Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,158,214 members, 7,836,037 topics. Date: Tuesday, 21 May 2024 at 07:36 PM

****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** - TV/Movies - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / TV/Movies / ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** (2831 Views)

Another Veteran Yoruba Actor Bids 9ja Entertainment Industry Farewell! / Comedy Wey Dey Burst Brain.... This Is So Funny / ****Oyinbo Princess - Loves 9ja**** (2) (3) (4)

(1) (2) (Reply) (Go Down)

****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by OyinboPrincess(f): 8:21pm On Feb 05, 2015
I hail u ooo...

Na Oyinbo I b ooo - wey get HUGE passion for 9ja - nor b just the culture & food, but na the Pidgin English wey sweet me well well.

Dis Oyinbo sabi ooo! I wan step out into the entertainment business... to give back to the community wey fill my heart. U knw say nor easy to get from A-B so na followers I seek in the first instance - helping my name circulate.

Radio stations and magazines don already show interest and I hope say soon I go enter one contract or another. Currently I dey write one song with a friend known as Dezign - an upcoming artist in 9ja.

I don dey for Twitter and Facebook - Oyinbo Princess - My videos also dey ontop YouTube!


https://www.youtube.com/watch?v=n_9duq4FYac


https://www.youtube.com/watch?v=BBgqv_DEDJ0


https://www.youtube.com/watch?v=-GPZAgV3kx0

Abeg if una get small time, make una visit my site, I wan travel show for 9ja - full story on the below link:

gofundme.com/lisf1c

Happy watching & following, thank you for your time ooo!!!

3 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by Nobody: 8:27pm On Feb 05, 2015
Hilarious
Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by pinkycute(f): 8:27pm On Feb 05, 2015
******Interesting***** undecided
Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by CrazyScientist: 8:40pm On Feb 05, 2015
Joke of the month! grin
Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by OyinboPrincess(f): 9:05pm On Feb 05, 2015
Peeps.... nor b joke ooo - U go see am soon sha
Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by Prodeegee(m): 10:31pm On Feb 05, 2015
OyinboPrincess:
Peeps.... nor b joke ooo - U go see am soon sha

Babe wassup?

It's no joke. Shez stormin naija soonest

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by OyinboPrincess(f): 10:34pm On Feb 05, 2015
@Prodeegee - omo baba nor b small ooo - see these ones wey disbelieve grin I just go laugh until I don enter 9ja self.... make we Skype tomorrow morning sha... I go dey house. I hail u oooo kiss

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by Prodeegee(m): 10:52pm On Feb 05, 2015
OyinboPrincess:
@Prodeegee - omo baba nor b small ooo - see these ones wey disbelieve grin I just go laugh until I don enter 9ja self.... make we Skype tomorrow morning sha... I go dey house. I hail u oooo kiss

No shii... I bn comot today go buy some dog stuffs. Talk to yu tomorrow. kiss

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by parrotibaba(m): 12:10am On Feb 06, 2015
kai!!! grin grin so dis gal can blow pidgin English? grin
Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by parrotibaba(m): 12:24am On Feb 06, 2015
...Anyways I'm more interested in how u learnt d pidgin English ,e no de easy to learn grin
Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by prof800(m): 8:44am On Feb 06, 2015
OyinboPrincess?
...dey speak Pidgin English?
Wow!
Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by OyinboPrincess(f): 12:03pm On Feb 06, 2015
@parrotibaba - na so my bro... e don sweet me as I blow am self!!! E don hook me like a fish in the sea jare... nor b small grin as for the learning, na mind mata - u knw say if u apply am u go succeed tongue

@prof800 - na Oyinbo Princess ooo - nor b lie, na true I dey talk... sebi u don see my video abi?! Ose oooooo smiley

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by parrotibaba(m): 12:35pm On Feb 06, 2015
OyinboPrincess:
@parrotibaba - na so my bro... e don sweet me as I blow am self!!! E don hook me like a fish in the sea jare... nor b small grin as for the learning, na mind mata - u knw say if u apply am u go succeed tongue

@prof800 - na Oyinbo Princess ooo - nor b lie, na true I dey talk... sebi u don see my video abi?! Ose oooooo smiley
OK grin but take am easy d blow d pidgin ,have a nice day

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by prof800(m): 12:43pm On Feb 06, 2015
OyinboPrincess:

@prof800 - na Oyinbo Princess ooo - nor b lie, na true I dey talk... sebi u don see my video abi?! Ose oooooo smiley

na so jare...
i don see one of your videos....d thing funny die... you dey speak pidgin with tu.sh British accent.... and I dey admire your command of pidgin grammar.

Dey there dey enjoy. wink
Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by Nobody: 12:56pm On Feb 06, 2015
Wow, You sabi speak pidgin pass me and I be Nigerian. I hail oh.
Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by OyinboPrincess(f): 1:32pm On Feb 06, 2015
@prof800 - ose baba, nothing do u smiley happy say u don watch am... so all the NON-BELIEVERS out there... make I see wetin they wan yarn na, if una get twitter u for follow me oo - I go follow back

@koice - na sabi b they key ooo guy, I know say ur Pidgin bam lol, Mr 9ja

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by jargonzboi(m): 3:02pm On Feb 06, 2015
omo see oyinbo chickala wey dey chop pigdin for mouth.
...omo mehn i dey feel proud, walahi...!

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by Prodeegee(m): 3:41pm On Feb 06, 2015
OyinboPrincess:
@prof800 - ose baba, nothing do u smiley happy say u don watch am... so all the NON-BELIEVERS out there... make I see wetin they wan yarn na, if una get twitter u for follow me oo - I go follow back

@koice - na sabi b they key ooo guy, I know say ur Pidgin bam lol, Mr 9ja

madam...skype o

2 Likes

Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by OyinboPrincess(f): 5:25pm On Feb 06, 2015
@jargonzboi - na confirm Oyinbo chickala oooo - but e b lyk say 9ja don flow for my blood well well cheesy ose for the proudness padi mi

@Prodeegee - I don wait tire ooo, why u dey put am fr loooong thing na na wa ooo grin

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by Tolzeal(m): 4:30pm On Feb 07, 2015
OyinboPrincess:
@jargonzboi - na confirm Oyinbo chickala oooo - but e b lyk say 9ja don flow for my blood well well cheesy ose for the proudness padi mi

@Prodeegee - I don wait tire ooo, why u dey put am fr loooong thing na na wa ooo grin






mehn...i Cant stop laughing... cheesy cheesy cheesy
Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by OyinboPrincess(f): 7:22pm On Feb 07, 2015
@Tolzeal - nor laugh scata ooo baba grin make una watch my video, that one na die lol
Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by CHARLOE(m): 12:36am On Feb 08, 2015
@ oyinboprincess, hw far na, i just dey gbadun u! abeg who teach u pidgin, u get naija bf? u nid to com show 4 naija, u go blow!

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by OyinboPrincess(f): 12:24pm On Feb 08, 2015
@CHARLOE - I bam ooo baba - hw ur side?? I just dey lyk the sound of Pidgin sha, e b lyk say na mind mata, if u wan learn am, na commitment and dedication go do am grin I go soon show for 9ja baba, u knw say 9ja entertainment pass UK by far oo!! Abeg, may u follow me for twitter na, we fit yarn there wella... OSE

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by Zaha(m): 2:17pm On Feb 10, 2015
Wow
Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by OyinboPrincess(f): 6:42pm On Feb 10, 2015
@Zaha - ose baba... lol... e never reach wow factor ooo grin

Peeps - I don get new video ooo - na YouTube you go see am:
https://www.youtube.com/watch?v=Pd7BpYpz7t4&feature=youtu.be
Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by missdebs(f): 2:45am On Feb 12, 2015
mehn ds is serious o, wishing u goodluck

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by idu1(m): 10:01am On Feb 12, 2015
cheesy

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by Nutase: 10:37am On Feb 12, 2015
money no plenty for naija. stay for ur country o.

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by frainc(m): 12:24pm On Feb 12, 2015
Oyinbo, wetin bi ur twitter handle?
Me too na artist for lag
I go like to yan with u
My twitter handle na @frcbaba1
And my mail na frc4us@rocketmail.com

Make we yan na

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by irepnaija4eva(m): 12:47pm On Feb 12, 2015
my God,babe u just make me shine teeth today,anyway well done.
wish u loads of success.

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by irepnaija4eva(m): 12:48pm On Feb 12, 2015
my God,babe u just make me shine teeth today,anyway well done.
wishing u loads of success.

1 Like

Re: ****Oyinbo Wey Wan Enter 9ja - Entertainment**** by OyinboPrincess(f): 1:24pm On Feb 12, 2015
@missdebs - ose ooo *chop knuckle* grin

@idu1 - wink

@Nutase - abegieee leave am joor - na 9ja I go come na... 9ja na my PaSsIoN self!! Wen 9ja artists com enter London, na so we d hail am ooo - so u nor fit hail person wey wan com entertain for ur side, na wa oooooooooo shocked sad

@frainc - na @OyinboPrincess b my handle oOo - make una come find me smiley

@irepnaija4eva - loool shine teeth ooo - dat one good pass, ose 4 ur comment ooOOoo smiley

(1) (2) (Reply)

The Johnson's Soundtrack Needed / Watch The Trailer Of 300 (part 2) / Korean Drama Lovers Quiz Corner. Give Correct Answers And Win A Prize!!!

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 28
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.