Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,192 members, 7,818,630 topics. Date: Sunday, 05 May 2024 at 08:13 PM

Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) (32629 Views)

Funny Nigerian Pidgin Proverbs And Their Loose Translations ... / Nigerian Pidgin Proverbs That Will Surely Make You Laugh: Add Yours Too / Popular Pidgin Quotes (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by stanech: 8:31pm On Nov 20, 2011
Eg,,,

Picken wey say him mama no go sleep him self no go sleep

Fly wey no dey hear advice the follow dead body enter grave.

Cow wey no get tail na God dey help am drive fly

No matter how u go under water go mess the gbudu-gbudu must come out.

Bullet wey meet face cap no be warning

If hand shake don pass elbow na fight.

Fowl no dey bubble for night.

Na lizard wey no get sense dey boast for crocodile,

When breeze blow fowl nyash go open,


Abeg Make the list continue,
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by Dyt(f): 8:35pm On Nov 20, 2011
If STENACH no comot 4 hia fast na stone we go throw
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by stanech: 8:37pm On Nov 20, 2011
Let him without sin cast the first stone, Like I said its not funny, I just need the list. No be joke
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by Dyt(f): 8:48pm On Nov 20, 2011
Wonderin wat its doin on dis section den
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by stanech: 8:49pm On Nov 20, 2011
Pls if u can, move it to the right section , smiley
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by Dyt(f): 8:53pm On Nov 20, 2011
Wat were u thinkin b4 u posted it here at first
hisses
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by stanech: 8:56pm On Nov 20, 2011
I was thinking that you could be so kind and add to the list, move it to the right section for me or better still direct me to the right section. smiley
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by Dyt(f): 9:00pm On Nov 20, 2011
Try postin on politics, religion, romance n education
mu he he he he he
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by Ajibel(m): 9:01pm On Nov 20, 2011
*enters the joke critic*

where is the joke?

*waiting for a reply*
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by stanech: 9:03pm On Nov 20, 2011
I will rather stay  then . because those options are not better sorry smiley
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by stanech: 9:05pm On Nov 20, 2011
@Ajibel It wasn't meant to be funny Read the topic again,
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by Anonymous2(m): 11:18pm On Nov 20, 2011
To Wowo nor be old age grin

Who chop belleful go still hungry
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by stanech: 11:21pm On Nov 20, 2011
Thank u @Anonymous2


To wowo no be crime, grin

Soup wey sweet na money cook am,

I tire no be say I lazy,
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by Anonymous2(m): 11:37pm On Nov 20, 2011
pesin wen go tiff 4 cement store na im know d load wen e wan carry.

pikin wen use agbada take stat guy go talk wetin e go wear wen e old.
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by Anonymous2(m): 11:41pm On Nov 20, 2011
pikin when no know him mama boyfriend na him dey call am uncle.

na strong thing when plantain c na im make them call am boli.

na tey e go tey stammerer go call him mama name.

even jaguda get oga!
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by Anonymous2(m): 11:43pm On Nov 20, 2011
before you marry woman make u look e mama well because mango nor dey fall far from tree.

Escort me, Escort me, naim slave trade take start.

Na where tree near tree naim monkey dey smart  grin
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by Anonymous2(m): 11:46pm On Nov 20, 2011
A stitch in time, …, dey prevent further tear tear.

A rolling stone ……… na person push am

Birds of the same feather……… na the same mama born dem
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by Anonymous2(m): 11:50pm On Nov 20, 2011
Pynt wey slack na im dem dey call boxers

When monkey wear canvass enter town make we know say im get plans

Na determination dey make okada rider overtake trailer

1 Like

Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by Anonymous2(m): 12:02am On Nov 21, 2011
if u wake up 4 morning fowl pursue u i beg run o! u no know wetin e carry 4 mind
.
na lazy person dey run go house go pull shirt if dem find him trouble 4 field

threaten na water, action na blood!
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by stanech: 12:06am On Nov 21, 2011
Nice ones grin grin

Kai kai and water get the same colour but them no get the same taste.

Follow who know road make u no go fall inside hole,


Eye wey dey cry dey see road


Okro no dey tall pass him owner
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by dennyboy30: 1:10am On Nov 23, 2011
No matter the weight of elephant, e no fit cause earthquake
Small pikin fit play with the mother breast but e no fit play with the father balls
The hair stylist wey dem barb vulture not fit am, guinea fowl say na dat kind style e like
Pig say e no fit make friend with goat bcus say goat no dey baff
Person wey dey shake coconut tree na him own head e dey shake
Pig say swagger get level na im make am pack im own balls go back

1 Like

Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by BCuZiMBlaCk(m): 6:31am On Nov 23, 2011
Na person wey get something dey know wer e for dey wound am
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by ARareGem(f): 10:43am On Nov 23, 2011
Anonymous2:


Escort me, Escort me, naim slave trade take start.


Lol
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by stanech: 12:22pm On Dec 02, 2011
Escort me, Escort me, naim slave trade take start.


lol
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by SageNaruto(m): 11:51pm On Dec 02, 2011
I don laff so tey my belle don full dis nyt. . .
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by SageNaruto(m): 11:58pm On Dec 02, 2011
Make me sef drop my own 2 kobo. . .

If u do anyhow, ur landlord go see anyhow. . .

They no dey tell blind man say war don start. . .

Wetin make babalawo do advert make u know say him don hammer. . .

1 Like

Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by babylolaroy(f): 12:33pm On Jul 21, 2013
Anonymous2: pesin wen go tiff 4 cement store na im know d load wen e wan carry.

pikin wen use agbada take stat guy go talk wetin e go wear wen e old.
hahahahaha lol....im go wear jeans na
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by wisdomw(m): 9:19pm On Jul 21, 2013
Gals wey dey see dia periods no dey visit my kind.
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by babylolaroy(f): 2:31pm On Jul 22, 2013
wisdom-w:
Gals wey dey see dia periods no dey visit my kind.
we don know ur kind be dat
Re: Collection Of Nigerian Pidgin Quotes (not Funny) by afridigit(m): 11:56pm On Feb 24, 2020
Na over confidence make February no complete. - https://quotes.ng/cats/pidgin/4/

(1) (Reply)

Hilarious Pictures From Africagag To Spice Your Day. / Pic Of The Best Graduating Student Of OAU When Reading For Final Year Exam. / Free Airtime For Mtn(complicated Process)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 29
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.