₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,325,298 members, 8,421,218 topics. Date: Saturday, 06 June 2026 at 01:42 AM

Toggle theme

Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland ForumEntertainmentJokes EtcHilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations (2909 Views)

1 Reply (Go Down)

Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by victorVIC1(op): 8:48pm On Feb 13, 2015
Man wey naked no dey put hand for pocket
Translation: You can’t do something if there are no
certain conditions in place.
Chicken wey run away from borno go Ibadan go still end
up inside pot of soup
Translation: You Can’t Run Away From Your
Destiny
Today’s newspaper na tomorrow Suya wrap
Translation: Keep calm! Nothing last forever
Cow wey dey in a hurry to go America go come back as
corn beef
Translation:Just be patient. Let the game come to you.
Don’t rush!
Akara and moin moin get the same parent, na wetin dey
pass tru make dem diffrent
Translation: How you start doesn’t matter,what matters
is how you finish.
Wetin concern agbero with twitter handle,or malu with
face cap?
Translation: Mind your business.
If life dey show you pepper,my guy make pepper soup
Translation: Make something good out of a bad
experience
I get am before No be property
Translation: stop living in the past and start living in the
present.
If person too tey for party e go follow dem wash plate
Translation: Don’t overstay your welcome
Rolling stone,of course na person push am now!
Translation: There is always a reason for
something
Craze no hard to form,na the trekking be wahala
Translation: Easier said than done
No matter how hot your tempa be,e no fit boil beans.
Translation:Calm down,your temper won’t
solve the problem
Every mallam with im own kettle,every aboki with im own
radio.
Translation: Every man for himself
You no need cutlery to chop slap
Translation: You don’t need my translation to understand
this,lol
Opolo eye no be open eye
Translation: Having Big eyes doesn’t make
you civilised,lol
Leave matter for Mathias and Sabi for Sabinus.
Translation: let sleeping dog lie
Bring suya, bring suya.na cow body dey suffer am.
Translation: Every action has a consequence
E go better,e go better,na im make ibo man still dey
Kano
Translation: When there is hope,there is Life.
Escort me, Escort me, na im slave trade take start.
Translation: Serious things sometimes start like a joke
Na from play play dem dey form PLAYER
Translation:Serious things sometimes start like a joke
Pikin wen use agbada take start guy go talk wetin e go
wear wen e old.
Translation:Slow and steady wins the race
The water wey dem use take make eba can never be
recovered back.
Translation:Don’t cry over spilt milk
Nearly no dey kill bird.
Translation:It’s either you have it or you don’t
Fly wey no get special adviser na im dey follow dead
bodi enta grave
Translation:Don’t stay ignorant
No matter how lizard dey do press up, e no go get chest
like aligator
Translation:Be proud of who you are
The cassava today fit be gari tomorrow
Translation:No condition is permanent
If mad man don beat ur friend before,if him see
mechanic he go run…
Translation:once beaten twice shy
Jollof Rice wey dey for d bottom of pot 2day go dey for
top of cooler 2moro
Translation:no condition is permanent
Fowl wey dem carry for head no dey know say to waka
na work.
Translation:A dependant would not know the value of
what he/she is enjoying.
Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by otbliz(m): 8:59pm On Feb 13, 2015
Nice....

But u no sabi copy?
victorVIC1:
know the value of
what he/she is enjoying.
17 mins · Public
That na facebook signature
Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by victorVIC1(op):
otbliz:
Nice....

But u no sabi copy?
That na facebook signature
Lol...post already edited
Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by okpamson15(m): 9:51pm On Feb 13, 2015
Aso rock na 8 8years. Translation: leave Gej make him finish him tenure
Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by victorVIC1(op): 7:05am On Feb 14, 2015
okpamson15:
Aso rock na 8 8years. Translation: leave Gej make him finish him tenure
hehehe... U go fear quote o.
Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by fctguy: 10:29am On Feb 14, 2015
Very funny but informative thanks
Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by TaeKEa5: 9:29pm On Feb 26, 2015
yes wrong...
Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by kuuljay(m): 12:08pm On Feb 27, 2015
No mata how small kpekus wata small e dey rish jontomos take baff.somebody translate
Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by victorVIC1(op): 12:19pm On Feb 27, 2015
fctguy:
Very funny but informative thanks
Tanx man
Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by victorVIC1(op): 12:19pm On Feb 27, 2015
TaeKEa5:
yes wrong...
?
Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by victorVIC1(op): 12:22pm On Feb 27, 2015
kuuljay:
No mata how small kpekus wata small e dey rish jontomos take baff.somebody translate
grin How person want take translate wetin him no understand?
Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by kuuljay(m): 7:47pm On Feb 27, 2015
victorVIC1:
grin How person want take translate wetin him no understand?
komot for road,i knw say you understand.you yus dey form good boy there
Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by victorVIC1(op): 8:53am On Feb 28, 2015
kuuljay:
komot for road,i knw say you understand.you yus dey form good boy there
Abeg, who be jontomos?Abi na Mr Ibu surname be dat?
Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by njuwo(m): 10:23am On Feb 28, 2015
victorVIC1:
Abeg, who be jontomos?Abi na Mr Ibu surname be dat?
Jontomos na your brother wey dey in between your leg.
Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by njuwo(m): 10:25am On Feb 28, 2015
kuuljay:
No mata how small kpekus wata small e dey rish jontomos take baff.somebody translate
No matter how life suffer you reach you go still make am.
Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by kuuljay(m): 8:00am On Mar 01, 2015
victorVIC1:
Abeg, who be jontomos?Abi na Mr Ibu surname be dat?
prick nahh
Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by kuuljay(m): 8:00am On Mar 01, 2015
njuwo:
No matter how life suffer you reach you go still make am.
you try my brother
1 Reply

Americans React To This Hilarious Nigerian Name15 Most Hilarious Nigerian Starter PacksFunny Nigerian Pidgin Proverbs And Their Loose Translations ...234

Let's Play A Game Peeps.Very Funny African SongWhy Did U Wear Dat