Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,161,162 members, 7,845,823 topics. Date: Friday, 31 May 2024 at 05:21 AM

The Tory Of Aubameyang For Chelsea - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / The Tory Of Aubameyang For Chelsea (99 Views)

Barca Claim A Huge Win Over Real Sociedad, Courtesy Of Aubameyang's Header / Arsenal Angry, Issue Strong Warning To Aubameyang For Travelling To Barcelona / CAF Fines Aubameyang For Social Media Outburst (2) (3) (4)

(1) (Reply)

The Tory Of Aubameyang For Chelsea by kingot(m): 9:18pm On Aug 21, 2023
The papa of Pierre Emerick Aubameyang, Francois Aubameyang don come outside dey confess say him pikin see correct shege wey pass APC own for just dat one year wey him spend for Chelsea.
According to Papa Aubameyang: if dem ask me to describe dat one year wey my pikin stay for Chelsea, Walai talai I go describe am like hell fire. Because na after arm robbers attack my pikin house for Barcelona break him jaw naim him kuku decide to leave Spain and return to England with Chelsea. We no know say na from frying pan to fire naim my pikin enter because dat Chelsea be like living in bondage. Everything start well sotay dem even nak Auba Number 9 jersey. Not until dem sack Thomas Tuchel na then my pikin begin see pepper. E bad sotay dat carpenter wey Chelsea bring come as coachie, Graham Potter even send my pikin go exile. Imagine a whole Number 9 and you no put am for UCL squad. You no even dey play am for bench. Sotay my pikin, a whole Aubameyang wey don win EPL golden boot begin play monkey post for street with agberos just to maintain fitness.
Even when Lampard come sef nothing change. The tin bad sotay Aubameyang wey be laughing guy no kuku dey laff again. Even for house sef na so him dey always squeeze face like pesin wey dey chop beans mistakenly chop stone inside. My pikin no happy at all and that’s why immediately season end we begin look for club for am and now wey we don finally join Marseille, my pikin don dey smile again. Walai talai I no go ask anybody wey I know to join Chelsea because wetin dat club do my pikin, na only Baba God go judge dem for me.
Papa Aubameyang don talk wetin happen to him pikin for Chelsea. Shay Chelsea no try abi Aubameyang deserve everything wey happen to am there?

(1) (Reply)

How To Become A Footballer: Unleashing Your Potential In Nigeria / Kaduna KSCC Emerge Champions Of 2nd Edition Of Abuja Female Cricket Invitational / EPL Preview: Can Chelsea Inflict More Pain On Crisis-ravaged United?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 8
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.