Isokoson's Posts
Nairaland Forum › Isokoson's Profile › Isokoson's Posts
1 (of 1 pages)
Oga finish your story Nah, Why you come Dey short am |
Very useless agent and landlord, omo if I dey rent house and anything spoil, you tell me to pay that you will repair it ..I will run immediately..those shitty landlords are mumurandom in nature, very wicked set of people |
Come back come finish your story |
Dammm base on local logistics Bro , nah rent be the way out ..I did mine nah rent we rent , nah one day shit and wasting money on irrelevant shit is a no no for me .if she no fit understand you now , omo you sure say she go understand you later or after marriage, wetin I see for her side be say , she go dey materialistic in nature.....omo bro I go advice you to stand your ground, no allow woman control you Abeg |
Omo I have a friend, but when she marry, I cut her off, block her everywhere, and I have to create yeye quarrel make we just stay apart, omo the girl Dey always dey into me...so is just how I take discharge her ASAP |
This mata no be here, no body dey witch your wife bro, right from time she no just like the girl at all..so definitely she go cook up some bull shit stories about the Tayo, I know how women dey manipulate thing's, who knows she never go plan with the pastor to say rubbish, the kind of pastor's we have now, nah demonic pastors, one nearly deceive me but I use street take follow the mata up ..the truth is that right from time your wife is not comfortable with tayo and she sees Tayo as competitor...that is why she dey fine any means to get her out...and make two of una hate each other.... Bro tayo is not the cause , your wife is trying to manipulate you... |
Aunty, if you leave James, you go become the biggest betrayer of all time, James Don dey give you better life dey come with the little he earns, you wan marry rich American man because your parents want you to marry him, sorry to say your parents are ungrateful, someone you even barely know, if him be woman beater, what if una ideology no match...but James you know him character. Parent should stop interfering in Dia children love life, my parent tried that rubbish with me, I stood my ground and told them to disown me if they want, I went ahead and marry my wife and since then my peace of mind is priceless . You know even need this matter to disturb you self. But I know say to leave the James and follow rich man Don dey hungry you.. But on a serious note, if you leave James that means you will become the most ungrateful human being on earth. Because that young man no do you anything and you said it your self. He stood for you when your parent no fit stand. Omo be wise oh. No allow your parent choose partner for you abeg.... Every small thing dey go dey use disown they trait their children... That shit nah old fashion, my disown me come later beg me.. And as they disown me, I no die. I live my life |
Omo nah to be friend with him but tell him you ain't doing that shit, if he insists, Omo fashi the guy... |
dammn mehn Omo nah rehab go good for your guy ooo E happen to my guy , him own dey take colos and e nearly die..nah so we jack this amani go rehab....and is doing well now. |
bros nothing dey sup, nah your mind dey Dia, so no reason am, just calm down |
Omo I dey enter 35 next year... |
I no even the gbado men way dey marry more than one wife, Las Las e dey bring hatred, I know of a family, the second wife daughter is my dear friend, nah only the girl graduate for that family, she dey do well, before we go say Jack Robinson, she come dey misbehave, dey drink, and come dey get mental issues, Las Las her dad first wife later admit that nah she kill the girl.. Because she die... She kill her out of jealousy.... |
I dey kubwa and you go enjoy kubwa wella Call me 07039345234 make I run the agent stuff for you.. You go enjoy Arab road just that house expensive Dia You can get self contain for 700k to 500k for kubwa You can also get 400k but e go hard |
He's not an habalist, I know the man, e happen for my Area, the man is a vigilante man, I dey buy something for him wife hand.. Nah Hausa man, I was Dia when this shit happen... Malam umar |
Yes I have a supplier...can connect you with someone here in Abuja Halla at me on 07039345234 |
Mehn, this is beyond local man logistics Bros op, your roommate no be real guy, a real guy go keep calm and see whether she go sweep am or not, when I squat with someone then, my roommate girlfriend go come, we go just gist talk small, then I go dey look whether she go do am or not, if she no do am, I go lock up... Asking your girlfriend to sweep looks more like a disrespect to me, dat kind person no dey happy say u get loyal girl, Omo I go advice you to get your own apartment as you talk.... Nothing good like having your privacy.. Even if is just single room.... Seriously your guy no try My guy then know me nah, even if him girl no do am I go do am, nah so shame go dey catch the girl, before you know, nah she dey do am without bein told. |
Mehn, this is beyond local man ability Bros, you do well, that family is a foolish family, how you even take allow her to manipulate you to marry her still baffles me, how you go buy casket and goat and other stuff for wetin no concern you... I like the way you change am for her mama, you put them wear them belong, that her son is a useless goat, nah em Papa put the money for your account? You suppose slap all of them I swear...nah family way no fit progress be that... I hail you... Your action sweet me.. And believe me no regret am, say you shout for them... You do well... E show say d family no go fit bully you.. |
Mehn this is beyond local man logistics One yeye girl don do me. Like that.. I waka live the idiot ...she reach house self she no see me.. I Waka go my Aunt place go rest |
oghene means God |
This one nah to wear iron pant Shuuuuuu Isoko son |
1 (of 1 pages)
oghene means God