Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,159,295 members, 7,839,456 topics. Date: Friday, 24 May 2024 at 07:30 PM

If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here - Business (4663) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Business / If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here (4827017 Views)

If You Are (uber/Taxify (bolt) e-hailing Partner In Port Harcourt, Come In. / If You Are Uber Partner In Abuja, Please Share Your Experience Here / See How To Register As An Uber Partner In Lagos Or Abuja (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (4660) (4661) (4662) (4663) (4664) (4665) (4666) ... (5711) (Reply) (Go Down)

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by GeneralKoko(m): 7:58am On May 05, 2022
I just got offered sex as payment this early morning. Why are Nigerian girls like this

5 Likes

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Glithronix: 8:05am On May 05, 2022
Una go see say I no dey talk about challenges, rude riders, rough periods, hoodlumic traits. grin
I know all of you bosses here know wetin I mean by all this cos you're all in the same field. grin
From fake alert, to rude small small girls and boys, talkative riders, bossy riders, olosho/runs girls, forming girls and boys, controllers, chairmen and chairwomen. Shrine boys, etc. How many I want talk finish self.
If I start to talk, the thing wey my eyes have seen you no go wait, my brother and sister you no go wait (panranran) grin

Furthermore, Lagos has a looooong way to go on infrastructure. Lagos roads are damnn bad mehn! angry
How can we have these roads everywhere in Lagos and be claiming city? angry
Annoying part is that of the speed bumps some streets and estates have, those bumps alone fit spoil your car legs. On top wetin now? Even if it's for security purposes, should bumps be that high ni? Even some local streets self dem creat those high bumps wey be say if your car no space up well of the ground, it will be brushing the under. angry
You will be taking some riders to their destination and have a smooth ride, when you're to enter their streets like this, you go vex say which kind road be this? angry
Bosses, I have shown a lot of hoodlumy to many riders oh. When I see a rider like this, I can quickly sense who you are, na from there I dey start display my hoodlumism so that you go know who carry you.
I've got 1% of bad behavior on my driver's profile. I know say ma some rude girls wey promised me 1 star be that cos when I dropped them (4 of them) at their destination, they begged me to take one of them back to main road - I showed dem stubbornness and maturity - dey come dey show me say I no fit help fine girl for just a ride to main road? Packaging wey I don see and chop tire na him una wan dey entice me with. I asked dem out the car say I don end una trip. Runs girls lol.
During the fasting period, my eyes see laps and breasts tire. embarassed
Runs girls too plenty for this Lagos.
Some guys wey dey form area, me no dey even send dem, my reactions alone dey make dem know say this one no send.
I go claim area gee for some guys from the beginning once I sense your type, make dem know say street don meet street. grin
Dropped 2 guys at airport, they did transfer, my spirit just say make I ensure alert first before I let dem go, money no enter after a wait of like 5mins, omoh, I follow dem drag say money no enter, dey later paid cash. During my waiting, those airport towing truck just came all of a sudden put chain for my tyre, ah, una dey craze? Na drop off I dey do, can't you see? The look I gave one of dem self, him gave me back, una dey craze.
One young guy I picked from Ojota side in the evening, he carried 2 small girls. One of dem enter front carry leg on top dashboard, I tell am my friend, carry that leg down and use your seatbelt, she obeyed sharp sharp - small girl come see as she open her market (tué). Na this guy did fake transfer when I dropped dem at Magodo. I tracked him back collect my money.
Some area for this Lagos no good for car. On top one road, bikes, keke napep, danfo, korope, trucks, dey drag space. I never see how person go drive on this Lagos roads wey dem no go kiss him bumper or body self. Even as a private and seldom car users, u go see scratch on the car sha ni. grin
How many I want talk self.
Film dey for this hustle and it's very interesting.
When you here bosses here say THIS HUSTLE NO BE FOR THE FAINT HEARTED PEOPLE, you go know when you get on the field.
Much respect, bosses.
How many I want talk self?

20 Likes

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Glithronix: 8:06am On May 05, 2022
GeneralKoko:
I just got offered sex as payment this early morning. Why are Nigerian girls like this
You go dey alright las las. grin grin grin
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Glithronix: 8:09am On May 05, 2022
How I wish say na me get the car I dey use for this hustle.
Wallahi, if I see anyone wey fit buy me a car for HP like this, I will appreciate.
Na car owners wey dey drive it themselves go enjoy this pilot work pass.
Though rental is not bad, cos na who no get car dey run rental.
Nothing beats you being the car owner and driving it yourself.
I go like join the car owners through HP - period of 18 - 24 months if I see oh. I won't mind.
Anyone to invest in me here, I go appreciate. Na business. Make una look my side, bosses.

4 Likes

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Springboot: 8:28am On May 05, 2022
Glithronix:
How I wish say na me get the car I dey use for this hustle.
Wallahi, if I see anyone wey fit buy me a car for HP like this, I will appreciate.
Na car owners wey dey drive it themselves go enjoy this pilot work pass.
Though rental is not bad, cos na who no get car dey run rental.
Nothing beats you being the car owner and driving it yourself.
I go like join the car owners through HP - period of 18 - 24 months if I see oh. I won't mind.
Anyone to invest in me here, I go appreciate. Na business. Make una look my side, bosses.

Please make an offer for a 2009 Toyota corolla.

1. State of residence
2. Total you can pay and how much you can remit monthly.

10 Likes

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by dlex21(m): 8:33am On May 05, 2022
Glithronix:
Una go see say I no dey talk about challenges, rude riders, rough periods, hoodlumic traits. grin
I know all of you bosses here know wetin I mean by all this cos you're all in the same field. grin
From fake alert, to rude small small girls and boys, talkative riders, bossy riders, olosho/runs girls, forming girls and boys, controllers, chairmen and chairwomen. Shrine boys, etc. How many I want talk finish self.
If I start to talk, the thing wey my eyes have seen you no go wait, my brother and sister you no go wait (panranran) grin

Furthermore, Lagos has a looooong way to go on infrastructure. Lagos roads are damnn bad mehn! angry
How can we have these roads everywhere in Lagos and be claiming city? angry
Annoying part is that of the speed bumps some streets and estates have, those bumps alone fit spoil your car legs. On top wetin now? Even if it's for security purposes, should bumps be that high ni? Even some local streets self dem creat those high bumps wey be say if your car no space up well of the ground, it will be brushing the under. angry
You will be taking some riders to their destination and have a smooth ride, when you're to enter their streets like this, you go vex say which kind road be this? angry
Bosses, I have shown a lot of hoodlumy to many riders oh. When I see a rider like this, I can quickly sense who you are, na from there I dey start display my hoodlumism so that you go know who carry you.
I've got 1% of bad behavior on my driver's profile. I know say ma some rude girls wey promised me 1 star be that cos when I dropped them (4 of them) at their destination, they begged me to take one of them back to main road - I showed dem stubbornness and maturity - dey come dey show me say I no fit help fine girl for just a ride to main road? Packaging wey I don see and chop tire na him una wan dey entice me with. I asked dem out the car say I don end una trip. Runs girls lol.
During the fasting period, my eyes see laps and breasts tire. embarassed
Runs girls too plenty for this Lagos.
Some guys wey dey form area, me no dey even send dem, my reactions alone dey make dem know say this one no send.
I go claim area gee for some guys from the beginning once I sense your type, make dem know say street don meet street. grin
Dropped 2 guys at airport, they did transfer, my spirit just say make I ensure alert first before I let dem go, money no enter after a wait of like 5mins, omoh, I follow dem drag say money no enter, dey later paid cash. During my waiting, those airport towing truck just came all of a sudden put chain for my tyre, ah, una dey craze? Na drop off I dey do, can't you see? The look I gave one of dem self, him gave me back, una dey craze.
One young guy I picked from Ojota side in the evening, he carried 2 small girls. One of dem enter front carry leg on top dashboard, I tell am my friend, carry that leg down and use your seatbelt, she obeyed sharp sharp - small girl come see as she open her market (tué). Na this guy did fake transfer when I dropped dem at Magodo. I tracked him back collect my money.
Some area for this Lagos no good for car. On top one road, bikes, keke napep, danfo, korope, trucks, dey drag space. I never see how person go drive on this Lagos roads wey dem no go kiss him bumper or body self. Even as a private and seldom car users, u go see scratch on the car sha ni. grin
How many I want talk self.
Film dey for this hustle and it's very interesting.
When you here bosses here say THIS HUSTLE NO BE FOR THE FAINT HEARTED PEOPLE, you go know when you get on the field.
Much respect, bosses.
How many I want talk self?

Omo! E con be like say no be the same work we dey do.

I can't relate to any of these oo...

All my rides so have have been easy-going save for one or two bossy ladies.

E be like say na for early mono and late night these experiences dey happen.

Take heart bro.

I pray you get your own ride soon so you can choose your working hours.

8 Likes

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Crvrider: 8:37am On May 05, 2022
GeneralKoko:
I just got offered sex as payment this early morning. Why are Nigerian girls like this

You wan use clitocurrency open market...hmmm! It is well.
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Glithronix: 8:44am On May 05, 2022
dlex21:


Omo! E con be like say no be the same work we dey do.

I can't relate to any of these oo...

All my rides so have have been easy-going save for one or two bossy ladies.

E be like say na for early mono and late night these experiences dey happen.

Take heart bro.

I pray you get your own ride soon so you can choose your working hours.
My 1st week was very smooth that I was asking myself why some guys dey complain of riders. My 1st week was calm and you could see it in me, I felt so cool. from 2nd week like this, I started to dey see. grin
Though it doesn't happen all the time. Just that there's no day you won't experience such. Na as dey drive dey go, dem go come meet you.
Yeah, some happened in the evening, cos I couldn't drive much during the day because of fasting. And I always watch out for surge.
Much respect, boss.

2 Likes

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Glithronix: 8:47am On May 05, 2022
Springboot:


Please make an offer for a 2009 Toyota corolla.

1. State of residence
2. Total you can pay and how much you can remit monthly.
How do I contact you?
However, I go prefer Camry 04 - 05 max.
I no wan go near Corolla embarassed . I don change my mind for Corolla and e get why.
I am based in Lagos.
Please how do I contact you, boss?
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Springboot: 8:56am On May 05, 2022
Glithronix:

How do I contact you?
However, I go prefer Camry 04 - 05 max.
I no wan go near Corolla embarassed . I don change my mind for Corolla and e get why.
I am based in Lagos.
Please how do I contact you, boss?

What's the point contacting me sir. I only told you what's available, if you prefer camry, I'll advice you stick with that.

10 Likes

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Fidex001(m): 9:22am On May 05, 2022
Nice tread, I would love to go I to this business but I don't have a car and I wouldn't want to drive, as a manager will be better, so, any advise, thanks.
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Lush100(m): 9:33am On May 05, 2022
Glithronix:
How I wish say na me get the car I dey use for this hustle.
Wallahi, if I see anyone wey fit buy me a car for HP like this, I will appreciate.
Na car owners wey dey drive it themselves go enjoy this pilot work pass.
Though rental is not bad, cos na who no get car dey run rental.
Nothing beats you being the car owner and driving it yourself.
I go like join the car owners through HP - period of 18 - 24 months if I see oh. I won't mind.
Anyone to invest in me here, I go appreciate. Na business. Make una look my side, bosses.
.
Nigerian used or Toks.
Una dey form saint now oh,
If I drop dough now,u go fit dey behave like those fake riders?!!

3 Likes

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by drmikeadams(m): 9:58am On May 05, 2022
dlex21:


Omo! E con be like say no be the same work we dey do.

I can't relate to any of these oo...

All my rides so have have been easy-going save for one or two bossy ladies.

E be like say na for early mono and late night these experiences dey happen.

Take heart bro.

I pray you get your own ride soon so you can choose your working hours.



Lol u go still meet them..na matter of time.
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by repairpalng: 10:06am On May 05, 2022
available
repairpalng:
NO DOWNTIME WITH YOUR PHONE ON UBER/BOLT: CONTACT US TO FIX YOUR PHONES (WE FIX ALL MODELS).... 08137013426...


Samsung, Xiaomi, Huawei, Oukitel, Umidigi, Oukitel: WE FIX ANY PHONE ISSUE
/

Samsung S6 Follow Screen Replacement Wt Fixing (18K)....

Samsung S6 Edge Follow Screen Replacement Wt Fixing (20K) ,

Samsung S7 Follow Screen Replacement Wt Fixing (24K);,

Samsung S7 Edge Follow Screen Replacement Wt Fixing (22K)''

Samsung S8+ PLUS Follow Come Screen Replacement Wt Fixing (38K),,

Samsung S8 Follow Come Screen Replacement Wt Fixing (32K),

Samsung S9 Follow Screen Replacement Wt Fixing (35K) - Wt Black Frame***

Samsung S9+ Plus Follow Screen Replacement Wt Fixing (45K) - Wt Purple Frame

Samsung S10 Follow Screen Replacement Wt Fixing (55K)

Samsung Note 8 Follow Screen Replacement Wt Fixing (40K) - Wt Purple Frame


[/b]

Follow come used screens but with slight dots (DOT DOES NOT SPREAD AND SCREEN WORKS PERFECTLY)!!!!

Best market deals wt professionalism in fixing.

08137013426.

also avaiable S9, S9+, S10, NOTE 8, NOTE 9 ETC...

We also fix other
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Felicity0001: 10:21am On May 05, 2022
Springboot:


Please make an offer for a 2009 Toyota corolla.

1. State of residence
2. Total you can pay and how much you can remit monthly.

My Oga won buy that him colleague Corollagrin bad guy! I like people like you who sees opportunity in everything7

This is my spirit

2 Likes

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Glithronix: 10:21am On May 05, 2022
Lush100:
.
Nigerian used or Toks.
Una dey form saint now oh,
If I drop dough now,u go fit dey behave like those fake riders?!!
Toks, boss.
Boss, I am a person of integrity. How can we talk?
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Glithronix: 10:25am On May 05, 2022
Springboot:


What's the point contacting me sir. I only told you what's available, if you prefer camry, I'll advice you stick with that.
Okay, boss.
Much respect. ✌
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Lush100(m): 10:31am On May 05, 2022
Glithronix:

Toks, boss.
Boss, I am a person of integrity. How can we talk?
Bro,
I still dey reason this matter until I dey convinced.

2 Likes

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Pearl1910: 10:49am On May 05, 2022
mejai:

House AC for car? Wahala no dey finish

U go fear fear grin grin grin
As him AC dey give am problems na...
Nothing person no go see for this thread

1 Like

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Glithronix: 10:53am On May 05, 2022
Lush100:

Bro,
I still dey reason this matter until I dey convinced.
Boss, whatever requirements, procedures and panel you want to set to convince you, I'm ready and available to provide, boss.
Car will definitely be in your name all through the papers until I finish payment.
What other convictions are required, boss?
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Pearl1910: 10:54am On May 05, 2022
OmodavidoX:
Finally changed to tokunbo engine today

It is today that i finally know that engine is the life of any vehicle.

My car that vibrates on idle, does limp mode and very sluggish on the road, consume 1 and half litres per day, goes off and force itself to move when AC is placed on high etc, the car is now sound

Omo. I was driving it today and I was happy.

No vibrations, rough idle etc.

I thank God for the success

Thank God u got a good one.
Now U have a new car as it were. Make sure u adhere to factory specifications. No connect fan direct, no jump wires up and down. Don't listen to kazeem hook line and syncline, do ur own research and maintain your engine.
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by ShitStain(m): 10:59am On May 05, 2022
Hello drivers, please I have a question.
Is it possible to use an SUV for Uber/bolt?
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Pearl1910: 11:17am On May 05, 2022
GeneralKoko:
I just got offered sex as payment this early morning. Why are Nigerian girls like this
How she take talk am? grin

6 Likes

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Lush100(m): 11:25am On May 05, 2022
Pearl1910:

How she take talk am? grin
.

@GeneralKoko,
Please tell us,
We are interested in how she talk am.
First time the house is not on vow-lense mode.
I can imagine @generalkoko doing like this.

She be like " a whole general"

2 Likes

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by surebona(m): 11:49am On May 05, 2022
Good morning house, been a bolt driver for a year plus now, but was using a friend's car who wasn't around but he is back in town had to give his car back for his office runs ..
I reside in Lagos and interested in either a rented car or a HP... Please help a brother out. Thanks. 07032073693

1 Like

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Pearl1910: 12:01pm On May 05, 2022
Springboot:


Please make an offer for a 2009 Toyota corolla.

1. State of residence
2. Total you can pay and how much you can remit monthly.

Toks or Nigerian used?
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Glithronix: 12:22pm On May 05, 2022
Which better station I go see this oil, bosses?
I've read some people recommending particular stations for oil, but want to know the latest. And how much for this?
Much respect, bosses.

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Glithronix: 12:25pm On May 05, 2022
Pearl1910:


U go fear fear grin grin grin
As him AC dey give am problems na...
Nothing person no go see for this thread
grin grin grin
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Springboot: 12:29pm On May 05, 2022
Pearl1910:


Toks or Nigerian used?

Bought Toks, It was registered in January this year, he's my junior colleague so I'm familiar with his routine, car only drives from home to office and back, because he's in tech dept and they travel alot, most of the times car is parked here in the office.

So to answer your question as it is, it's "Nigerian used"

1 Like

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by northbird: 12:30pm On May 05, 2022
OmodavidoX:
Finally changed to tokunbo engine today

It is today that i finally know that engine is the life of any vehicle.

My car that vibrates on idle, does limp mode and very sluggish on the road, consume 1 and half litres per day, goes off and force itself to move when AC is placed on high etc, the car is now sound

Omo. I was driving it today and I was happy.

No vibrations, rough idle etc.

I thank God for the success
Good one.
Tokunbo from container or which type.., , how much?

1 Like

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by lanrexdo(m): 12:41pm On May 05, 2022
Interested
Springboot:


Please make an offer for a 2009 Toyota corolla.

1. State of residence
2. Total you can pay and how much you can remit monthly.
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by northbird: 12:44pm On May 05, 2022
@ glithronix, 5w30 is synthetic oil. Few partners use synthetic oil for servicing the car. So confirm from your partner if he has been using 5w30....

From what I gathered, it's best practice to stick with the oil you have been using previously ( even if it's not the manufacturer specificied 5w30 VS 20w50.)

3 Likes

(1) (2) (3) ... (4660) (4661) (4662) (4663) (4664) (4665) (4666) ... (5711) (Reply)

Football (+Other Sports) Betting Season 12 / ➜ ➜ ➜Currency/E-currency Market Deals➜ ➜ ➜ / Bankers For Baba-Ijebu (Premier-Lotto).

Viewing this topic: 3 guest(s)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 68
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.