Tufiakwa!!!! I Nor Go Ever Thief Government Money - Politics - Nairaland
Nairaland Forum › Nairaland General › Politics › Tufiakwa!!!! I Nor Go Ever Thief Government Money (826 Views)
| Tufiakwa!!!! I Nor Go Ever Thief Government Money by AKPOSbaba(op): 12:06pm On Feb 04, 2015 |
Di man wey go bicom di second in command for naija just incase General Muhammadu Buhari win next weekend presidential election,Profesor Yemi Osinbajo don say,if you no go believe am for anytin at all make u believe am for only one tin. He say if he bicom di vice president,he can neva touch government money. He say if dem like make dem givam Central Bank key,lai lai,im no go touch govment kobo. He yarn all dis one yestaday on top twitter. He say him don enta agreement wit Baba God say im no go tiff govment money bifor and afta. Many pipo go say na lie lawyas take dey chop why many pipo ready to biliv all dis kain talk if na pastor talk am. READ MORE>>>>>http://ogakpatakpata..com/2015/02/osinbajo-don-pledge-to-god-not-to-thief.html |
| Re: Tufiakwa!!!! I Nor Go Ever Thief Government Money by kestolove95(m): 12:12pm On Feb 04, 2015 |
oga u get masters for pedgin ne |
| Re: Tufiakwa!!!! I Nor Go Ever Thief Government Money by MichaelSokoto(m): 12:31pm On Feb 04, 2015 |
Click "like" 4 GEJ/Samboribobo Click "share" 4 GMB/Prof ![]() |
| Re: Tufiakwa!!!! I Nor Go Ever Thief Government Money by IGBOSON1: 12:36pm On Feb 04, 2015 |
kestolove95:^^^He must be from Warri or Port Harcourt......na dem sabi talk pidgin well well! |
| Re: Tufiakwa!!!! I Nor Go Ever Thief Government Money by kestolove95(m): 12:51pm On Feb 04, 2015 |
IGBOSON1:the news swit. die |
| Re: Tufiakwa!!!! I Nor Go Ever Thief Government Money by temitemi1(m): 1:00pm On Feb 04, 2015 |
Tell am sey na lie him dey lie unless if tinubu no dey alive again ... GEJ till 2019!!! |
| Re: Tufiakwa!!!! I Nor Go Ever Thief Government Money by AKPOSbaba(op): 1:26pm On Feb 04, 2015 |
IGBOSON1:Baba yor head dey dia.Warri nor dey carry last,kpatakpata na draw. Pidgin inglish na di first language of over 100 million nigerians,so i dey hear full time to serve una our language. Abeg make una suport di ministry and click like for di link for bottom here: https://www.facebook.com/ogakpatakpata?ref=bookmarks |
| Re: Tufiakwa!!!! I Nor Go Ever Thief Government Money by AKPOSbaba(op): 1:27pm On Feb 04, 2015 |
kestolove95:lol. tanks baba |
| Re: Tufiakwa!!!! I Nor Go Ever Thief Government Money by AKPOSbaba(op): 1:29pm On Feb 04, 2015 |
kestolove95:tanks my guy.u too much,God bless u plenti |
Nigerian Embassy In New York: Tufiakwa! A Festering Boil Oozing With Pus • Jonathan Ke?? Tufiakwa • First Ladies Don’t Spend Government Money – Jonathan • 2 • 3 • 4
Ambode Calls Agbaje in Intern. • How Obanikoro, Fayose, Chris Uba And Brig. General Momoh Rigged Ekiti Governorsh • Soludo And His Missing Trillions
