Hard Lessons I Learned In 2025 About Overdoing Things For People - Romance - Nairaland
Nairaland Forum › Nairaland General › Romance › Hard Lessons I Learned In 2025 About Overdoing Things For People (778 Views)
| Hard Lessons I Learned In 2025 About Overdoing Things For People by Ajiswaggs(op): 5:43pm On Dec 13, 2025 |
Good day my people. Make I share my own 2025 experience. If e help one person here, I go glad. 1. The Day I Reduced Friends, Everywhere Silent From the beginning of 2025, I reduce my friends. I notice say na only me dey always call, check up, buy things, and show concern. The day I stop calling, everywhere quiet. Nobody check on me again. The only time some of them go remember me na when dem need something. Once nothing to gain, I no matter. Na there I thank God say e show me who really be who. 2. Wedding Matter Expose People I dey plan my wedding for January next year. I tell friends wey I really consider close, even people wey I wan make dem be my groomsmen. Up till now, none of them don drop even ₦1. Funny enough, people wey no close to me don already contribute. Even some family members and cousins dey give excuse. From here I learn say sometimes help no dey come from people wey near you, na from outsiders e dey come. 3. Overdoing Good for Compound Turn Against Me For my compound, anytime light spoil, na me dey call electrician and pay with my own money. I no dey collect contribution. If light no dey, I go bring my generator make people pump water, even though others get generator but dem go keep am. I do all these willingly. But when dem say make everybody contribute money for cleaning surroundings, I talk say I no fit contribute this time and make others also handle things. Na from there dem change. Dem come dey say: “We no send you before.” Na there I understand say if you overdo for people, dem go take am as entitlement, not kindness. 4. Office Own Still Be Same Story For workplace, na the same thing. As long as you dey give free things and favors, you’re a good person. Once you stop, dem go label you proud, wicked, or say you don change. 5. I Learnt Not to Force Love or Impress Anybody Another strong lesson be say: no force anything, especially love. Before, I dey chase women, dey beg, dey try impress. I go dey talk say I want marry you, I love you, I serious. What happen? Dem dey use me. Some go collect transport money. Some go make me beg make dem come visit me. I go dey force connection wey no dey natural. The day I stop all those nonsense, everything change. I stop chasing. I stop begging. I stop trying to impress. Na that same time I notice say women begin look for me. Dem dey call me, dey want see me, dey want spend weekend with me—without me begging or sending transport money. Na there I know say life no hard reach like that. People wey really like you no go stress you. You no go force connection. Anything wey go be, go be. Final Lessons 2025 Taught Me • No be everybody wey smile with you dey for you • Too much kindness without boundary dey dangerous • People go forget all your yes, but remember one no • Chasing too much reduces your value • Right people no go stress you From now on, I go help with sense, not emotions. I go love naturally, not forcefully. |
| Re: Hard Lessons I Learned In 2025 About Overdoing Things For People by mekus15: 6:39pm On Dec 13, 2025 |
Great lessons. Thanks for sharing, bro. |
| Re: Hard Lessons I Learned In 2025 About Overdoing Things For People by Revealer3: 6:52pm On Dec 13, 2025 |
Ajiswaggs:I don't mean to disrespect you,how old are you. These are the things in life, you cannot avoid them, You can only reduce it. Don't do something for someone, what he or she can do for himself,be moderate Choose your friends don't allow them to choose you. Stop being available for everyone . |
| Re: Hard Lessons I Learned In 2025 About Overdoing Things For People by Cerebellum: 10:53pm On Dec 13, 2025 |
You really have a long long way to go |
| Re: Hard Lessons I Learned In 2025 About Overdoing Things For People by pansophist(m): 11:43pm On Dec 13, 2025*. Modified: 12:05am On Dec 14, 2025 |
You suppose know that one guy wey just dey live him own jejely. Either for one room, or self-contain. Go work and return and hardly talk to people. Them fit shoot gun outside and he no go come out. He really no send like that. “Please leave me alone”, that’s his motto. Very soon, you sef go be like that. If you no be like that, you truly no like peace. Such lifestyle is not loneliness, it’s solitude. And any man wey no like solitude no truly like freedom. Because this life, you’re truly on your own. Na when you need help, you go know say you lonely
|
| Re: Hard Lessons I Learned In 2025 About Overdoing Things For People by Kaczynski: 12:45am On Dec 14, 2025 |
in the end you only have just you and yourself. theres a reason why you die alone not with with your wife or child. alone , buried underneath to be eaten by slimy worms. |
| Re: Hard Lessons I Learned In 2025 About Overdoing Things For People by ManknowThyself(m): 3:46am On Dec 14, 2025 |
Life is short, but life is no life without knowledge!!!!!!! You learnt some good life lessons. As someone said above, solitude gives clarity and clarity is freedom. Freedom gives happiness and only true happiness is life. As a man your happiness comes from inside, not from external validation. In everything you do as an empathy, use discernment of your intuition with firm boundaries. Any attempt na red card, direct the kindness to a stranger you don’t even know. |
| Re: Hard Lessons I Learned In 2025 About Overdoing Things For People by Nobody: 4:43am On Dec 14, 2025 |
Ajiswaggs:Drop this mentality. Nobody owes you shit. Else, you will still write another epistle on it. |
No Matter How Deep You Love A Lady, Never Do These Five Things For Her • Hard Lessons I Got From A Friend's Messy Break Up. • Few Hard Lessons I Have Learnt About Love. • 2 • 3 • 4
Should I Still Ask Her Out? • What Do U Want In Ur Date? • It's Not What You Think.