Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,238 members, 7,818,799 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 04:17 AM

African Music Stars Wey Don Ready Ground To Scata 2021 - Celebrities - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Celebrities / African Music Stars Wey Don Ready Ground To Scata 2021 (248 Views)

Burna Boy Tops Cnn’s List Of 10 African Biggest Music Stars |see Full List / PHOTOS Of Clarence Peters And Music Stars In Various Video Shoot / “my Face Dey Burn”–human Ken Doll Wey Don Do 60 Plastic Surgeries, (2) (3) (4)

(1) (Reply)

African Music Stars Wey Don Ready Ground To Scata 2021 by stupidmod2: 4:00pm On Jan 07, 2021
Omah Lay - Nigeria

Omah Lay catch pipo attention afta e bin drop Bad Influence. Na from im EP Get Laid, that gbedu land and even im recent work, What Have We Done, na hit back to back.

Na im be one of di pipo wey dey ginger di collabo of Afrobeat and soul. E bin don already work with American singer and rapper 6lack.

But last year, kasala burst for im side small wen dem arrest am say im break coronavirus restrictions for Uganda.

However di way pipo for social media para, campaign make dem release am ehn, show say true-true im fans loyal.


KiDi - Ghana

For 2020, KiDi show imself with di song Say Cheese wey blow sotay American singer Teddy Riley collabo with am for di remix.

Di singer also get accolades for im album Sugar afta e win album of di year for 2020 Ghana music awards.

E don follow collabo with oda celbs for West Africa dem, like Davido and Mr Eazi.

Tems - Nigeria

Afta she blow with her 2019 single, Try Me, Tems show say na she own how she dey sing for di music industry.

She sef don dey follow build fanbase for Nigeria and around Africa, sotay she follow for who social media para make dem release from Uganda.

With di release of her EP, For Broken Ears, e be like Tems don ready to take ova 2020.

Elaine - South Africa

Elaine don show herself as one of di R&B singers for di continent.

Her 2019 song, You're the one see her become one of di most streamed artist for South Africa.

And she no too do bad for herself as di 21 year old land herself record deal with Columbia Records.


Xerox knight - Nigeria

This pickin dey rap like dat guy erriga, him nah porthacourt base rapper wen relocate come lagos, like he say nah for lagos the koko they happen, so make una look out for am through google him self don feature small big artist to gather fan base


Sha Sha - Zimbabwe

Sha Sha na anoda ogbonge musician wey comot with blast for 2019 wen she drop her EP Blossom.

Di Zimbabwe born singer take di continent by storm sotay, Spotify list am as among di top ten most streamed female artist for South Africa for 2020.

E neva finish for dia as last year she bin win Best New International act for di BET Awards.







MEANWHILE, ARE YOU A MUSIC ARTIST? CHECK MY SIGNATURE

1 Like

(1) (Reply)

Uganda Election: Davido Declares Support For Bobi Wine Against Museveni / Broda Shaggi On Set With Mr Marcaroni & Zubby Michael (video) / Full Album Is Out! - The Gospel Song Everyone Is Talking About, APOTI ERI

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 11
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.