Ireport85's Posts
Nairaland Forum › Ireport85's Profile › Ireport85's Posts
"Car scores Adaugo and my sister 3,Me "3" ![]() I no gree fall for their strategy". Adaugo fulfill that promise wet she say if I repent she go come cook for me .After my fake repentance for motor she come follow my sister come house come follow her for kitchen cook rice and stew for me . "You be sharp guy o" so na only fake acting na him she use fall like this? Stanley said "they there na Alex responded" Oboy wey the food na Stanley asked as he started walking towards the kitchen .He was lucky something was still left in the pot as Alex had already eaten the bread and groundnut they shared in the jail before his sister came ,so he didn't eat much. |
Still typing |
she show like T.v na! I see her as I Sidon wet my sister wey come bail me out inside motor. As her driver dey drive,she just dey preach to me na him I see my "beautiful princess" adaugo as I raise my head up to see outside bcuz I bin no dey pay attention to wetin my sis dey talk until I tell her say see my friend(Adaugo )wey just enta the gate . I wind down come ask her hw far ? and who she dey look for ? She say she come see how Dem go fit release me because her elder brother na commander for NDLEA . As she carry bible for hand my sister mind no blink twice to tell her make she join us inside motor, before i go say boom she don sidon for the back seat of the car with me .Oboy I no go lie,I dey happy as she no reject the offer. "Jesus loves you" who start this anthem ?Stanley asked.na adaugo na,Alex replied. Na him her back up artist abi I go say lead artist or their two begin dey tackle me almost simultaneously like John Terry but as lookman i attack Dem with fake actions for motor say I don change. |
One Sunday evening, Alex has just got back from NDLEA jail and he was thinking what he could do with his life."Oboy how I go fit take beta my life dis one wey baba don fail me like tipper wey tumble with chippings" he spoke to himself. "baba been talk say no mata wetin I do Drug law no fit gbab me but now see me now I don smoke mj forget say I get exams "4 exams"for campus to write and my men say as I no call them ,Dem think say I get machinery wey dey tidy my exams for me underground; make I no come go get two papers for one exam" his mind's eye was painting the pictures of the words he spoke to himself as he sat in his one bedroom off campus apartment. "Alex motherforka" Stanley yelled from outside who be dat ? before he could say Jack Robinson Stanley was already seated in one of the beautiful ,jaw dropping and expensive furnitures in the parlour . Oboy how far na? dat your Barney Adaugo,she been dey find you as I tell her say you dey sanko for NDLEA she tell me say she go lap their come see you .she show there? |
Please pardon my grammatical errors and spellings or any other errors as you enjoy your reading. I am still working on them. The piece you are about to read is an half fiction ,half true story . You will get the full story on this thread on nairaland. Just stay tuned! |
