BucketHat's Posts
Nairaland Forum › BucketHat's Profile › BucketHat's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 12 13 14 15 16 17 18 19 20 (of 26 pages)
Make I laugh like Rema fess,HEHEHE! Land weh dem born us come meet,nah im some human beings deh kill dem selves on top🤔 The land still remain where e deh! Triple wahala for dead body!
|
Nah man your elder sister be oh!
|
I be think seh the fasting/prayers & even spend huge money go Israel & Saudi Arabia (holy land) for prayers too,suppose bring down the price of petrol to 165 naira per litre🤔 May we need to do anoda fasting & prayers again! |
adecz:Mr Buhari should come and give us account his stewardship while in office. |
This matter nor be child's play again oh! Wetin happen to all our security agencies & where all the billion of dollars weh government deh tell us seh dem don spend for security 🤔
|
😢😢😢😢😢😢😢 Nah the 3 children deh worry me oh 😭😭😭😭😭😭😭 This is so appalling! Marriage nor be force oh! If e nor work,make una go una separate ways oh! To avoid stories that touch. |
phemmie06:Senior man,you deserve one keg of upandan palm wine for saying the truth. |
Stealing×3 Stealing in the name of the Lord! Wetin be the economic benefit of Nigeria government sponsoring people for religious tourism for goodness sake? Saudi Arabia government get reserve close to a trillion dollars from oil/tourism & dem deh do well for their citizens even isreal deh do well for their citizens too & dem deh for war front oh. But Nigeria government prefer to deh filter away out collective funds for irrelevant things 😡 |
GlobalWay:Senior man,but guy talk im mind nah! Nah wetin provoke am the most be that this year,you know. Different strokes for different folks. |
Wetin deh provoke me most enh,nah the idiotic/tribesmen attitude of many Nigerians😡 Those your options above enh,nor really matter to me at all. |
lathrowinger:Bros oh,deh use ya head nah,Nigeria first & leave tribe out of this. Nigeria passport is one & color green,immigration nor go ask you your tribe for departure. |
surgical:Like this enh,I don tire for naija matter oh because the majority prefer their oppressors😡 |
surgical:Anoda thing weh deh hurt so badly for Nigeria enh,nah seh the idiots & tribesmen are the majority 😢😢😢😢 It's mind boggling ohhhhh |
Why everyday nah so so stories left,right & centre enh! 1.No steady electricity 2.No pipe borne water 3.No low cost housing 4.No good road network 5.No standard hospitals 6.No rail network system across board 7.No standard school's 8.No mechanised farming 9.No security I nor believe seh at time & age Nigeria still far behind😢
|
nairalanda1:WE MUST DEMAND THAT NNPC ACCOUNT'S SHOULD AUDITED FROM TOP TO BOTTOM,BECAUSE WE CAN'T JUST ALLOW SOME FEW INDIVIDUALS TO CART AWAY BILLION OF DOLLARS FOR THEMSELVES AND THEIR FAMILIES. THESE WICKED INDIVIDUALS LEAVES AMONG US,THEY GO ABOUT WITH ESCORTS,OWN LUXURY MANSIONS HOME & ABROAD. JUST IMAGINE SAUDI ARABIA WITH HUGEEEEEE BILLION OF DOLLARS IN THEIR RESERVE YET NIGERIA GOVERNMENT ARE SUBSIDISING BILLION OF NAIRA FOR PILGRIMAGES. IF NIGERIA GOVERNMENT HAD INVESTED ALL THE PROCEEDS FROM THE CRUDE WELL EVEN DIVERSIFY THE ECONOMY DECADES AGO,I DON'T WE WOULD BE THIS BEHIND AT ALL. we suppose make this men pay dearly for all the atrocities committed against the people of 🇳🇬 |
nairalanda1:Boss man,NNPC.. Nigeria national petroleum corporation nah naija get am 💯% & of which dem answerable to we the citizenry even tho Nigeria we nor get full access to crude 💯% because nah the IOC'S get the assets to drill the crude. My pain be seh enh,since we discover this crude over 50 years ago for Nigeria 🇳🇬 some set of people deh thief am with huge tanker & big ships soteh dem get oil & gas companies even refineries outside Nigeria allegedly. We the people of Nigeria nor fit enjoy this black gold weh God give us including other resources. No consequences for bad behaviour in our country,corruption don become norm. |
nairalanda1:Who get NNPC? |
nairalanda1:Our own percentage of CRUDE weh all this IOC'S deh give us after digging from the ground enh,where e deh? Wetin make all our refineries nor deh operational for donkey years now? |
pafestula:Nah until wen I see pms @ 100 naira per litre b4 I take this administration serious oh. Anything aside dat to me nah scam. |
The biggest problem be seh enh,the idiots & tribemen nah dem be the majority oh. |
Zocalite:Person nor fit eat balanced diet again oh! Yet some idiots still deh swim for inside bigotry,religion etc. At last all of us go deh alright. |
pesty100:My brother,make I gist you enh,Nigeria nor get any assets offshore weh fit commot crude from ground. The assets belongs to the IOC'S aka international oil companies,eg SHELL,EXXON MOBIL,TOTAL etc. We only get Sharing FORMULA with this IOC'S people,dem give us our percentage & take their own too. Nah SHELL be the landlord of this IOC'S for Nigeria 🇳🇬 I stand to be corrected oh,SHELL don reach close to 50 years operating for our country. I sure seh Nigeria government & their friends & girl friends don use our percentage of CRUDE borrow money ahead & not to talk of the ones weh dem don steal & still deh steal oh. The billionaires for Nigeria deh into oil & gas business yet our own refineries nor operational. Common man for street nor fit buy ship to go steal CRUDE OIL nah. Your guess is as good as mine 🤔 |
nairalanda1:So as a citizen of Nigeria enh,we nor get any benefits 🤔 I beg I wan ask you one question enh,this our CRUDE,nah blessing or nah curse? |
On a very serious note enh,all the bandits & terrorist weh our combatant military bios don intercept & catch,I wan know weda the military nor deh interrogate dem to know their sponsors. Because me I believe seh once dem know who deh bankroll all this monsters,then the problem is halfway solved or even permanently halted. Where the intelligence deh🤔 this internal battle is almost 2 decades now oh.
|
Majority of Nigerians and prayers nah 5 & 6 but like injustice,always deh sweep the truth under carpet,deh filter away money for pilgrimages to their so called holy lands & worship their oppressors🤔 |
Human beings lives nor matter anymore for Nigeria oh! Wen we reach this level of inhumane attitude towards one anoda🤔 Jungle justice left right & centre nor be solution oh,but government people dem don Bleep up too much😢 The Government, elder state men,religious leaders,elite's have failed woefully.
|
HisXLNC1:I just wan check weda bullet deh inside! |
Which one be office of the first lady again oh🤔 I believe seh everybody for this platform sabi who their be mama? Anybody weh nor sabi im mama,make that person talk now oh. |
First off enh,which day person wan enjoy for Nigeria 🤔 no steady electricity,no pipe borne water,no good road network etc. why suffering in the midst of plenty 🤔
|
Wen trouble sleep,yanga go wake am, Wetin im deh find? Palaver e don get so oh!
|
First off enh,Mr Nwebonyi commot for track completely & secondly enh,I don tire for the incompetent of Nigeria law makers. Dem nor deserve respect anymore because their anyhow too much. E be like seh Mrs Oby notice seh something deh wrong for dat panel & she quickly react but the so called senator nor do well at all. Why 109 men & only 4 women deh for our national assembly 🤔 your guess is as good as mine! A public officer for that matter oh! |
The nurses sabi their biological mama nah so why the MC wan force Mr President wife down their throat nain me I nor understand oh. Your guess is as good as mine!
|
1 2 3 4 5 6 7 8 ... 12 13 14 15 16 17 18 19 20 (of 26 pages)