₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,325,277 members, 8,421,140 topics. Date: Friday, 05 June 2026 at 08:32 PM

Toggle theme

I Dey Find Work - Jobs/Vacancies - Nairaland

Nairaland ForumNairaland GeneralJobs/VacanciesI Dey Find Work (2757 Views)

1 2 Reply (Go Down)

I Dey Find Work by Lilpen3758(op): 11:27am On May 17, 2021
Make person find work for me nah
Anyhow e be I go run am
Life don Taya me like this
Find work for me make everywhere soft I go even come over to your location if you want me too
My number dey my signature
I Sabi do everything everything....
Re: I Dey Find Work by Nobody: 1:18pm On May 17, 2021
Me sef dey find work.
Cashier barman anyone abeg
Re: I Dey Find Work by Kola5281(m): 2:14pm On May 17, 2021
Omooo we plenty oo, me sef neva see work, na 3 month ago i serve finish sef. Abeg anyone wey fit employ me, i can do anything and i stay in Abuja
Re: I Dey Find Work by Lilpen3758(op): 2:22pm On May 17, 2021
slimkhalifa:
Me sef dey find work.
Cashier barman anyone abeg
oga go create your own thread na
No be money I use create this thread undecided
Re: I Dey Find Work by Lilpen3758(op): 2:25pm On May 17, 2021
Kola5281:
Omooo we plenty oo, me sef neva see work, na 3 month ago i serve finish sef. Abeg anyone wey fit employ me, i can do anything and i stay in Abuja
I think say na only me ooh dey way e dey do me for body ehh
Re: I Dey Find Work by Twelfthman: 3:30pm On May 17, 2021
Lol

Lilpen3758:
oga go create your own thread na
No be money I use create this thread undecided
Re: I Dey Find Work by Abubaka50(m): 4:17pm On May 17, 2021
Lilpen3758:
oga go create your own thread na
No be money I use create this thread undecided
Hahahahahaha
Re: I Dey Find Work by Lilpen3758(op): 4:33pm On May 17, 2021
Abubaka50:
Hahahahahaha
grin grin he wan steal my shine
Re: I Dey Find Work by Nobody: 5:59pm On May 17, 2021
Na wa o. Na like dis we go dey dey?
God epp us o.
Re: I Dey Find Work by Lilpen3758(op): 6:02pm On May 17, 2021
safesurfer:
Na wa o. Na like dis we go dey dey?
God epp us o.
Amen ooh brother angry angry
Re: I Dey Find Work by studM(m): 6:33pm On May 17, 2021
Lilpen3758:
Make person find work for me nah
Anyhow e be I go run am
Life don Taya me like this
Find work for me make everywhere soft I go even come over to your location if you want me too
My number dey my signature
I Sabi do everything everything....
u fit work as diesel generator maintenance guy for me?,call this number if u dey ikeja lagos,09070717819,ask after mr martins
Re: I Dey Find Work by studM(m): 6:35pm On May 17, 2021
slimkhalifa:
Me sef dey find work.
Cashier barman anyone abeg
Are u in Lagos ikeja?if yes,canbu do d job of cleaning and washing diesel generators from Monday to Saturday?,if yes call this number 09070717819,ask after Mr martins
Re: I Dey Find Work by Lilpen3758(op): 6:39pm On May 17, 2021
studM:
u fit work as diesel generator maintenance guy for me?,call this number if u dey ikeja lagos,09070717819,ask after mr martins
no be juju be that huh huh I no come dey lagos angry
Re: I Dey Find Work by studM(m): 6:40pm On May 17, 2021
Me I get work to offer any serious minded person wey dey leave for ikeja lagos,d person go dey clean generators for us from Monday to Saturday,and d pay na 25k per month,
Also I need person wey go dey help me supervise and manage d people wey dey come work wit us,our warehouse dey ikeja
U fit reachbus on 09070717819
Re: I Dey Find Work by studM(m): 6:56pm On May 17, 2021
Lilpen3758:
no be juju be that huh huh I no come dey lagos angry
Are u in lagos?where do u base?
Re: I Dey Find Work by studM(m): 6:59pm On May 17, 2021
Lilpen3758:
no be juju beat huh huh I no come dey lagos angry
sorry i can only work wit someone wey base for lag,ikeja precisley cuz of resumption amd closimg time,plus atimes we dey ge xtra tym for work if we busy dt tym
Re: I Dey Find Work by Lilpen3758(op): 7:00pm On May 17, 2021
studM:
Are u in lagos?where do u base?
am not in Lagos but I can come over but where man pikin go stay for some time?
Re: I Dey Find Work by Lilpen3758(op): 7:01pm On May 17, 2021
studM:
sorry i can only work wit someone wey base for lag,ikeja precisley cuz of resumption amd closimg time,plus atimes we dey ge xtra tym for work if we busy dt tym
I understand no be my luck embarassed
Re: I Dey Find Work by studM(m): 7:02pm On May 17, 2021
Lilpen3758:
am not in Lagos but I can come over but where man pikin go stay for some time?
Sorry I no get answer for dt,and i no fit promise u dt bro
Re: I Dey Find Work by Lilpen3758(op): 7:05pm On May 17, 2021
studM:
Sorry I no get answer for dt,and i no fit promise u dt bro
I understand man
Re: I Dey Find Work by Nobody:
I dey find work too, make una help me. If na money, I go buy (Electrical/Electronic Engineer)
Re: I Dey Find Work by Lilpen3758(op): 8:39pm On May 17, 2021
Mynd44 help us carry this thread to fp
We plenty way the find this work abeg
Re: I Dey Find Work by Nobody: 10:53pm On May 17, 2021
studM:
Me I get work to offer any serious minded person wey dey leave for ikeja lagos,d person go dey clean generators for us from Monday to Saturday,and d pay na 25k per month,
Also I need person wey go dey help me supervise and manage d people wey dey come work wit us,our warehouse dey ikeja
U fit reachbus on 09070717819
I dey live for PWD.Close to mm airport2.But I never hear of washing generator.Na pikin? Hope you dey pay on time?Most employer don form the habit of delaying salary of employees.They don't pay at month end any longer.
Re: I Dey Find Work by Nobody: 10:58pm On May 17, 2021
cassidy1996:
I dey find work too, make una help me. If na money, I go buy (Electrical/Electronic Engineer)
There was a vacancy thread I read 3 days ago.The Op said he was looking for someone who could do house wiring at Lekki,Lagos.
Re: I Dey Find Work by Nobody: 12:06am On May 18, 2021
Lilpen3758:
oga go create your own thread na
No be money I use create this thread undecided
Next time u go tell mod to vlban me
Re: I Dey Find Work by Lilpen3758(op): 12:36am On May 18, 2021
slimkhalifa:
Next time u go tell mod to vlban me
lolz grin grin
Re: I Dey Find Work by Nobody: 4:02am On May 18, 2021
Joysticks:
There was a vacancy thread I read 3 days ago.The Op said he was looking for someone who could do house wiring at Lekki,Lagos.
thanks, I tried searching for it, but didn't find anything
Re: I Dey Find Work by studM(m): 5:28am On May 18, 2021
Joysticks:
I dey live for PWD.Close to mm airport2.But I never hear of washing generator.Na pikin? Hope you dey pay on time?Most employer don form the habit of delaying salary of employees.They don't pay at month end any longer.
i do pay on time,and i pride myself on it d job is basically cleaming of diesel gens
Re: I Dey Find Work by cornelin(m): 8:02am On May 18, 2021
Anyone know of any part time job for me?
I can do electrical wiring and installation, work as a Personal Assistant, Supervisor, Private tutor (Science) etc. Infact any job at all.

Like a job that I basically won't be available for work once in every week. i.e I will take one day off every week.

I base in Ojo, Alaba. Thank you
Re: I Dey Find Work by Psalmspsalms: 8:50am On May 18, 2021
They go soon use person do rituals again. Make una shine eyes as una the search for this work o
Re: I Dey Find Work by fridayakpos: 9:23am On May 18, 2021
Am looking for job even if it's poultry farm attendance, I reside in ado ekiti
1 2 Reply

I Dey Find Work O, Even If Na Site Work As Labour With Daily Pay.You Dey Find Job? As You Grow Reach, You No Get Sense Say "Food Supplies" Na JobDo You Wonder How Someone Without Connections May Find Work In Nigeria234

Marketing Exec.vacancy, Lekki (Note: Applicants should reside on the LEKKI AXIS)Resume? An Excellent FormatJobs At Dogan's Sugar Limited (DSL)