Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,106 members, 7,818,305 topics. Date: Sunday, 05 May 2024 at 12:17 PM

“security Shakara For Lagos” By Chidi Anthony Opara - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / “security Shakara For Lagos” By Chidi Anthony Opara (702 Views)

Nigerian Pidgin English Poetry Book By Chidi Anthony Opara Released Online / "Chimamanda Adichie's "Yellow Hibiscus" By Chidi Anthony Opara / "mary Magdalene’s Mug" By Chidi Anthony Opara (2) (3) (4)

(1) (Reply)

“security Shakara For Lagos” By Chidi Anthony Opara by PIPROM(m): 9:48am On Oct 18, 2011
Boko Haram dey for North
Dey bomb,
Dey harass.
MEND dey for Niger Delta
Dey maja.
MASSOB  dey for East
Dey maintain.
OPC dey for West
Dey operate.
Militants full everywhere
Dey maintain levels.
Security dey shake shake
Dey find shelter.

Independence day waka dey come,
Abuja come get as e be.

But Presido must collect salute,
Him must deliever speech,
Long long speech,
Madam sef must wear heavy headtie.

But Presido no wan hear
Say dem shoot bird,
Di pickin fly away.

Dat day come come,
Dem comot property
For inside Presido parlour,
Dem call soldier and police,
Dem parade, Presido collect salute,
Madam headtie dey hala,
Presido deliever long long speech.

As independence day pass,
One newspaper for Lagos write something,
Security come dey show working,
Security shakara come full Lagos.

(1) (Reply)

Principles Of A Poor Man / You Should See This Site: Now / I Need A Hug

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 5
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.