If This Happens To You, What Will You Do. - Romance - Nairaland
Nairaland Forum › Nairaland General › Romance › If This Happens To You, What Will You Do. (890 Views)
| If This Happens To You, What Will You Do. by MiztaPepperoni(op): 11:54am On Jun 12, 2021 |
E get this babe I dey kolo for too much but the babe just dey form hard to get and church girl for me since oooo. I swear I really like the babe sha and I be get very good intentions to date her for real and build a long lasting relationship with her but she decide to follow one chance. Imagine say one of my main guy wey get serious relationship one side just tell me say him catch one babe him wan just chop clean mouth. Him beg me to use my house chop the babe and I be agree as na my real hommy from way back but as him show me the babe pictures for whatsapp the thing weak me die. I see say na this same babe wey I dey kolo too much for wey dey give me hard time even dey form holy holy and Virgin Mary my guy wan just chop clean mouth, and for my house for that matter. I swear as I dey so I no even know wethin to tell my guy or even the babe because them don arrange to get down tomorrow evening, una fit imagine. Abeg if na you this kind thing happen to, wethin you go do? |
| Re: If This Happens To You, What Will You Do. by OlayemiAshraf(m): 11:58am On Jun 12, 2021 |
I'll wait for her and my friend to come ...so we can party together ![]()
|
| Re: If This Happens To You, What Will You Do. by PrimeWatermark: 12:03pm On Jun 12, 2021 |
Lol How true is your story? ![]() |
| Re: If This Happens To You, What Will You Do. by kalu61(m): 12:23pm On Jun 12, 2021*. Modified: 12:41pm On Jun 12, 2021 |
Weti happen to your friends room? Confusion of ewulewu Witchcraft is blocking what you can't eat from another person eating it. Since your guy is smarter than you, allow him rub the shit on your face. |
| Re: If This Happens To You, What Will You Do. by MJBOLT: 12:25pm On Jun 12, 2021 |
is your house a brothel?? ![]() |
| Re: If This Happens To You, What Will You Do. by Cutehector(m): 12:35pm On Jun 12, 2021 |
I wonder how guys reason. The moment a male friend tells me that rubbish, i am so deleting his number from my phone. As in, you mad ni? You get liver dey ask me if you fit camp girl for my house? Onto which colorado weed you take ni.. |
| Re: If This Happens To You, What Will You Do. by MiztaPepperoni(op): 12:38pm On Jun 12, 2021 |
kalu61:Him get him serious babe for him house oooo And him no know say I know the babe because I no talk |
| Re: If This Happens To You, What Will You Do. by MiztaPepperoni(op): 12:40pm On Jun 12, 2021 |
Cutehector:Bros e be like say you no get correct friend wey una don run things well before. |
| Re: If This Happens To You, What Will You Do. by Cutehector(m): 12:44pm On Jun 12, 2021 |
MiztaPepperoni:he mad ni? |
| Re: If This Happens To You, What Will You Do. by bigcee(m): 1:46pm On Jun 12, 2021 |
Bro, no think am, na one of those things ![]() |
| Re: If This Happens To You, What Will You Do. by VlamesIffect(f): 2:16pm On Jun 12, 2021 |
Na wa. Bro before hoes. You see this life... Girl wey you dey die for..... another man wan lash am like say na nothing ![]() No stress urself untop woman isssue na so e be everywhere. |
| Re: If This Happens To You, What Will You Do. by youngblaq: 3:02pm On Jun 12, 2021 |
Haven't you heard the word "party" before? |
| Re: If This Happens To You, What Will You Do. by Nobody: 3:07pm On Jun 12, 2021 |
Bro-code bro. Just do it for the culture. E dey always happen no be today |
After 4years Of Tryin She Finally Says Yes. But This Happens! • I Lasted 6 Rounds On Her, And This Happens... • When You Take A Girl Out On A Date And This Happens • 2 • 3 • 4
I Never Knew We Had Matters To Deal With Until We Got Married • Are Nairaland Mods Trying To Have Sense Now? • ...


