Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,154,195 members, 7,822,037 topics. Date: Thursday, 09 May 2024 at 03:17 AM

Security System For Nigeria Don Collapse - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Security System For Nigeria Don Collapse (278 Views)

Kalu: New Service Chiefs Need 6 Months To Understand Nigeria’s Security System / Peter Obi To FG: Allow Regional Security System To Function / Osinbajo Visits Scene Of Building Collapse In Abuja (Photos) (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Security System For Nigeria Don Collapse by Wesleyes: 2:34am On May 29, 2021
E tok dis one for interview give BBC News Pidgin say na because of nepotism for inside di armed forces, di welfare of di armed forces and lack of professionals for inside di armed forces na im dey cause wahala.
E bin tok say di palalva for di kontri no be today wey im start and di issue na when pipo see say kasala dey work for one side of di kontri dem go try recreate am.
Oga Chidoka add say, "Nigerians for act to helep secure di kontri if dem get trust in di Nigerian state like di South East bin do with di Bakassi boys but trust no dey again"
Di trust extend to di picking of di new Chief of Army Staff, wey oga Chidoka tok say suppose go to somebodi for a different part of di kontri so pipo for armed forces go fit aspire for di position.
E say, "Soldiers fit ask dem selves say if you no fit trust me to be your COAS, why make I go die for you".
E also state say di absence of President Buhari for di burinal of Lieutenant General Attahiru also add for di problem of trust on top say "Buhari suppose show face for di burial to show say im ey united togeda with di army."
Osita Chidoka wey dey work as Political and Developmental analyst tok say as at now, Nigeria be two.
Di Nigeria wey dey deal with quota system and dey behave anyhow and di Naija wey young pipo dey use create wealth with start up companies, music, sports among odas.
One of di ways wey Nigeria go fit work, im add, na if we carry di spirit of Naija enta Nigeria.
On top di Biafra agitation wey don get Oduduwa Nation agitation too, oga Chidoka say dia agitation dey valid but for any of di kontris to work as well as di restructuring wey di political class don dey push for, first of all, e dey important to unlock Nigeria.
E say make State and Local governments around di kontri start to dey tok how dem dey spend di monthly allocation wey di federal goment dey give dem.
E tok say di issue of health and edcation suppose be di mata of state and local goments so di Federal go get time to focus on immigration, defense among others.
Re: Security System For Nigeria Don Collapse by johnmartus(m): 2:51am On May 29, 2021
Who destroyed it? Our galant soldiers still dealing with terrorist organization ask ipob and bokoharam.
Re: Security System For Nigeria Don Collapse by SangoOlukosoOba(m): 3:06am On May 29, 2021
So you are just knowing in 2021 that Nigeria is unsecured?


Where were you 2 decades ago when robbers when robbers were terrorizing Benin-Ore road!

Oh, those farmers/herdsmen clashes then were graduation parties?

Or the days when robbers will raid a whole street, was that the security we had then?


No be today yansh dey for back abeg,

Nigeria has never been secured in last 3 decades. Its a free field for all.
Re: Security System For Nigeria Don Collapse by orisa37: 4:27am On May 29, 2021
SECURITY. COLLAPSED

SAFETY. COLLAPSED

SUCCESS. COLLAPSED.

WHAT ELSE? NIGERIA IS JAGAJAGA.

(1) (Reply)

10 Food Companies Shut Down Since Buhari Administration - TUC President / C'river Set To Flag-off College Of Nursing Science In South-south Nigeria / Twitter Ban: Nigeria Youths React

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 13
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.