Borojasper's Posts
Nairaland Forum › Borojasper's Profile › Borojasper's Posts
1 (of 1 pages)
hey vacancies, how do you is for real, what proof you got? |
I think the question should be 'Will A Wife Turn In her husband Who Is A 419ner' or Will parents Turn In their Child Who Is A 419ner, ? vica versa . Abeg make una answer me ohhhhh Iyabo suppose don turn OBJ in and so many of em, all our politicians are fraudster everyone knows this fact, come to think of it, Who no like money , Omo my people Money good ohhhhhhhh, pray say make u no be pauper , make una leave yahoo bois make dem chop dey go, na the magas una suppose warn, why person go wan own a whole international airport of a federal republic . e easy, omo dem go chop em dollar go flex for igboro, Na maga know wetin em dey find and em go surely see am. |
U see na we dey kill ourself, wetin concern black man with English, English no be my mother tongue ohhhh , I be original nwa afor , e na ahota , Oyinbo self wey get the English no even sabi speak am , all they want is understanding and not how u place de useless grammars and vocab, na wetin dem use carry our us go be that and we still dey fall for am, English is just a lingua franca and not our mother-tongue, if u reach middle east Dem no send English and dem no even wan learn am , only few ppl dey speak English there, |
Omo many girls go still get belly for tu baba , e no easy to be MTV which it his ur broda , omo no dey judge person ohhhh, na only God fit judge, 2 baba fire on Enta the place no look uche face, me self dey enta the place and dem dey carry belly, to make money no easy, |
How many of una wey dey abroad get the country passport ? Na God go punish the lebanese, em no know road back to his / her country, 9ja immigration keep it up. Show dem what they show us abroad here. E easy to get another country passport , ?? |
Why no one ever advised you to be proud of 9ja and study there, Omo no be by abroad oHHHHHHHH we have loads of intelectuals in Nigeria more than we have abroad. all this big man pikin dem just dey chop their papa money dem no dey go any school alll of em na olodo ra bata lol No mind me jo, I advice u is be thankful for what you do gat and stop looking at what you dont have. live your life |
1 (of 1 pages)