Christianity Etc › Re: Lady Cries Out As She Narrates How She Was Embarrassed At Deeper Life Church by Jeshurun101: 9:19pm On Sep 18, 2025 |
|
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Bayern Munich Vs Chelsea: UCL (3 - 1) On 17th September 2025 by Jeshurun101: 4:56pm On Sep 18, 2025 |
Scarrr: after una don spend like 3billion and buy like over 700 players😹😹.. una still get defensive issue 😹😹 Give me Arsenal defence if I no go beat Bayern. Banter aside, out of all the top 6 in premiership now, Chelsea's defence worst pass. |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Bayern Munich Vs Chelsea: UCL (3 - 1) On 17th September 2025 by Jeshurun101: 2:53pm On Sep 18, 2025 |
Scarrr: Jeshurun101 Teeroyzimma Bahamas95 geoworldedu
😹😹😹 World champion indeed....another proof you played a fatigued Psg after he don beat Madrid and Bayern wey dey currently beat una like goat.. Y you mention me now  Normally, e go dey on us as we win world club cup. Every team go wan flex their muscles. Another thing be say, Chelsea get defensive issue for now. I no know why the board no invest in defence. |
|
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Atletic Club Vs Arsenal: UCL (0 - 2) On 16th September 2025 by Jeshurun101: 8:52pm On Sep 16, 2025 |
|
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Atletic Club Vs Arsenal: UCL (0 - 2) On 16th September 2025 by Jeshurun101: 8:50pm On Sep 16, 2025 |
Teeroyzimma: See them finding excuses for being trophyless, wonders shall never end😂 How your expect make Arsenal win trophy when their fans are satisfied with mediocrity. Na so u go see dem dey talk anyhow online and offline. Dey plenty for viewing centre wey I dey watch ball. They come massively to brawl Chelsea and at the end na shame dey go leave the centre |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Atletic Club Vs Arsenal: UCL (0 - 2) On 16th September 2025 by Jeshurun101: 8:47pm On Sep 16, 2025 |
Scarrr: even Liverpool almost drew Burnley over the weekend.....but the difference is ,one was in control even as they were not at their best....but the other one struggled, at Crystal palace, they struggled too even did ojoro for palace...even at Fulham, they struggled until they did another ojoro.😂 How dey do ojoro? So u mean say the goal wey VAR remove for Palace na ojoro?  U sey make person dey watch cartoon the other time. Na you suppose to dey watch teletubbies. Watching football no be your thing at all.  |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Atletic Club Vs Arsenal: UCL (0 - 2) On 16th September 2025 by Jeshurun101: 8:44pm On Sep 16, 2025 |
Scarrr: be like u don't get the point...which team will play Bayern, Madrid back to back and won't be fatigued... meanwhile u were busy playing Flamengo, kukuruku 😹😹 Like sey no break between those days when they play. Like sey as they Bayern today, they play Madrid tomorrow, the next after tomorrow they play Chelsea. Baba, u need to wake up from your delusion because e no count. Your opinion in football world na like drop of water in mighty ocean. Your opinion no fit remove World Club Cup from Chelsea's cabinet and World Champion tag from the team. They don give them they don give them be dat. It is of no use to cry over split milk. I know sey na Arsenal fan u be. Majority of Arsenal fans na so dem dey talk. Big trophies wey other teams win, they rubbish am and give one yeye reaason. But they fit celebrate we try! we try! we go win am! we go win am this season! every season. |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Atletic Club Vs Arsenal: UCL (0 - 2) On 16th September 2025 by Jeshurun101: 8:36pm On Sep 16, 2025 |
Scarrr: lol...your point exactly? Brentford is on the same level with Liverpool, Arsenal,City ...so it's normal for Chelsea to struggle to beat them? Na all the smaller teams Arsenal beat last season? Answer my question? Na all smaller teams Mancity beat? Na all small teams liverpool beat? During Barca prime with MSN (Messi, Suarez, ann Neymar), I remember one match like, Bet9ja cash out well well for that match. Barcelona vs Malaga that ended in goalless draw and Barcelona beat Madrid wella that season. Shey dat one make Malaga bigger than Madrid? See football don pass that level. The same Brentford wey I draw with, Liverpool fit beat am mercilessly, and make Chelsea kon beat liverpool. That is football for you. |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Atletic Club Vs Arsenal: UCL (0 - 2) On 16th September 2025 by Jeshurun101: 8:29pm On Sep 16, 2025 |
Scarrr: 😹😹 mtchew ! we all know na fatigued Psg....even the win shock u too , but seeing u against Brentford, the ojoro at Crystal Palace and Fulham further proved PSG was indeed fatigued PSG was fatigued when they thrashed Real Madrid like small pikin. PSG was fatigued when they beat Bayern. Abi? This wan wey u dey rant no do at all. Go Chelsea store room and go snatch the World Club Cup as sey na Fatigued PSG dey play. If u wan banter, banter like person wey sabi ball. |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Atletic Club Vs Arsenal: UCL (0 - 2) On 16th September 2025 by Jeshurun101: 8:23pm On Sep 16, 2025 |
Scarrr: naso....world champion wey struggled against ordinary Brentford People wey dey talk like you dey talk, to me, they no suppose dey watch ball. One person talk exactly the same thing wey you talk for Fanstribe youtube channel. The guy own even no make any sense. He sey Bayern thrash their opponent while Chelsea draw with ordinary Brentford. Imagine!, teams wey dey play for two different leagues he kon dey compare them. Una go dey talk as if na today una start to dey watch ball. In football, u fit beat me, make team wey I beat flog you like sey tomorrow no dey. That's football for you. |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Brentford Vs Chelsea - (2 - 2) On 13th September 2025 by Jeshurun101: 10:58am On Sep 14, 2025 |
Exceed15: We didn't loose Losing two points is not good either |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Brentford Vs Chelsea - (2 - 2) On 13th September 2025 by Jeshurun101: 10:27pm On Sep 13, 2025 |
Wordson: Be deceiving urself. E no far, na Wednesday. What team do you support? |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Brentford Vs Chelsea - (2 - 2) On 13th September 2025 by Jeshurun101: 10:27pm On Sep 13, 2025 |
Wordson: Be deceiving urself. E no far, na Wednesday. No qualms |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Brentford Vs Chelsea - (2 - 2) On 13th September 2025 by Jeshurun101: 10:14pm On Sep 13, 2025 |
Money001: All thanks to Garnacho leaving his man at the back post. So you are blaming him for the goal? |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Brentford Vs Chelsea - (2 - 2) On 13th September 2025 by Jeshurun101: 10:11pm On Sep 13, 2025 |
Seunfretty: How many more points will Maresca give the oppositions freely this season...and what was that rubbish starting that Argentine ....caicedo also want for international break if that is his excuse for not playing Estavao... Maresca can never win a league....he is not that kind of coach...and yes I am writing him of...A champions league...he can win ...but a league hell No... A coach that likes to play players out of position and gamble with his line up can never win the EPL... Dont mind the guy! |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Brentford Vs Chelsea - (2 - 2) On 13th September 2025 by Jeshurun101: 10:10pm On Sep 13, 2025 |
Wordson: so u think Chelsea has a chance against the Bundesligua Champions  Oga, u better no think am Una haters no dey learn lesson. Hatred always dey becloud una thinking. Reason why lot of you lose a lot of money during the world club cup final betting against Chelsea. The two teams play different leagues. One is tougher than the other. You cannot that as a yardstick. Chelsea perform better when they are underdog against big team. |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Brentford Vs Chelsea - (2 - 2) On 13th September 2025 by Jeshurun101: 10:04pm On Sep 13, 2025 |
Money001: Garnachew costing his new club 2 points today 😂😂😂 How? |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Brentford Vs Chelsea - (2 - 2) On 13th September 2025 by Jeshurun101: 9:59pm On Sep 13, 2025 |
Wordson: World cup winners couldn't win this. A draw 2 - 2. How dem go cope with Bayern( that just dismembered a team 5-0 today) away from home for mid week? You do not analyse football like that. They are both playing different league, bruh. |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Brentford Vs Chelsea - (2 - 2) On 13th September 2025 by Jeshurun101: 9:58pm On Sep 13, 2025 |
|
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Brentford Vs Chelsea - (2 - 2) On 13th September 2025 by Jeshurun101: 9:56pm On Sep 13, 2025 |
Final Whistle
2 - 2
Brentford have always been thorns in the flesh of Chelsea.
Maresca cost us this point. Brentford is not a team to underrate! |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Brentford Vs Chelsea - (2 - 2) On 13th September 2025 by Jeshurun101: 9:52pm On Sep 13, 2025 |
Exceed15: Chelsea has won this one already I never even type finish before they equalise  |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Brentford Vs Chelsea - (2 - 2) On 13th September 2025 by Jeshurun101: 9:51pm On Sep 13, 2025 |
2-2 |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Brentford Vs Chelsea - (2 - 2) On 13th September 2025 by Jeshurun101: 9:50pm On Sep 13, 2025 |
Exceed15: Chelsea has won this one already I love your optimism, but this is Brentford we are talking about. |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Brentford Vs Chelsea - (2 - 2) On 13th September 2025 by Jeshurun101: 9:47pm On Sep 13, 2025 |
callmeDDD: Shame on the haters from this thread. Wait till dey blow final whistle oo before u make mouth. The score never dey convincing |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Brentford Vs Chelsea - (2 - 2) On 13th September 2025 by Jeshurun101: 9:45pm On Sep 13, 2025 |
femi4: Unto the next one
No dey gamble with first 11 again Maresca Of all teams na Brentford u dey underrate. He knw wetin Brentford show us last four seasons |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Brentford Vs Chelsea - (2 - 2) On 13th September 2025 by Jeshurun101: 9:42pm On Sep 13, 2025 |
Gooooooooooaaaaaaaaaaalllllllll
Caicedoooooooo |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Brentford Vs Chelsea - (2 - 2) On 13th September 2025 by Jeshurun101: 9:39pm On Sep 13, 2025 |
Make that Gittens still rest. FA and Carling cup dey there for him. This is not Bundesliga! |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Brentford Vs Chelsea - (2 - 2) On 13th September 2025 by Jeshurun101: 9:37pm On Sep 13, 2025 |
Good. GARNACHO IN |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Brentford Vs Chelsea - (2 - 2) On 13th September 2025 by Jeshurun101: 9:32pm On Sep 13, 2025 |
MATBILL10: Enzo Maresca is taking tactical risks with his team selections while playing dangerously with three points. I just dey wonder oo. Shey he check our head to head in for the last four season. He really underrate Brentford to arrange such formation. |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Brentford Vs Chelsea - (2 - 2) On 13th September 2025 by Jeshurun101: 9:27pm On Sep 13, 2025 |
I talk am during the transfer window sey this man need to sign a Central Back and Keeper if truly he wan compete for new season.
Make he put Garnacho I wan see something. We need to win this match. |
European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Re: Brentford Vs Chelsea - (2 - 2) On 13th September 2025 by Jeshurun101: 9:22pm On Sep 13, 2025 |
This man and gamble.
He think na Conference league he dey play wey he go dey use team B. |