Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,195,580 members, 7,958,791 topics. Date: Thursday, 26 September 2024 at 12:57 AM

Latest Ankara Styles For Ladies; BEAUTIFUL Ankara Styles For Casual & Church Mee - Fashion - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Fashion / Latest Ankara Styles For Ladies; BEAUTIFUL Ankara Styles For Casual & Church Mee (416 Views)

Best Coffin Nail Designs 2021 For Ladies: Beautiful Nail Designs. / Ankara Styles 2021 For Slim Ladies: Beautiful Dresses To Rock / Latest Ankara Styles 2020 For Slim Ladies: Beautiful Ankara Styles (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Latest Ankara Styles For Ladies; BEAUTIFUL Ankara Styles For Casual & Church Mee by South2022: 10:53pm On May 07, 2022
Re: Latest Ankara Styles For Ladies; BEAUTIFUL Ankara Styles For Casual & Church Mee by Nobody: 6:27pm On May 26, 2022
Onariii undecided

Fowl rest! As I don land here you wan use style frustrate my life abi? you better dey ur dey else I go just finally leave this place for una, wey cero sef you don finally find out her monika? And why you never dey active for wtsap since your line sef no dey go and you say make I send you card..... I register here cos I been dey find you hope say kasala never burst you better do fast i.d yaself my mama wan travel and my cable wey you carry I take God beg you bring am back else any plane wey you enter must crash....help me bring karma wen you dey come, shebi the airport people dey allow special carriage na, my brother say she no dey gree chop well cos she dey miss me, talk to those airport guys for me abeg you know ur way na but just bring her come here abeg.....do fast come wtsap I get confidential things I wan tell you
Re: Latest Ankara Styles For Ladies; BEAUTIFUL Ankara Styles For Casual & Church Mee by Nobody: 6:45pm On May 26, 2022
[quote author=Kaiair post=113200993]
Idiot!

I no need the need the card again e don go thru, my phone been dey high on something, why you no text me for my other watsap accounts or try my other numbers? sometimes laziness to press fone too dey worry u undecided

I been no know say you dey find me you know sometimes I dey go incognito
Dat your dog your bro don already tell me, no wam I go arrange am for you I go lap with everything latest next month cos I still dey very busy, hope say you dey follow ASUU news? You better no reason that your yeye dropout wey you just dey chant since unless na die dey hungry you i trust your mama to handle that one

Wetin u go like for your b-day Sef? undecided I fit reason am wen I dey come, I neva know cero monika yet

Btw hafa berri mata naa?? I don dey ask and you no wan gree answer undecided oga no do naa
Re: Latest Ankara Styles For Ladies; BEAUTIFUL Ankara Styles For Casual & Church Mee by Nobody: 8:46pm On May 26, 2022
[quote author=Onariii post=113201511][/quote]
Omo guy rest naaa, I don warn u make you comot hand for my relationship matter wetin u go my back go dey contemplate and renogotiate? Anything wey u talk me i no follow, you sabi me well so u suppose know say when I don reason some kind things and decide say I go comot my hand e mean say I don comot my hand totally, make all these girls leave me make man face lyf abeg, I have so many important shits I'm dealing with so room no dey for emotional gra gra, make nobody disturb my peace I no fit kill myself for another matter, make nobody push me abeg for this journey I no dey drink water, make person no carry their wahala come kill my vibe, I get things wey I gats fix, I gotta a lotta things I need I gat no time for heart stuff abeg, e dey always weigh me so I don tire, you know me any feelings wey I get even if e hard to comot I go eventually die am.......make everybody rest abeg make I focus on my issues, see I got love for the people who love me too
I got a beast buh I'm tryna keep it cool

Where the fvvck you dey?? Iswr If you no be my elder I for don scatter your face since, do come wtsap abeg I wan clear from this place
Re: Latest Ankara Styles For Ladies; BEAUTIFUL Ankara Styles For Casual & Church Mee by Nobody: 9:17pm On May 26, 2022
Kaiair:

Omo guy I don hear you, I been dey telegram since I see your message I forget to reply
Oboy kandi don die 3days ago, him brother been tell me say him go put hand for spiritual, around Monday afternoon him been dey complain of chest pain and just collapsed
I been dey warn dat guy him just deviate go dey follow erio and that him useless gang members wey no even know anything about ordinary computer yet dem wan blow sharp sharp, I been dey warn am about erio but fly wey no dey hear word go follow corpse enter grave, naim younger sister wey I just dey feel for
Ps. Abeg no dribble me o I'm just concerned about the small girl that's all
Re: Latest Ankara Styles For Ladies; BEAUTIFUL Ankara Styles For Casual & Church Mee by Nobody: 10:46pm On May 26, 2022
[quote author=Onariii post=113205440]
[/quote
Kandi?? undecided when, why, where and how??
Person wey I wish happy birthday last week
Chai God! And I been subtly take style dey warn am, wetin dey do all these boys sef? When dem wan prove stubborn dem go carry sand block all their ears embarassed
Omo I pray make him rest in peace I know say na devil wey kill am embarassed and him be tell me say him mama recently do kidney surgery or wetin wetin sef, Nnnaa ehn embarassed
Btw guy wey that my smoke? The colo wey full inside 2 packets undecided I know say na u wey carry am, something wey person order for me I use 3 wks dey wait am plus that electric lighter? If you no want make plane jam you just jejely return everything complete as u see am, I no wan talk about the other things wey you carry cos those na easily replaceable stuff but you see my smoke just jejely return everything "complete" I wan hear pim
Re: Latest Ankara Styles For Ladies; BEAUTIFUL Ankara Styles For Casual & Church Mee by Nobody: 10:54pm On May 26, 2022
[quote author=Kaiair post=113207476][/quote]
So you don graduate to Colorado? undecided
I been wan discuss with you about that thing which tym wey that nonsense take start? You know say if anybody find out na die wey u dey undecided I never complain finish about that your normal smoke now you don kuku migrate to Colorado, no go dey try nonsense experiments cos na wetin you dey always call am, you go talk say you just wan test am which kind yeye testing be that undecided you go soon jam wetin go block your brain one day na wetin I dey pray for sef so maybe e go finally reboot, continue to dey test nonsense

(1) (Reply)

2022 African Hair Braiding Hairstyles Pictures For Black Women / How To Look These Beautiful And Curvy, Beautiful Black Girls With Curves. / 2023 Classy DIY Overall Dress Jumpsuit Denim Jeans Outfits|jumpsuit Dress Outfit

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 46
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.