₦airaland Forum

Welcome, Guest: Register • Login • With Google • Trending • Recent • New

Stats: 3,345,480 members, 8,517,756 topics. Date: Friday, 13 November 2026 at 12:37 AM

Toggle theme

Kateamama's Posts

Nairaland Forum › Kateamama's Profile › Kateamama's Posts

1 (of 1 pages)

Romance › Re: Must A Girl Sleep Around To Make Ends Meet. by kateamama: 5:56pm On Mar 04, 2012
O boy, life no easy for we ladies. everyday na hustle for us. to even pass your course for school, you must sort either in cash or kind. as for me, na kind i dey give. even the house wey i dey stay, na my body i take get the money to pay for am. plus my black berry phone, na one guy buy am for me, after e don sleep with me like three times. men no dey do anything for free, when it comes to ladies. dem must sleep with you before helping you. even to fetch water self, those small boys go dey eye you somehow. na so, our life be. every girl dey hustle for life. tell me, is there any guy out there, that can help a girl for free without asking for something in return, even for a relationship. dont mind them, all of them na the same.

1 (of 1 pages)