₦airaland Forum

Welcome, Guest: Register • Login • With Google • Trending • Recent • New

Stats: 3,344,344 members, 8,511,417 topics. Date: Sunday, 01 November 2026 at 03:41 PM

Toggle theme

**** Oyinbo Princess Talks On UK Dulling! **** - Culture - Nairaland

Nairaland Forum › Nairaland General › Culture › **** Oyinbo Princess Talks On UK Dulling! **** (1190 Views)

1 Reply (Go Down)

**** Oyinbo Princess Talks On UK Dulling! **** by OyinboPrincess(op): 4:55pm On Apr 06, 2015
My People, I hail ooOoo

Ehen, so people think say the grass is greener on the other side abi? omo na wrong thought b that na! As I dey like this, for this festive period of Easter, wen persin suppose celebrate Jesus and the fact he died for us then rose again, UK just dey dull me ooOoo!!! I knw say eh, if I dey for 9ja right now, omo party and celebrations go full my hand!! UK dull persin well well oo, no b small mata!! People no fit gree comot, everybody just wan dull themselves for house, party no dey, people no dey, groove no dey!!! 9ja na the key to enjoyment ooOoo, no b lie!!! If I dey 9ja today, as I dey like this, na so I go shine my eye ontop Alomo, feel sun rays for my Oyinbo skin, wey go sweet me, chop Eba & Egusi, fry Puff Puff and Bean Cakes, meet people for beach, groove to music and celebrate the 9ja culture which too too enter my body.

CHAIIII dullin dey all of the Western World ooOoo!! 9ja make sense pass, abeg, no talk say u wan come UK, e go dull u well well!!!

OYA na, come follow me for the latest na, e b lyk say my pages fit sweet ur bele!!

http://www.facebook.com/oyinboprincess

Twitter: @OyinboPrincess


https://www.youtube.com/watch?v=2ZBkFTLNlKI
Re: **** Oyinbo Princess Talks On UK Dulling! **** by absoluteSuccess: 5:27pm On Apr 06, 2015
oyinbo princess, I dey enjoy your election platitude o

omo see gobe...
Re: **** Oyinbo Princess Talks On UK Dulling! **** by darnley16(m): 5:36pm On Apr 06, 2015
Ok u try, I been wan laugh u b4, but u try sha
Re: **** Oyinbo Princess Talks On UK Dulling! **** by Danhumprey: 5:42pm On Apr 06, 2015
Mehn! I dey ginger this OP ooo!grin
Re: **** Oyinbo Princess Talks On UK Dulling! **** by Prodeegee(m): 5:43pm On Apr 06, 2015
my friend will you come online now before i come into your room to pull you online? @oyinboprincess
Re: **** Oyinbo Princess Talks On UK Dulling! **** by OyinboPrincess(op): 5:52pm On Apr 06, 2015
@absoluteSuccess - thank you ooOoo - sebi u see am for my facebook abi?

@darnley16 - baba if u wan shine teeth, I no go gree stop u na, na happiness b that ooOoo!

@Danhumprey - OooSssEee ooOoo OYA waka come my facebook page na!!

@Prodeegee - padi mi, chaiiii, so u sef no sabi na Flu I come catch, na our wayo UK sun cause am ooOoo!!! na sniff I dey sniff so....
Re: **** Oyinbo Princess Talks On UK Dulling! **** by Nobody:
Ipopalomo and origin101. Your attention is needed here. grin
Re: **** Oyinbo Princess Talks On UK Dulling! **** by Prodeegee(m): 5:56pm On Apr 06, 2015
OyinboPrincess:
@absoluteSuccess - thank you ooOoo - sebi u see am for my facebook abi?

@darnley16 - baba if u wan shine teeth, I no go gree stop u na, na happiness b that ooOoo!

@Danhumprey - OooSssEee ooOoo OYA waka come my facebook page na!!

@Prodeegee - padi mi, chaiiii, so u sef no sabi na Flu I come catch, na our wayo UK sun cause am ooOoo!!! na sniff I dey sniff so....
Bring your flu here lemme heal you. show urself nowwwwwwwww
Re: **** Oyinbo Princess Talks On UK Dulling! **** by OyinboPrincess(op): 6:09pm On Apr 06, 2015
@Brandnew2 - abi ooOoo!!!

@Prodeegee - baba I nor feel fine ooOoo - na tomorrow I go show... heal keehuh na u b Jesushuh
Re: **** Oyinbo Princess Talks On UK Dulling! **** by Prodeegee(m): 6:10pm On Apr 06, 2015
OyinboPrincess:
@Brandnew2 - abi ooOoo!!!

@Prodeegee - baba I nor feel fine ooOoo - na tomorrow I go show... heal keehuh na u b Jesushuh
leave that one to me...till tomorrow. i miss you sha
Re: **** Oyinbo Princess Talks On UK Dulling! **** by dechandel(f): 7:24pm On Apr 06, 2015
grin grin grin
Re: **** Oyinbo Princess Talks On UK Dulling! **** by iPopAlomo(m): 7:34pm On Apr 06, 2015
ShoutOut to you OyinboPrincess...

Your head dey dia...
Re: **** Oyinbo Princess Talks On UK Dulling! **** by Nobody: 9:21pm On Apr 06, 2015
Oyinbo, if you fit vote for Naija elections, na who you go vote for - APC (Buhari) or PDP (Jonathan)

OyinboPrincess:
My People, I hail ooOoo

Ehen, so people think say the grass is greener on the other side abi? omo na wrong thought b that na! As I dey like this, for this festive period of Easter, wen persin suppose celebrate Jesus and the fact he died for us then rose again, UK just dey dull me ooOoo!!! I knw say eh, if I dey for 9ja right now, omo party and celebrations go full my hand!! UK dull persin well well oo, no b small mata!! People no fit gree comot, everybody just wan dull themselves for house, party no dey, people no dey, groove no dey!!! 9ja na the key to enjoyment ooOoo, no b lie!!! If I dey 9ja today, as I dey like this, na so I go shine my eye ontop Alomo, feel sun rays for my Oyinbo skin, wey go sweet me, chop Eba & Egusi, fry Puff Puff and Bean Cakes, meet people for beach, groove to music and celebrate the 9ja culture which too too enter my body.

CHAIIII dullin dey all of the Western World ooOoo!! 9ja make sense pass, abeg, no talk say u wan come UK, e go dull u well well!!!

OYA na, come follow me for the latest na, e b lyk say my pages fit sweet ur bele!!

http://www.facebook.com/oyinboprincess

Twitter: @OyinboPrincess


https://www.youtube.com/watch?v=2ZBkFTLNlKI
1 Reply

Oyinbo Men In Enugu Drinking Palm Wine And Local Dish (Photos) • Oyinbo Woman Pays Homage To Oba Of Benin In His Palace. Photos • Oyinbo People Greet Ooni Ogunwusi At A Get-Together In New York.Pics • 2 • 3 • 4

Photo: My Conversation With A Benin Girl • Yorubas Descendants Of Arabians ; A Legend Or The Truth? • King Of Iworoko Ekiti Gave Up The Ghost 4 Days After The Dangote Trailer Tragedy