Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,987 members, 7,817,907 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 10:34 PM

“Occupy Na Grammar” By Chidi Anthony Opara - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / “Occupy Na Grammar” By Chidi Anthony Opara (666 Views)

Nigerian Pidgin English Poetry Book By Chidi Anthony Opara Released Online / "Chimamanda Adichie's "Yellow Hibiscus" By Chidi Anthony Opara / "mary Magdalene’s Mug" By Chidi Anthony Opara (2) (3) (4)

(1) (Reply)

“Occupy Na Grammar” By Chidi Anthony Opara by PIPROM(m): 10:01am On Nov 03, 2011
For Naija
We no dey occupy,
Na for yonder
Dem dey occupy.
For Naija
Occupy na grammar.

Na prayer house
We dey occupy.
Every day every day
Na pray we dey pray.
If we pray finish,
We siddon
Dey wait for miracle.

As we dey suffer,
We dey endure.
As we dey endure,
We dey pray,
We dey fast.

For Naija
Na “all correct sir!”
“All correct ma!”
Na im we dey,
Na dobale we dey.

We no dey oppose,
We dey join dem.
Na for yonder
Dem dey oppose,
Dem dey occupy.
For Naija
Occupy na grammar.

More dey here: http://naforpoems..com/2011/11/occupy-na-grammar.html

(1) (Reply)

How Good Are You In The Computing World / .......where Shit Sells Like Crazy! / Dubious Bank

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 5
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.