Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations - Jokes Etc - Nairaland
Nairaland Forum › Entertainment › Jokes Etc › Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations (2910 Views)
| Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by victorVIC1(op): 8:48pm On Feb 13, 2015 |
Man wey naked no dey put hand for pocket Translation: You can’t do something if there are no certain conditions in place. Chicken wey run away from borno go Ibadan go still end up inside pot of soup Translation: You Can’t Run Away From Your Destiny Today’s newspaper na tomorrow Suya wrap Translation: Keep calm! Nothing last forever Cow wey dey in a hurry to go America go come back as corn beef Translation:Just be patient. Let the game come to you. Don’t rush! Akara and moin moin get the same parent, na wetin dey pass tru make dem diffrent Translation: How you start doesn’t matter,what matters is how you finish. Wetin concern agbero with twitter handle,or malu with face cap? Translation: Mind your business. If life dey show you pepper,my guy make pepper soup Translation: Make something good out of a bad experience I get am before No be property Translation: stop living in the past and start living in the present. If person too tey for party e go follow dem wash plate Translation: Don’t overstay your welcome Rolling stone,of course na person push am now! Translation: There is always a reason for something Craze no hard to form,na the trekking be wahala Translation: Easier said than done No matter how hot your tempa be,e no fit boil beans. Translation:Calm down,your temper won’t solve the problem Every mallam with im own kettle,every aboki with im own radio. Translation: Every man for himself You no need cutlery to chop slap Translation: You don’t need my translation to understand this,lol Opolo eye no be open eye Translation: Having Big eyes doesn’t make you civilised,lol Leave matter for Mathias and Sabi for Sabinus. Translation: let sleeping dog lie Bring suya, bring suya.na cow body dey suffer am. Translation: Every action has a consequence E go better,e go better,na im make ibo man still dey Kano Translation: When there is hope,there is Life. Escort me, Escort me, na im slave trade take start. Translation: Serious things sometimes start like a joke Na from play play dem dey form PLAYER Translation:Serious things sometimes start like a joke Pikin wen use agbada take start guy go talk wetin e go wear wen e old. Translation:Slow and steady wins the race The water wey dem use take make eba can never be recovered back. Translation:Don’t cry over spilt milk Nearly no dey kill bird. Translation:It’s either you have it or you don’t Fly wey no get special adviser na im dey follow dead bodi enta grave Translation:Don’t stay ignorant No matter how lizard dey do press up, e no go get chest like aligator Translation:Be proud of who you are The cassava today fit be gari tomorrow Translation:No condition is permanent If mad man don beat ur friend before,if him see mechanic he go run… Translation:once beaten twice shy Jollof Rice wey dey for d bottom of pot 2day go dey for top of cooler 2moro Translation:no condition is permanent Fowl wey dem carry for head no dey know say to waka na work. Translation:A dependant would not know the value of what he/she is enjoying. |
| Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by otbliz(m): 8:59pm On Feb 13, 2015 |
Nice.... But u no sabi copy? victorVIC1:That na facebook signature |
| Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by victorVIC1(op): 9:03pm On Feb 13, 2015*. Modified: 9:28pm On Feb 13, 2015 |
otbliz:Lol...post already edited |
| Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by okpamson15(m): 9:51pm On Feb 13, 2015 |
Aso rock na 8 8years. Translation: leave Gej make him finish him tenure |
| Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by victorVIC1(op): 7:05am On Feb 14, 2015 |
okpamson15:hehehe... U go fear quote o. |
| Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by fctguy: 10:29am On Feb 14, 2015 |
Very funny but informative thanks |
| Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by TaeKEa5: 9:29pm On Feb 26, 2015 |
yes wrong... |
| Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by kuuljay(m): 12:08pm On Feb 27, 2015 |
No mata how small kpekus wata small e dey rish jontomos take baff.somebody translate |
| Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by victorVIC1(op): 12:19pm On Feb 27, 2015 |
fctguy:Tanx man |
| Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by victorVIC1(op): 12:19pm On Feb 27, 2015 |
TaeKEa5:? |
| Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by victorVIC1(op): 12:22pm On Feb 27, 2015 |
kuuljay: How person want take translate wetin him no understand? |
| Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by kuuljay(m): 7:47pm On Feb 27, 2015 |
victorVIC1:komot for road,i knw say you understand.you yus dey form good boy there |
| Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by victorVIC1(op): 8:53am On Feb 28, 2015 |
kuuljay:Abeg, who be jontomos?Abi na Mr Ibu surname be dat? |
| Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by njuwo(m): 10:23am On Feb 28, 2015 |
victorVIC1:Jontomos na your brother wey dey in between your leg. |
| Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by njuwo(m): 10:25am On Feb 28, 2015 |
kuuljay:No matter how life suffer you reach you go still make am. |
| Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by kuuljay(m): 8:00am On Mar 01, 2015 |
victorVIC1:prick nahh |
| Re: Hilarious Nigerian Proverbs And Closely Related Translations by kuuljay(m): 8:00am On Mar 01, 2015 |
njuwo:you try my brother |
Americans React To This Hilarious Nigerian Name • 15 Most Hilarious Nigerian Starter Packs • Funny Nigerian Pidgin Proverbs And Their Loose Translations ... • 2 • 3 • 4
The Pharmacists Daughter • Top 10 Grammatical Blunders By Patient Dame Jonathan • Top Football Players Battle/beat With Referees On Field
How person want take translate wetin him no understand?