₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,331,258 members, 8,449,453 topics. Date: Tuesday, 21 July 2026 at 07:19 PM

Toggle theme

Ozila's Posts

Nairaland ForumOzila's ProfileOzila's Posts

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 37 38 39 40 41 42 43 44 45 (of 81 pages)

RomanceRe: The Mysterious Twenty Thousand Naira by ozila(op): 5:17pm On Mar 17, 2016
Chapter Six

I begin they waka go Glory house (my sunshine) i love that girl so
much in that i can kill for her, you know what i mean? I nor mean kill
human being oh, i mean like catch rabbit and kill am for both of us.
As i dey go i dey see many many studunts for road, oh men, i don
fuckup oh, i quickly put a call to Glory, she didnt pick at first, i
call her again they say number busy, the third time still number
busy, hmmm na wa oh, na which kind person she dey yarn with na wey
come make her number they busy busy, well i wait for five minutes
before i call her again, dont forget i dey road dey go her house oh, i
never even reach anywhere self,
Glory: hello.
Me: na wetin make ur number they busy na?
Glory: wetin happen?
Me: why you dey answer me like that?
Glory: tell me wetin you wan tell me, i dey busy they ready for school.
Me: abeg give me faith number i dey come your house make i nor miss
her for road.
Glory: she don commot tey tey self with the book,
Me: waoh, she go don reach school?
Glory: i dont think so, wait let me call her.
She cut the call, and me come stand for center of the street road they wait for her to call me back, make e
no be say i miss this gurl oh, after some minutes she called me again.
Glory: she say make you wait for her for catholic church wey dey our road,
Me: na there i even stand now.
Glory: okay keep on waiting i will soon join you guys.
Me: okay be fast, luv you.
Glory: love me? Abeg go sit down joor.
Me: na why you they talk like that na?
She cut the call again, na wa for this girl oh, na three times she don
cut my call today, three times abi two times? Well e be like say na
two times, but if we they argue i go say na three times.
I waka go front small and stand for front of the church begin wait for
miss Faith, faith na Glory roomate and i hate the girl with passion,
she too they form and me i nor they like people wey they form, anytime
i go visit Glory na so she go just form throway face commot for room
for us, even sometimes self Glory have to signal her before she will
leave or she will leave by herself when she see say we don start romance, i nor blame her, na becus of one mumu physics lecturer wey they
Bleep her black ass, she no even sabi anything apart
from english, her
score na yash she dey take get am, e get one time
wey she and one girl
they quarrel for school come see as them they insult each other,
shouting anyhow,
""""""
me i dey paste result for board when faith come check her own, she
check am finish begin jubilate, e be like say she get A, then chioma
come check her own and her face change,
Chioma: hmm me wey i dey write everything, they answer question for
class, they score highest for test, how manage i come get BC? This
ojoro go stop oh.
She was so angry that she push faith out of the way, faith retaliate and
hold her back
Faith: are you okay or you are blind now because of your score?
Chioma: leave my shirt jare, see who they talk, as if you sabi anything.
Faith: i dont know anything but my scores are higher than yours.
Come see people don they comeout.
Chioma: your scores, is it what you wrote they give you, abeg commot
for my front jare, after you don go use your yash score point already
you come here they make mouth.
Faith: oh yes i score point with my ass go and die, na me say make you
get flat yash.
Chioma: i nor get your time joor.
Faith: nonsense girl like you wan form big girl for were i dey, you
fit go were i dey go
""""""
"Oziegbe" i was shock that i came back to reality, i was so lost in my
thought that i didnt even hear my name been called.
Faith: did somebody die? (she came close to me)
Me: die as in?
Faith: because i've been calling since now.
RomanceRe: The Mysterious Twenty Thousand Naira by ozila(op): 5:16pm On Mar 17, 2016
Chapter Five

I waka reach school and those idiot security men tell me make i show
them my school ID card, i nor know when them bring this nonsense law oh, we nor
they show ID card before na, na to just enter gate, abi e be like say na the new rector bring
this yeye law,
me i nor hold my ID here,
and e be like say na me be first person for school apart from those
deeper life member wey them they sleep for school, or maybe them they
come around 5AM na them sabi, anyway i sit down for one restuarant wey
they there they wait for the first guy to show, i like the woman wey
they sell there for here well well, she get three children and one old man as
husband, wetin they trip me for the woman be say she get yash like
yatch, she get body come get big breast like toolz chai, women wey don born they
fine like this? some people they say once women don born them go lose
their shape, wether na true i nor know because e be like say na now
this woman shape they come out, omon na to find wey break the code oh, I hope them no go burst my head sha, to come imagine the tight tight clothes wey she dey wear self which guy head no go scatter?
I sit down for her frontage dey look gate like gateman, then i saw the
first guy, the guy dey ugly na once them go differentiate us, the guy
just show im id and enter inside, na wa oh, na why me nor come know na,
maybe na because i nor they like read notice board, na only when them
they paste result i dey near notice board, i remember when them put my
name for one of the guy wey win award (facebook award) na person come
tell me for class after three days, and i nor know say them put the
money for registration, na later when we dey collect clearance i know.
Three guys pass them nor fit my taste until i see one handsome dude
like me dey come, omon the way i rush get up as if i wan go toast am,
lol,
Me: bro how far na.
Bro: i dey oh, na wetin happen?
Me: u dey fear?
Bro: the one wey you just rush come so how I nor go fear na?
Me: guy no fear i just want ask something from you.
Bro: wetin be that?
Me: upon say you na guy like me, you gat to help, i forget my
school id for house and i need your own.
Bro: why you go forget your own?
Me: na rush oh.
Bro: if i give you my own na how i go come take enter?
Me: that one simple na, once you enter inside, you come back here and
throw your id for me, them me go use am enter.
Bro: how I go take know say u nor go run with am?
Me: come on bro wetin I wan use am do, na money e be? abeg help me joor.
Bro: hmmm, na how much you give me?
Me: bro abeg help me na, me i dey broke as you see me so.
Bro: then forget na if you nor go give me anything.
Me: you be guy man like me oh, why you wan fall fellow guy hand na.
Bro: no vex.
See this guy oh, him just waka leave me for there like i toast am him
no gree, oh men i go show that guy pepper,, imagine a whole senior
like me, and i believe say him go be my junior oh.
Waoh, if i say make i return back na, before i dey come back time don
go, so make i cucuma enter road they go Glory house, with luck i fit
see faith for road, so i carry my small bag and begin waka go Glory
house.
RomanceRe: The Mysterious Twenty Thousand Naira by ozila(op): 5:13pm On Mar 17, 2016
Chapter four

Well i stood up and took garri from my blue rubber, na by this time
they sweet to drink garri, i on my laptop and started playing music,
i soak the garri put milk and chocolate (my best combo) i begin they
drink garri in the middle of the night and my garri don finish oh,
after i finish drinking the garri, i took one big mathematics textbook
and search for calculus, i nor see am, so i took another textbook and
search for calculus i still no see am, na wa oh, i took my notebook
and try to pickout something that will help me in the assignment, but
i nor grab anything, so i finally giveup and cover my book, i cover my
laptop also and lay my head on my pillow and doze of.
The next day i woke up early and quickly fetch water outside, na buy
we dey buy the water and na ten ten naira, i dey hold the man more
than three hundred naira, anytime i get money i dey always forget to
pay, na when i nor get money i dey remember, i fetch my water jejeje
and enter my small creeb, i check time 7:06AM, waoh time dey run oh,
so i quickly took my bath and wear my dress hurridly, i nor get mirrow
so i use my phonescreen to do mirrow,.
After i package myself finish i enter road they go school, i borrow
hundred naira from mtn sharp sharp and call glory,
she pick am once like say she they expect my call before.
Glory: hello dear
Me: babe how far.
Glory: how far still they far
Me: i hope you don ready finish?
Glory: nah na now i wan take my bath now.
Me: why na, i think i tell you say make you quick come so that i go
copy your assignment.
Glory: no oh i nor go quick come oh, i get wetin i dey do for house.
Me: na wetin you they do
Glory: no worry, when you see me you go know.
Me: okay abeg how we go do the assignment?
Glory: you go help me summit am, i go give faith my roomate make she give you.
Me: na which time she go come?
Glory: i nor know but i believe say she go first me come.
Me: nnah ehh, you dey fucck up oh.
Glory: hiah you don see up wey dey fucck before?
Me: abeg do dey come joor,
Glory: i dey vex for you oh.
Me: wetin happen, what i do?
Glory: so you wan tell me say you nor know.
Me: know wetin na?
Glory: chai Jesus, i don suffer.
Me: tell me na, abi na because of your birthday tomorrow?
Glory: no worry, leave bye bye we go see for school.
Me: tell faith make she............
"kpam kpam kpam"
she cut the call on me, how can she do that? a whole me gburu gburu
one of Edo (i nor know wetin e mean, make una ask negus).
I was surprise she just cut the call like that without even telling me
what i did, well make we reach school first, but the thing dey vex me
oh, wey e be say i borrow credit call her she come they cut the call,
hmmmm i nor blame her, na her pusssi i blame wey sweet like that.
RomanceRe: The Mysterious Twenty Thousand Naira by ozila(op): 5:12pm On Mar 17, 2016
Chapter Three

Mum: so na because of five thousand naira you nor they fine abi?
Me: yes na everybody for class don pay finish na me remain.
Mum: then why you nor tell me since?
Me: na urgent oh.
Mum: how excursion go be urgent something abiperson no go prepare down?
Me: them no quick tell us.
Mum: then you better wait oh because government never pay us.
Me: the dead line don pass oh.
Mum: tell them to hold on, abi them don pay una lecturer? i wonder wetin you they use all your money do.
Me: hiah, na handout na abeg mum try na.
Mum: no worry make month end you hear, bye bye.
She don cut am be that, so na wetin i go cum donow eh, i dey hate this kind nonsense joor, na now wey i need money na im fuckup come they now abi, anyway make i see wetin my mumu neighbour go talk. I leave my room go knock for my neigbhour door, the idiot loud music as if him they party, i wonder wetin him dey do for inside that room, i knock and knock and knock the idiot no hear, so i enter my room back and took my phone, i called him five times before he pick,
Joshua: na why you they disturb me na?
Me: my good neighnour, how you they?
Joshua: the one wey you they call me good neighbour so, make u know say i nor get garri for house oh, because i nor say everytime wey you need garri na im you they form good friend.
Me: hiah, come outside na i wan yan you something.
Josh: na better thing?
Me: yes na,. Na one babe like that wey i wan give you.
Josh: oya come my doormouth now. I cut the call and quickly ran to his door, i saw him standing there.
Me: bros bros (i hail him)
Josh: forget that one joor, na which babe be that.
Me: na one oshere oh, the girl make sense die.
Josh: na how i go get her na?
Me: i get her number na.
Josh: oyaa call am for me sharp sharp.
Me: no wait first, e get wetin i need from you before i go give you the number.
Josh: na wetin be that na?
Me: i need you to borrow me five thousand naira month end i go give you back.
Josh: “chineke me ehh”,
Me: na why you they shout like that na?
Josh: you wicked well well, you nor like me at all.
Me: wetin i do you?
Josh: so because of only number na im you wancollect five thousand naira, god punish you.
Me: i go give you back month end na.
Josh: i dey tell you say no garri for house, you no get sense at all?
Me: abeg no vex bye bye idiot.
Josh: oyan anra.
Na mumu him just because of only five thousandnaira na im they shout as if him they hospital wan born pikin, i nor know why that guy they always mumu like that oh.
I enter my room and close my door, time to sleep for tomorrow, school dey tomorrow and we get assignment self wey Mr. Joseph give us, and i hate calculus well well, i have to go school in time oh to copy from glory my lover, that girlhead they scatter for calculus, wether them tear her head put test book i nor know, so i charge all my phone, torch and laptop, i took water out and baf, around after nine i snore into dreamworld,::::::::i see myself for big river with other fishermen, they took net and start catching fish, me i just stand they look them, they look like americans, i look my left and saw a basket, i took the basket and start packing snail on the ground, they many well well so i continue packing, as i was packing it i was couting them, i park twenty thousand snails, inside one small basket, then i took canoe and paddle it to one big stadium, i enter the stadium and start sharing it to evrybody, i make sure it get to everyone, then after i share the snail finish, i left the stadium and enter my canoe and paddle it back, on my way i saw a big ship with guns coming towards me, na those white guys wey i dey follow fish they the ship, as i saw them i try to get out of the way but they bend the ship to my side and wanted to crush me, as they wan just hit me na im i wakeup.I look around and saw my alarm ringing, thank you alarm for saving me from that ship, but i wonder why my alarm they by 12:01AM, i dont rememebr setting my alarm oh.
RomanceRe: The Mysterious Twenty Thousand Naira by ozila(op): 5:12pm On Mar 17, 2016
Chapter Two
I continue watching my movie, though i will have to pay a fee for ignoring, me wey no get money were i wan see money pay, mtcheew abeg make them they go joor, i dey talk about Glory them they talk about environmental sanitation, oh yeah Glory is her name, on the day of my birthday she was the first person to wish me happy birthday, because of that she called me by 11:30PM and we talk till 12AM, she say she nor want make another person first her wish me happy birthday, i like the girl sha, i love everything about her expecially her backside, and when she they ontop me they do kerewa oh men, my eye they turn me like person wey win lottery, that her yash na die, and also she they like dress cooperate, she’s a Science student soi understand, she’s short, dark and have fine face come get open teeth join am, and i believe say na that open teeth make her fine, no be me wey get two open teeth come make me be like Vampire 2.2, but i fine sha.I watch movie till sleep enter my eye, around evening i stand up go check first bank for Aba/Owerri Road wether i go get small thing for hand, i reach there come see cue, i nor know why long cue they always they this bank upon all say them get many Atm matchine, so i decided to wait, yes i can do anything for Glory, na she be my glo unlimited.I stay for line till twenty minutes, e be like the line no they move because na where i stand na im i still they, even some guys don fed up begin go house with anoyance, well them no get wetin them want use money do like me wey get party to host, i remain in the cue till night that means i spend one hour twenty minutes there, na one person come they my front and i begin smile for my mind small, devil wan come do im own as e dey reach my turn soldier come out from nowhere, as i see them na im i say make i quickly put my Atm card, the black man shouted “hey you hold am there” i pause immediately.
Soldier: you they see us wan come withdraw you wan quick put your Atm abi?
Me: sorry sir, i nor know.
Soldier: oya shift go one corner, I shift oh, the others remain in the van while the oga stand for my front they withdraw, i nor want any wahala with those guys, they can be so wicked at times, i wonder where them they see their weed buy, the soldier wether na inspect him come inspect the Atm i nor know because him bend down begin they look every part of the Atm, him guys they motor they wait for am,
Soldier: na how this thing they work self?
Me: make i assist you?
Soldier: oya come.
Na Idiot na im be, him put card, and the Atm show “Reset Password” or “put password”so i press put password and told him him to puthis pin.
Soldier: oya shift go back.
I give am space and i guess he knows the rest by himself, he withdraw money for good ten minutes, so when e reach my turn, i put my Atm and check my balance nothing they, “Oh My God” so i just spend good 2 hours here for nothing, no wahala there is god, there is god oh, i left the bank with anger, when i got home i took my phone and called my mum,
Mum: hello Oziegbe
Me: good evening ma.
Mum: how you they?Me: i nor they fine.
Mum: hiah, abeg say you they fine.
Me: i nor they fine joor.
Mum: Oziegbe say you they fine now.
Me: okay i dey fine.
Mum: good, make you nor they use your mouth talk bad bad things.
Me: okay ma.
Mum: so wetin happen?
Me: we they go on excursion and i nor get money.
Mum: how much?
Me: five thousand naira.
RomanceThe Mysterious Twenty Thousand Naira by ozila(op):
The mysterious twenty thousand naira
By: Akhigbe Oziegbe
No part of this story should be republish without my permission.
WhatsApp 08066418379


Chapter One
Last week was my birthday i didnt celebrate it because no money at all, the only gift i got was from my girlfriend and of course you know the items
1. Boxer
2. Singlet
3. Handkie
4. Chew gum she come manage buy 200 naira recharge card join, i dont know why some girls cannot give their guys a better gift and when e reach their turn they will be expecting Iphone 6s, well i dont blame them because they belief that we are the one to spend for them not the other way round,so i relaxed in my room watching blue film with my laptop in Aba, Abia State Nigeria.I am Oziegbe, i school in Aba.Next tomorrow is my girlfriend birthday and i dont have anything with me, how do i celebrate it? she has been disturbing me from day one that she want a party in China Town Along Aba/Owerri Road, and of course i promised heri will take her there, but now i nor even get garri to drink for house, na how i wan take carry her go outing, hmmmm i wish we can justjump the date, i put a call to my brothers and sisters everybody wey i know, but all i got is that month never end.Hmmmmmm, maybe i go go steal oh, because if i nor celebrate this birthday na big fucckup oh, and me i love the girl and i nor want do anything wey go make her vex, i love her because she is cool, nice, hot (in bed) and clever, she sabi calculus well well and me i dull for maths right from childhood and also she be our VP for our department, so imagine the guy wey i dey blow when me and she they waka for road, dating VP for our department na big boy things na.I was carried away watching blue film when somebody knock on my door, chai i dey hate amwell well say i dey watch blue film person come knock wey e be say my dragon still stand between my leg, hmmm i pause the film and close the laptop, i use towel cover myself because i nor wear anything before, i cover mydownside well well then i waka go open door,.
Me: na who be that?
Unknown: na me Joshua i open the door.
Me: na wetin you dey findabeg come out for environmental.Me: you dey craze, na im make you wan break my door.
Joshua: na you dey mad, see as you increase the volume of film wey you they watch, abi you nor know say people they hear, since you nor get wetin you wan do this morning better comeout make we do clean up.
Me: get out joor.I lock my door again, and he shouted from outside“if you wan fucck no be pionner they back of you so, money wey you don use buy tissue paper take they clean up after you marstubate finish go don reach you fucck one girl.“na how him know say i they marstubate”?
BusinessRe: Today's Naira Rate Against Dollar, Pound And Euro by ozila(m): 12:33pm On Mar 17, 2016
4nobody4every1:
cool
weldone sir
LiteratureRe: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by ozila(op): 9:55am On Mar 15, 2016
Johnsown1:
I thought the government are giving free medical check up for an angular depreciated people
guy just ignore him abeg, dont reply him again silence is the best answer.
2 Likes
LiteratureRe: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by ozila(op): 9:39am On Mar 15, 2016
[b]SixtyOne
Holy shit, i thought they said shes my spiritual mother, how can a mother use her son for sacrifice? Thats odd to me.
I didnt sleep again cus am afraid i will see her again in my dream, i stood up and look for waec past question and start reading, tomorrow i will go to school for lesson even though i nor want go make i just go see how them they prepare for the exam oh, i dont want any fuccking surprise oh.
I dey read but wetin i dey read nor they enter my head at all, all wetin i dey think of na my branch root, i nor even hungry self or maybe time never reach to chop? I continue to reminence over the whole matter till somebody knock for door, i stand up go look who they door, of course na my loving mother.
Me: welcome ma "i said behaving like say everything they calm"
Mum: ooh how you they "she said and walk inside"
Me: i dey fine how market ma?
Mum: we thank God oh, na were you put your phone since last night?
Me: my phone, my phone "i repeat scratching my head as if i don lost memory" oh yeah my phone i gave it to Varth to charge for me because no light last night.
Mum: okay no wahala, " she said and enter her room".
Where my phone even dey self, e be like i forget am for Lizzy house oh, or i forget am for party?
My head they turn me i cant remember where i put my phone, later i go go see varth and ask am, the way he even leave me for that party i believe he deserve a slap, but who will see ghost and stand? Nobody of course so i nor blame am, but im be my friend na he suppose stand by me no matter what, hmmm as if if na me i go stand, well thats another chapter i guess.
I remain in my room like someone in prison, afraid to go out becuase i believe outside is too dangerous for me, my mum after cooking she left me alone at home and go to work, i suppose go school go check somethings but i don postpone am to tomorrow because of security reasons lol, my life is important to me so i take my life serious, later in the afternoon i took my bath and disappear to my pastors house, i met him watching football, i told you guys before that our pastor is a football freak, so make una no surprise say 24 hours na match him they watch, him get another television for inside house wey him beautiful wife they watch, now lets talk about my pastor.
My pastor (name withheld) is from Okpella, Ogute precisely not my own Ogute oh Okpella have a community called Ogute just like ours, and they believe so much on manmade gods just like ours too, Him get fine wife with beautiful daughter, the wife na from Okpella too, my pastor na very strong man him don do many wonders for Okpella thus tilll now every Okpella person they respect am, when he come Emai everything change many things which i cant mention, though as we proceed you will know him well.
Pastor: my oga you come see me today? "he shouted as he saw me.
Me: Good Afternoon Sir.
Pastor: how you they na?
Me: am fine sir, " i sat with him on the cushion chair.
Pastor: how mummy?
Me: fine sir how family na?
Pastor: we thank God.
Me: you dey watch match?
Pastor: yes oh, i wan go somewhere but i wan finish this match first, oboy liverpool they fuckup now oh.
Me: liverpool na small boys na,.
Pastor: go sit down because una manage beat us?
Me: manage ke, wey e be say we wan pool una liver.
Pastor: hahahaha no worry second leg they come.
Me: we go still beat una oh.
Pastor: make we they watch, na wetin they happen self?
Me: nothing oh.
Pastor: nothing wey your heart they beat fast u dey tell me nothing.
Me: hmmm no be small thing oh, i get many problem oh, if i beging they talk we nor go commot here today oh.
Pastor: hmmm i wan go out now, come later in the evening or meet me in church, and i hope you they prepare for the three days fasting for mountain?
Me: yes sir, i dey prepare.
Pastor: better then you have nothing to be afraid of, we are going there to break every yolk disturbing us and this community, so its better you start preparing now, because the devil can use many ways to stop you from going, before fasting the last thing you encounter is the devil trying to stop you from going and after fasting the first thing you encounter also is the devil trying to test you and tempt you, so my guy be prepare.
Me: okay sir.
Pastor: alright come to church this evening we have prayers.
Me: i will come sir.
Pastor: alright let me start preparing but this match i be no wan miss am oh.
Me: you go watch the highlight na, okay make i they go bye bye sir.
Pastor: okay God bless you.
I left his house and come out from the gate, guess who is waiting for me outside.[/b]
1 Like
LiteratureRe: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by ozila(op): 11:47pm On Mar 14, 2016
update continue tomorrow
1 Like
LiteratureRe: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by ozila(op): 3:24pm On Mar 13, 2016
[b]sixty


Her face is very red even though day never break finish but its bright enough to see her full body, she get wing like that of bat, her face look scary also with her long nails, na who go see this kind thing and still stand they look? Well of course i ran back but the demon pursued me like say i took something that belong to her, i ran back to Lizzy's house getting to the gate now something raised me up from ground, i look down and saw myself on the air, something is taking me up not just something but annabel, she hold me tight like say am her missing rib.
She begin fly go up up, i was shouting calling lizzy for help but i nor see any help.
"calm down i wont hurt you" she said though you cant trust a demon can you? I continue shouting because where i dey far from ground i look where she dey even carry me go self then i realize that shes taking me to my village Ogute, i dont know if shes taking me to my house exactly so i continue to shout for help, i wonder where Lizzy go wey she no hear my voice oh, i thought shes always watching over me.
"where are you taking me to"? I shouted at her.
Ann: to your house.
I was surprise at her response so i calm down a bit and hold her tight very well so that i wont fall though i was still very much afraid but safety first, i be dey struggle before trying to escape as if i get anyway to go for air, or maybe i have because Lizzy told me that i can fly, hahaha misplace priority, i dont believe that shit, infact when i get home the first thing for me to do is to meet my pastor so that he will perform deliverance for me because i really think i need deliverance now.
Ann took me to the back of our building (our small garden) and drop me there, as she drop me i turn around to look at her i didnt see her again, what i saw baffle me, a beautiful damsel like the one from the party, what make her beautiful is because shes not with any fucking bangles or cowries, this time she wear normal london cloths i look her from up to down, i look at her leg and i saw a red cloth tied on her leg.
Me: Ann?
Ann: yes, dont be afraid i wont hurt you.
Me: you wont, why?
Ann: because am on your side.
Me: how come? "still afraid"
Ann: well i talk to lizzy, this is your house right?
Me: yes and i dont need to ask you how you know right?
Ann: of course you dont need, am Annabel by the way, and am here to apologise for what happen at my party.
Me: oh yeah, that was scary what do you want with my hair by the way?
Ann: i dont know mother Queen asked for it as a gift.
Me: who is the mother Queen?
Ann: you should know that because his your mother.
Me: no no shes not dear, i have a real mother here so dont repeat that word please.
Ann: ooh.
Me: so she ask for it and you just agreed without investigating what she want it for.
Ann: am in no position to ask.
Me: why?
Ann: because am a greeener pasture.
Me: what do you mean by that?
Ann: you will understand on the run.
Me: hmmmm.
Ann: by the way i talk to Lizzy after you leave her house, thats why she didnt come to rescue you when you were shouting her name.
Me: oh i see what did you discuss about?
Ann: i just told her i wanna apologise to you.
Me: and you have to do it by scaring me.
Ann: well thats part of the plan to make you strong.
Me: hmmm, then you should be going now day don almost break.
Ann: oh yeah i cant fly now so please go in and bring transport fee for me.
Me: ok.
I walk to my frontage and open the door, i enter inside and took one hundred naira from our container, i return back after few seconds and give her the money,.
Ann: thank you.
Me: i should be thanking you, but how can you go home like this, no sleepers, rough hair and dirty body.
Ann: well i will manage, i have nothing to be ashame off, thanks again and please know that i will join you and Lizzy to fight your spiritual mother.
Me: hmmm not my mother and i dont have to fight her because shes not an enemy.
Ann: hahahahahaha you are funny.
Me: but thanks anyway.
Ann: you can count on me, though my power and lizzy still wont be enough to fight her oh we need like one more to fight a mother queen.
Me: well when the time reach which i doubt will even happen, wen e reach we go know.
Ann: alright see ya bye, now go.
Me: okay.
I left her there and enter inside my house and sleep deep sleep, inside my sleep i dreamt a horrible dream, i saw a dark smoke, inside the dark smoke i saw my so called spiritual mother, she open her red eyes to me and said.
Queen: even if you gather all the witches of the world to fight me, so far my blood is inside you i still own you.
[/b]

Please nobody should mention that bros again make him they derail they go.
3 Likes 1 Share
LiteratureRe: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by ozila(op): 1:41pm On Mar 13, 2016
Johnsown1:
I can see how busy u are boy. See how ur displaying ur childishness. Repeating one comment over and over. God have mercy on ur soul. I don't have that time and energy to waste with u boy. Look else were u must surely find ur type dia.
dont reply him again bro.
1 Like
LiteratureRe: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by ozila(op): 1:18pm On Mar 13, 2016
My followers please add me on whatsapp to join our whatsapp group for the continuation of this story.
LiteratureRe: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by ozila(op): 1:17pm On Mar 13, 2016
@ iamsylva please stop it biko you are my brother you shouldnt be doing something like this and i believe i didnt insult you or did i?
1 Like
LiteratureRe: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by ozila(op): 10:41am On Mar 12, 2016
sylvalord:
Look bro i am a confirm edo boy from benin city and i can categogy tell you that you are a liar. This story is pure fiction!! I am not denying that fact that some weird things happen in edo state but the way you are telling your story proves that it is fiction. Which normal guy will know that a girl is a witch and that she killed her parents and still stay with her, have sex with her? From your story, it is clear that you were not bewitched. The party with annabel, the police arrest, the way you describe d the reason your mum didn't know you were arrested, your so called mum that you encounted in the market, the shadow apparition and many other events you described prove that this story is FICTION. Nobody can deny the fact that this story is interesting but please stop deceiving people that it is real. Tell the truth, it is FICTION.
okay thank you, since you know alot please continue the story.
3 Likes
CultureRe: Ooni Ogunwusi Weds Wuraola Otiti In Benin (Photos) by ozila(m): 7:49am On Mar 12, 2016
pyyxxaro:
Benin stands Still


Say Wetin happen embarassed
dont mind, stand still for were? wey everybody dey waka up and down dey sell their stuff.
LiteratureRe: The Carpenter, The Witch And The Mysterious Mirrow by ozila(op): 7:09am On Mar 12, 2016
sylvalord:
You sound very gullible.. Even a four year old kid knows this story is fictional. It is interesting no doubt but it is fiction. The fact that the writer says it is real doesn't make it so.
you are wrong bro, i dont want any arguement if you see it as fiction enjoy good to have you onboard.
Only my Edo people will know if its real or not.
CelebritiesRe: Basketmouth Posted This About Buhari And See What He Got. by ozila(m): 4:13pm On Mar 11, 2016
Tummyyoung:
nun much tho
nd


Happy birthday to you!!!
Wullnp

superb stories! Thumbs up!!
tnx check my signature for more
CelebritiesRe: Basketmouth Posted This About Buhari And See What He Got. by ozila(m): 3:57pm On Mar 11, 2016
Tummyyoung:
lol
hi dear anything for me?
CelebritiesRe: Basketmouth Posted This About Buhari And See What He Got. by ozila(m): 3:47pm On Mar 11, 2016
Forwetinnah:
Shame on you...who inherited ruins? Were you crying for food before the Dullard took over,? Was there no light, fuel, excess to forex and basic amenities before the devil became president? Look at the state of the country today less than one year after GEJ left and you're talking about ruins. With GEJ this country was the 3rd fastest growing economy. ..booooohari out of spite for the South stopped all the past administration's effort to build a better country WITHOUT A BACK UP PLAN. SHOULDNT HE HAVE HAD A GOOD ECONOMIC PLAN BEFORE STOPPING GEJs..but no?? Appoint ministers. .wahala!! Write budget. ..fraud!! Improve the lives of Nigerians...ozila!! Stay at a place...wosai!! Improve the economy..."Nigeria is broke" ; but him shindrens dey fly private jet upandan and school overseas. Booooohari brought ruins to this country, he didn't inherit it but then; what should we expect from an illiterate??
yea u mentioned me

1 2 3 4 5 6 7 8 ... 37 38 39 40 41 42 43 44 45 (of 81 pages)