abeg make we all come together begin to dey discuss how we want take do our matter and future. Only one person no go fit do this matter that's why I dey beg una to come with una suggestions, ideas and expertise make we start this movement and begin to rally people of like minds to join and close ranks with us.

I just open this thread for this movement and idea sharing.
Abeg make everybody wey know say the status quo don tire am and him wan see change come this thread and direct people come make we begin discuss. Even if you no sabi pidgin, abeg come drop your idea or suggestions for Queen Eliza language, kpatakpa I go interpret am for others to understand.

Make una no vex for my pidgin abeg, I no fit come this life just go like dat without making any impact for my life, generation, and country

The Nigeria issue really is bad. And its good that we already know that its ONLY possible to make change if and only if we do it in a group formation. Remember, there is ALWAYS POWER IN NUMBERS.

The question is HOW do we as Nigerians get this change we NEED?
We have a lot of problems which birth more problems making Nigerians find it hard to live in Nigeria.
•Political thuggery,

•Police /SARS brutality (I have been on gun point with the police for at least twice for absolutely no reason).,

•Election rigging,

•Unemployment (imagine jobless Nigerian buying Jobs especially govt jobs as high as 250,000 per slot, that's if you'll even get the job.

•Gross decay of our educational system,

•Mind blowing corruption ( like seriously, in Nigeria -snakes can swallow Billions of Naira, rats can invade a presidential villa and Billions be spent to repel the rats. and its fine for our government to dole out this crazy news knowing that dumb Nigerian will just make jokes about it and calm down, comedy is all we like right?

Worse so, youths don't have jobs in Nigeria and worst is that other countries either deny us entry or restrict Nigerians from employment in their countries. This makes us stuck in odd positions of unemployment, impoverished living, stress etc while our Rulers are killing us in and out.

The list of our wahala is endless and mostly linked to our government (both the voters and the voted for and more especially the clowns that refuse to ever vote).

So the question is still. What or How can the change be achieved?


We should try as much as we can to get students and young professionals involved in this movement. It is our movement, our future, our lives, and our country at stake. We can't be as docile as our parents had been to leave it all to the demons while sitting like lame ducks who'd complain and resort to prayers of "God dey" to wish it out. We are taking action to wrest our country from the stranglehold of the vampires such that our kids born and unborn would be proud of us when they hear or read the history of our patriotism and quiet revolt.

Needless to say , the so called 20 years of democratic dispensation has not only dispensed with the lives and welfare of the Nigerian people, the so called transition is notting but a transition from military dictatorship to civilian authoritarianism. The past 20years have however revealed that the PDP & APC have no fundamental difference other than such difference that exists between an armed robber and 419. both anti-poor parties are like the biblical satan who have only come to steal from the masses , kill them with bullets of poverty , insecurity , inadequate healthcare and finally to wreck destruction on their Future.

Re: Nigerian Youth! Our Sentiment Is Letting The Elite Defeat Us by Prmedia: 5:19am On Jul 18, 2020
angry angry

(1) (Reply)

The True State Of Nigeria, A Case Fact / Anambra Erosion Menace: Threat Has Become More Social Than Environmental- NEWMAP / I Never Said NASS Members Got 60% Of NDDC Contracts – Akpabio

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 27
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.