MartinLawrenCe's Posts
Nairaland Forum › MartinLawrenCe's Profile › MartinLawrenCe's Posts
1 2 (of 2 pages)
Deustchemann:Bro. I have been on board for 1 month + in cat B please what are the rumours? what shall we cat B pipo do?! |
HighPriest0:You mean dey gave you date for appointment twice and you cancelled twice?! You be Senior man o |
Aja101:Yes I don mail them. No reply. Maybe if Alot of Category B pipo drop mail dey will reply or give dates... |
jimohabdo:Hahahah...Brother, it takes Months. I have been waiting for 5 weeks + now. Yet people that booked in Cat A this month don get date already. E be like say them no like Bachelor candidates... Anyway Me I want to create a new thread for Category B pipo... We gas plan d way forward. Whether call, message or even go to the embassy to ask them how far? On a serious note anybody in Cat B, what is the way forward This wait don taya me. |
My Cat B pipo... Shey we no go contact embassy... Especially us wey don wait for 1 month +... Make dem know say we don wait taya na... Me I don taya o... This no be AM so e no suppose hard to give person date na... Waiting for AM sef, d person ft don get d AM by now sef. This one wey just be Date for appointment come hard like this to get... E be like say dem don forget us... Me I go contact dem soon sha. Abeg anybody going for interview soon. When dem ask you if you get any question abeg help us ask dem if Cat B pipo will still be given dates Say your cousin booked since but never get date and hin no know if hin go ever get d date... Help us please... |
5 weeks + and still no date. Cat B. Thank you German embassy. Danke. Obrigado! |
mikkypel:No wahala bro. I go definitely update the house. My own na say make them give us date jharey... This my guy wey book 17th don enter 5 weeks now sha. If by next week latest we no hear from them. I go just lock up on the matter. Appointment date no suppose hard like this especially when man don book early. Anyhow sha if date show I go drop am for here... You sef drop update when e show because at this point me don dey lose faith mehn... |
Naturetony1:I swear bro... This thing wey dem do to us category B people no dey fair at all mehn... |
heybaby12:Mehnn... we can't say actually. Just tell that person to go buy brand new mouka foam bed wey hin go dey sleep ontop coz the chillz no be here. I don apply since 23rd no date. I sahbi person wey apply 17th no date yet.... |
My Category B people, how una dey? I dey reason make we chill for beach this weekend. Make we drink and relax jharey. Let us share some good time together until the embassy help us with appointment date. They say relaxing at the pool or a beach helps to cure depression. Let us unite my people! atleast we can share some good time together and not overthink even though we do not deserve what the embassy are doing to us by waiting for appointment date for almost a month. It is well my people! Las Las we go dey alright. Category B I send my love to us jharey........ |
HighPriest0:Congrats!!! |
boywonder225:Sept 17...Enrolment will start in august sha. Kai make them just give us date abeg... I don taya to dey wait...even admission nor long like this. Kai, Embassy please na... Please give cat B dates na... |
boywonder225:Amen |
boywonder225:Mesef. I am currently drowning in it... Kai.... I got admission early booked early but yet I am still waiting while CatA people that got admission this month already have dates. This thing is not fair sha. Me wey still dey hustle for first degree... |
Kevwe06:If they give us september dates then I will be spending xmas in akwa-ibom because my enrolment is august... |
Cat B people... honestly we should create a whatsapp group...so we can give ourselves a group hug in order not to fall ill of depression... ![]() |
Hycent007:It is obviously cat A. German embassy please na, give cat B dates... We just want a first degree... |
HighPriest0:No mehn... but this Category thing no make sense na. Whether Master or Bachelor sheybi na school all of us wan go. Kai, me wan call the embassy to ask how far o... Man don dey wait for ages. Make I know if them go give us date. I go advise all category B people to start sending mails and calls sha. Make them know say we don wait taya. You dey category B? |
Category B people. Shey we no go call the embassy people for dates ni? I don book since May 23rd. No appointment yet while my friend in Category A got a date recently, he booked this june. German Embassy please give category B dates. Forgive us for our sins. Please |
1 2 (of 2 pages)
This wait don taya me.
