Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,158,350 members, 7,836,432 topics. Date: Wednesday, 22 May 2024 at 07:43 AM

Letter To My Landlord ���� - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Letter To My Landlord ���� (513 Views)

I Was Drunk Yesterday And I Told My Landlord To Increase Rent / Me To My Landlord About Rent During These Times / My Landlord Just Did This Sign Post (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Letter To My Landlord ���� by Coolmillion: 2:20pm On Sep 05, 2022
Dear Able Landlord, it's me John, the tenant you gave double quick notice the other day. I don finally pack. Yes! I pack today. But e get small confessions wey I wan yarn, abeg no vex

1)Ireti Your daughter don get Belle! Yes you read that right, and na me give am belle....no vex! The way e happen sef I no fit explain, e even shock her self....we no plan am like this. You be my fellow man and I hope you understand dey na accidental discharge.....e fit happen to anybody, but I promise sey e no go happen again. I for like be your son-in-law but you're a bad man. Yes!

2)Bingo your dog no lost, na chop we chop am!
I know say dis grin one go shock you pass because we follow you search for am. No be only me chop bingo, we dey three.
Me, your caretaker and one other hausa man. Oga landlord, bingo sweet die!... I use am cook soup, cook rice, cook stew even use am cook beans. Omo! The dog get natural oil for body.... And I know say you go dey plan to lay course on me, the course no go work, because I prayed before I chop am. I know say I bad, but you see that your caretaker? na evil man. Him get liver collect the lion share despite say na me bring up the idea.... Can you imagine?

3)Oga Landlord, I know say when you
return from your journey you go dey find your keke. The thing be say I sell am dis morning. Money been no too dey my hand and I suppose settle one or two agent for this new compound I wan park into, no too reason am.

The iron condemn man bin dey prize am 25k but I say nooo.
How I go sell keke wey still dey in good condition for 25k e no good na.

So Las Las I come add your wheelbarrow make everything be round figure. So the iron condemn man come later pay me 30k for everything. Na the money I take transport myself, and na from there I go take cook soup when I reach.

I drop 2k under your door mat, so when you come you carry am hold body. E no good say I sell your property without dropping something, my conscience no go allow me rest.
�����������

Re: Letter To My Landlord ���� by Durabest: 2:35pm On Sep 05, 2022
Who know waiting go happen to the next landlord oh.

(1) (Reply)

See Wetin Big Yarnsh Do Me / Top Three (3) Comedians In Nigeria / Cant We Make Friends Here?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 8
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.