Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,459 members, 7,816,079 topics. Date: Friday, 03 May 2024 at 02:47 AM

Why WHO Remove Nigeria For Pfizer- Biontech Vaccine Sharing Formular - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Why WHO Remove Nigeria For Pfizer- Biontech Vaccine Sharing Formular (195 Views)

APC Zoning Formular Disqualifies Asiwaju Tinubu As Muslim Muslim Ticket Unlikely / Atiku Abubakar Receives Pfizer COVID-19 Vaccine In Dubai (Photos) / 2019: Pdp's Power Sharing Formular (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Why WHO Remove Nigeria For Pfizer- Biontech Vaccine Sharing Formular by BuhariCarryGo: 9:44am On Feb 09, 2021
Di Nigerian goment say di World Health Organisation fail to shortlist am for di Pfizer vaccine no becos e no get facility to store di vaccine but sake of di death rate of di virus for oda African kontris dem. Di oga kpata-kpata of Primary Health Care Development Agency, Faisal Shuaib yarn tori pipo dis one for Abuja as e dey try deny local tori say WHO disqualify di kontri. Di WHO -led COVAX global initiative bin choose Cape Verde, South Africa, Rwanda among di first kontri to get di first doses of di vaccine. Nigeria bin don announce and ready to receive 100,000 doses of di vaccine sometime for end of January or early February but for last minute, di WHO change dia mind plus formular on top which kontri deserve di vaccine pass. Oga Shuaib say di reason why di world health body choose dis oda kontri na sake of di number of new cases, di trend in di number of cases, di population of di kontri and di availability of di cold chain equipment. E further explain give say kontris like South Africa wey get di Pfizer allocation na sake of say dem get new strain of di Covid -19 virus and di number of death dey high for di kontri. And for Cape Verde and Rwanda, di kontri dey small and even di few doses wey dem go give dem, e go epp dem well well pass Nigeria. Di world Health Regional Director, say for Africa, Nigeria bin dey among di nine kontris for di continent wey suppose get di Pfizer vaccine, but unfortunately, e no come dey easy to give all di 51 kontris wit di Pfizer doses as e no go achieve di desired result. E say even though Nigeria no get di initial 100, 000 doses of di Pfizer vaccine, e go get di 16 million AstraZeneca doses sometime for February. And dat one go cover more population pass di Pfizer one. Di AstraZeneca/Oxford vaccine still dey under review but di WHO representative assure say di result go come out soon. 'WHO no fit disqualify Member State to get approved vaccine' - WHO Representative World Health Organisation representative, Dr Kazadi Mulombo don react to di tori wey dey circulate say di Health join-bodi 'disqualify Nigeria and eight other kontris from vaccine bid'. One local tori newspaper, Sahara Reporters bin report say di World Health Organisation-led COVAX global initiative don fail to shortlist Nigeria for di Pfizer vaccines afta di kontri no gree meet di standard requirement of storing di vaccines at di required -70 degrees Celsius. Dr Kazadi enter twitter to react to di news say WHO na part of Covax facility and dem no fit disqualify any Member State to access an approved vaccine for dia population. Dr Kasadi mention say di World Health organisation go make sure say dem distribute COVID-19 vaccines across di world equally and even for Nigeria wey be one of di AMC kontris. He also mention say Nigeria dey set to receive its first share of di vaccine dis month. Meanwhile members of di National Primary Health Care Development Agency and di WHO kontri representative dey meet for di kontri capital, Abuja, on Saturday for one emergency meeting. Di Nigerian goment bin tok say dem dey expect to receive 100,000 doses through di COVAX initiative, wey dem set up to ensure rapid and equitable access to COVID-19 vaccines for all countries, e no matter di income level. Nigeria Minister of Health, Osagie Ehanire, tok for one press conference for December 2020 say goment dey reason which type of di vaccines to buy because of how dem go take preserve am due to dia low temperature requirements. "We sign up for advance market participation in COVAX. So if we dey able to get our own, I think e go be for January. But two types of vaccines dey. Di ones dey wey suppose dey ultra deep freezers - di MRA type of vaccines. Dat is di freezer suppose be minus 80 degrees. https://www.bbc.com/pidgin/tori-55964245
Re: Why WHO Remove Nigeria For Pfizer- Biontech Vaccine Sharing Formular by ChelseaArmy(m): 9:46am On Feb 09, 2021
No thanks not for me..dont need any vaccines!!!
There is a huge list of doctors that are
advising against the vaccine research it because the criminal
media is not shedding lights on it. The president of brasil
advised against it, and told his people that no one will be held
accountable for any side effect that appears on whoever takes
this vaccine, why did the media not speak about that?
Re: Why WHO Remove Nigeria For Pfizer- Biontech Vaccine Sharing Formular by Afamed: 10:25am On Feb 09, 2021
BuhariCarryGo:
Di Nigerian goment say di World Health Organisation fail to
shortlist am for di Pfizer vaccine no becos e no get facility to
store di vaccine but sake of di death rate of di virus for oda
African kontris dem.
Di oga kpata-kpata of Primary Health Care Development
Agency, Faisal Shuaib yarn tori pipo dis one for Abuja as e dey
try deny local tori say WHO disqualify di kontri.
Di WHO -led COVAX global initiative bin choose Cape Verde,
South Africa, Rwanda among di first kontri to get di first doses
of di vaccine.
Nigeria bin don announce and ready to receive 100,000 doses
of di vaccine sometime for end of January or early February
but for last minute, di WHO change dia mind plus formular on
top which kontri deserve di vaccine pass.
Oga Shuaib say di reason why di world health body choose dis
oda kontri na sake of di number of new cases, di trend in di
number of cases, di population of di kontri and di availability
of di cold chain equipment.
E further explain give say kontris like South Africa wey get di
Pfizer allocation na sake of say dem get new strain of di Covid
-19 virus and di number of death dey high for di kontri.
And for Cape Verde and Rwanda, di kontri dey small and even
di few doses wey dem go give dem, e go epp dem well well
pass Nigeria.
Di world Health Regional Director, say for Africa, Nigeria bin
dey among di nine kontris for di continent wey suppose get di
Pfizer vaccine, but unfortunately, e no come dey easy to give
all di 51 kontris wit di Pfizer doses as e no go achieve di
desired result.
E say even though Nigeria no get di initial 100, 000 doses of di
Pfizer vaccine, e go get di 16 million AstraZeneca doses
sometime for February.
And dat one go cover more population pass di Pfizer one.
Di AstraZeneca/Oxford vaccine still dey under review but di
WHO representative assure say di result go come out soon.
'WHO no fit disqualify Member State to
get approved vaccine' - WHO
Representative
World Health Organisation representative, Dr Kazadi Mulombo
don react to di tori wey dey circulate say di Health join-bodi
'disqualify Nigeria and eight other kontris from vaccine bid'.
One local tori newspaper, Sahara Reporters bin report say di
World Health Organisation-led COVAX global initiative don fail
to shortlist Nigeria for di Pfizer vaccines afta di kontri no gree
meet di standard requirement of storing di vaccines at di
required -70 degrees Celsius.
Dr Kazadi enter twitter to react to di news say WHO na part of
Covax facility and dem no fit disqualify any Member State to
access an approved vaccine for dia population.
Dr Kasadi mention say di World Health organisation go make
sure say dem distribute COVID-19 vaccines across di world
equally and even for Nigeria wey be one of di AMC kontris.
He also mention say Nigeria dey set to receive its first share
of di vaccine dis month.
Meanwhile members of di National Primary Health Care
Development Agency and di WHO kontri representative dey
meet for di kontri capital, Abuja, on Saturday for one
emergency meeting.
Di Nigerian goment bin tok say dem dey expect to receive
100,000 doses through di COVAX initiative, wey dem set up to
ensure rapid and equitable access to COVID-19 vaccines for
all countries, e no matter di income level.
Nigeria Minister of Health, Osagie Ehanire, tok for one press
conference for December 2020 say goment dey reason which
type of di vaccines to buy because of how dem go take
preserve am due to dia low temperature requirements.
"We sign up for advance market participation in COVAX. So if
we dey able to get our own, I think e go be for January. But
two types of vaccines dey. Di ones dey wey suppose dey ultra
deep freezers - di MRA type of vaccines. Dat is di freezer
suppose be minus 80 degrees.
https://www.bbc.com/pidgin/tori-55964245
Stop your fake news. WHO has come out to deny this
Re: Why WHO Remove Nigeria For Pfizer- Biontech Vaccine Sharing Formular by seunmsg(m): 10:29am On Feb 09, 2021
We will get 1million doses of the Oxford AstraZeneca vaccine before the end of the month. Pfizer can keep their 100k doses for now. When we have the required facilities, we will come back to them.

(1) (Reply)

Minister: FG To Convert 1m Cars From Petrol To Gas Free / . / APC Must Exit With Buhari In 2023 - PDP

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 37
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.