TV/Movies › Re: Nigerians React As Efe Wins BBNaija 2017 "Warri No Dey Carry Last" by optional1(f): 11:46pm On Apr 09, 2017 |
abels: .. LOL U DE CRASE O na now u no  Naija as a whole body dey crase gan...
We no fit run from our troubles.. |
TV/Movies › Re: Big Brother Naija 2017 Winner Announcement & Grand Finale Thread by optional1(f): 11:44pm On Apr 09, 2017 |
Caringguy: Gudnyt troublesome girl... gudnyt ke
una don dey sleep for una area....
Me no troublesome oh. |
TV/Movies › Re: What If The Last Two Bbnaija Housemates Were Like Efe.? by optional1(f): 11:42pm On Apr 09, 2017 |
olihilistic: Lol...
do you mind if I join? u jst wan open my ynash dis night...
Na mat i dey use so e no go contain us like 2people. |
TV/Movies › Re: Big Brother Naija 2017 Winner Announcement & Grand Finale Thread by optional1(f): 11:36pm On Apr 09, 2017 |
Chelseafan1: Lol, na midnight tins we wan do enter there??
Flying without plane things.  yes oh....
If you crash for barbed wire i no dey oh...
I don climb bed. |
TV/Movies › Re: What If The Last Two Bbnaija Housemates Were Like Efe.? by optional1(f): 11:33pm On Apr 09, 2017 |
olihilistic: He ought to have known unless he is as dumb as IamAirfor aaah ah i no dey oh.... Make i climb bed first. |
TV/Movies › Re: Big Brother Naija 2017 Winner Announcement & Grand Finale Thread by optional1(f): 11:31pm On Apr 09, 2017 |
Caringguy:
 i don go sleep see u in trump mansion. |
TV/Movies › Re: Big Brother Naija 2017 Winner Announcement & Grand Finale Thread by optional1(f): 11:30pm On Apr 09, 2017 |
Chelseafan1: Na wa oh, a lot dey happen for this land o i don do am..
Make i go sleep see you in palm beach miami florida. |
TV/Movies › Re: What If The Last Two Bbnaija Housemates Were Like Efe.? by optional1(f): 11:28pm On Apr 09, 2017 |
[quote author=olihilistic post=55427893][/quote]tell am jor em go understand watsup. |
TV/Movies › Re: What If The Last Two Bbnaija Housemates Were Like Efe.? by optional1(f): 11:26pm On Apr 09, 2017 |
nobody if be like another body e no possible oga op.. The last time i check d show finish by 9.30pm and the matter wey dey for ground before bbn start still dey.
Matter like.... we still dey recession.. Baba still dey sit.. Dino ceritificate still dey for ground.... Pastor sule nd miss otobo case still dey... Madam kemi dey prison.. Matter still plenty for ground for us... |
TV/Movies › Re: Big Brother Naija 2017 Winner Announcement & Grand Finale Thread by optional1(f): 11:22pm On Apr 09, 2017 |
Caringguy: And once we get there what will happen? what happened in 1914 will repeat it's self. |
TV/Movies › Re: Big Brother Naija 2017 Winner Announcement & Grand Finale Thread by optional1(f): 11:09pm On Apr 09, 2017 |
Caringguy: Ok where you want make we enter? palm beach Florida trump mansion. |
TV/Movies › Re: Big Brother Naija 2017 Winner Announcement & Grand Finale Thread by optional1(f): 11:04pm On Apr 09, 2017 |
Chelseafan1: Ehen, for this same nairaland? before nko na for dollarland  |
TV/Movies › Re: Big Brother Naija 2017 Winner Announcement & Grand Finale Thread by optional1(f): 11:02pm On Apr 09, 2017 |
Caringguy: Ok i don dash you one like, can you now pass? i don dash you one like and one share.. I no fit pass like dat.. Na me and you go pass together. |
TV/Movies › Re: Big Brother Naija 2017 Winner Announcement & Grand Finale Thread by optional1(f): 10:58pm On Apr 09, 2017 |
Niyuu: BBN is over.... ....
What do I do with my life now?? no vex na suggestion oh....
Third mainland bridge still dey nah abi lagoon don dry...
No vex abeg na just suggestion. |
TV/Movies › Re: Big Brother Naija 2017 Winner Announcement & Grand Finale Thread by optional1(f): 10:52pm On Apr 09, 2017 |
Chelseafan1: Lol, no fear, nobody fit pour you acid.  e don happen before and e go still happen if i no take my time. |
TV/Movies › Re: Big Brother Naija 2017 Winner Announcement & Grand Finale Thread by optional1(f): 10:51pm On Apr 09, 2017 |
Caringguy: Ok keep passing and don't look back.. shuo
you been dey pursue me since ni 
Infact we dey go together... Trump go pursue us together.. |
TV/Movies › Re: Nigerians React As Efe Wins BBNaija 2017 "Warri No Dey Carry Last" by optional1(f): 10:49pm On Apr 09, 2017 |
FelixFelicis: lol before you tear me with the frustration ni as Debbie no dey top 3  lolz i no be like dat nah.. I no fit sell another person gala for my head nah wen d person too get head.. |
TV/Movies › Re: Big Brother Naija 2017 Winner Announcement & Grand Finale Thread by optional1(f): 10:44pm On Apr 09, 2017 |
Chelseafan1: So, u dey indirectly tell me make I face front, u no want me abi?  i no wat make dem pour me acid for face again oh.. I don waka as i take waka come. |
TV/Movies › Re: Big Brother Naija 2017 Winner Announcement & Grand Finale Thread by optional1(f): 10:41pm On Apr 09, 2017 |
Caringguy: Join waiting? na pass i just been dey pass oh.. |
TV/Movies › Re: Big Brother Naija 2017 Winner Announcement & Grand Finale Thread by optional1(f): 10:40pm On Apr 09, 2017 |
Caringguy: Nor mind that guy, he wan thief people brother... lolz wehdon sir |
TV/Movies › Re: Nigerians React As Efe Wins BBNaija 2017 "Warri No Dey Carry Last" by optional1(f): 10:38pm On Apr 09, 2017 |
FelixFelicis: lol chill na, na SNOWCREAM, I know you before I troll you  shuo why u come dey confess so quick... Na so u fear reach... So u no get liver before?? |
TV/Movies › Re: Big Brother Naija 2017 Winner Announcement & Grand Finale Thread by optional1(f): 10:36pm On Apr 09, 2017 |
Chelseafan1: Shey u go gree 4 me as refiner no wan gree?  abeg oh... Wat bbn has put together let no option not to talk of optional put assunder oh.. I don walk enter room. |
TV/Movies › Re: Nigerians React As Efe Wins BBNaija 2017 "Warri No Dey Carry Last" by optional1(f): 10:33pm On Apr 09, 2017 |
poshestmina: hahahahahahahahaha...they will start big sister Naija soon ,followed by big daddy ,mummy Naija ...we don tire for naija matter,anything to keep our minds busy. my sister na till 10yrs time any show fit start again oh... Reality don still catch us oh we still never move from where bbn start em motor... |
TV/Movies › Re: Big Brother Naija 2017 Winner Announcement & Grand Finale Thread by optional1(f): 10:29pm On Apr 09, 2017 |
Chelseafan1: #factsonly beautiful.  na pass i been dy pass oh i no seeing anythings oh... |
TV/Movies › Re: Big Brother Naija 2017 Winner Announcement & Grand Finale Thread by optional1(f): 10:28pm On Apr 09, 2017 |
|
TV/Movies › Re: Nigerians React As Efe Wins BBNaija 2017 "Warri No Dey Carry Last" by optional1(f): 10:28pm On Apr 09, 2017 |
FelixFelicis: wetin concern you with Dino certificate ehn? Mrs Debbie rice  Dino certificate koncerned me be say na kogi here em b dat representing for dere dy disgracing us.... Debbie rise or rice don rise pass you level oh.. Make u siddon dere dy wait for efe for d molla |
TV/Movies › Re: Nigerians React As Efe Wins BBNaija 2017 "Warri No Dey Carry Last" by optional1(f): 10:24pm On Apr 09, 2017 |
Lily4star: ..
Abeg ah no fit laff na d real shows dem be dat oh...
So no too laff we dey inside together. |
TV/Movies › Re: Big Brother Naija 2017 Winner Announcement & Grand Finale Thread by optional1(f): 10:22pm On Apr 09, 2017 |
Chelseafan1: Lol, actually Efe is my younger brother. 
Lemme show u our family pics on whatsapp na.  oboi see lies
cc. Caringguy u dy see bah |
TV/Movies › Re: Big Brother Naija 2017 Winner Announcement & Grand Finale Thread by optional1(f): 10:21pm On Apr 09, 2017 |
|
TV/Movies › Re: Big Brother Naija 2017 Winner Announcement & Grand Finale Thread by optional1(f): 10:20pm On Apr 09, 2017 |
|
TV/Movies › Re: Big Brother Naija 2017 Winner Announcement & Grand Finale Thread by optional1(f): 10:18pm On Apr 09, 2017 |
dacovajnr: Come inside, I wan tell you something ok sir
over there already. |
TV/Movies › Re: . by optional1(f): 10:02pm On Apr 09, 2017 |
Weytin u won use d channel do  ?
Btw
Show don finish
welcome back
we still dey recession..
Baba still dey sit..
Dino ceritificate still dey for ground....
Pastor sule nd miss otobo case still dey... Madam kemi dey prison..
Matter still plenty for ground for us.. |