₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,326,238 members, 8,425,626 topics. Date: Friday, 12 June 2026 at 07:14 PM

Toggle theme

Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! - Romance (12) - Nairaland

Nairaland ForumNairaland GeneralRomanceOya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! (90691 Views)

1 2 3 ... 9 10 11 12 13 14 15 ... 39 Reply (Go Down)

Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Trypa(f): 1:01pm On Jun 20, 2015
peeparty:
ur time start now.oya woo person for here
Loool oya make I woo person now
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Nobody: 1:01pm On Jun 20, 2015
wristwatch:
*Going to backyard* no delay me o! cheesy
Oya let's go wink
I must get your ring on my finger today wink


#TEAM SCENT
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by pbs4real(m): 1:02pm On Jun 20, 2015
dharay99:
lol,
U no fit do dem... grin
no be smal tin oohcheesy
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by KingTom(m): 1:02pm On Jun 20, 2015
naijaboiy:
[color=#1980BC]HaHaHaHa grin
Nawa o!
I don confuse for that guy/girl matter sef huh[/color]
Just take am as you see am grin
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Trypa(f): 1:03pm On Jun 20, 2015
immortalvoices:
Lolgrin

Good afternoon dearie.

Still serving oooo

Check my last paragraph i dedicated it to madam na.... Only that I encoded it.


Nice poise on your profile pics.
Shuu tnkz for d pishure


Madam own correct


No woo anoda girl for here o lipsrsealed
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by pbs4real(m): 1:04pm On Jun 20, 2015
ggrin:
vhema keundecided
wetin do herhuh Or u go take her placetongue
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by peeparty(m): 1:04pm On Jun 20, 2015
Trypa:
Loool oya make I woo person now
waiting
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Nobody: 1:04pm On Jun 20, 2015
dharay99:
yhu got dem on yhu plenry.
Hmmm

Wait let me ask ifa grin tongue
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by KingTom(m): 1:05pm On Jun 20, 2015
immortalvoices:
This is it.........


Babe I been wan lie say I be dangote pikin.. But my money no fit buy your love,

Chai Jesus... Babe I been wan tell you say seun and naijaboiy na my paddy but u nor need am


I be farmer pikin.... But nor worry I don dey serve for nysc in Niger state house of assembly....minna. Baby now you see say God don cross me through the border..

But for your sake I go pray, cast and bind for you to love me....... Open your heart my sweet potato, I dey beg you please.... Baby I dey on my knee. No let kingt om take you away from me,

Since wey I see you for nairaland.. Naim my Mind say u too fine pass my mama... Baby your "know know" for nairaland dey burst my brain.....

I just wan tell you say I go love respect and make sure say you dey enjoy your life for ever ... Abeg say yes......



Dedicated to the girl on nairaland whose middle alphabet is the fourteenth alphabet.....

Cc......

Na ijaboiy
That babe? shocked
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by kinglekan: 1:05pm On Jun 20, 2015
ggrin:
undecided
Ode. undecided
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by pbs4real(m): 1:05pm On Jun 20, 2015
Trypa:
Shuu tnkz for d pishure

Madam own correct

No woo anoda girl for here o lipsrsealed
u to dey jealousshocked
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by KingTom(m): 1:05pm On Jun 20, 2015
AgapeCharis:
[color=#27408B]Omo naijaboiy plan me for sleep o. cheesy
Afape! cheesy Very funny grin
Who you don toast? grin
[/color]
I belong to everybody and I belong to nobody grin grin grin I just drop am, anyone wey like fit fill in her name grin
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by dharay99: 1:06pm On Jun 20, 2015
LadyBoss1:
Hmmm

Wait let me ask ifa grin tongue
shaa come drop ur own line let's see.
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by dharay99: 1:06pm On Jun 20, 2015
LadyBoss1:
Hmmm

Wait let me ask ifa grin tongue
shaa come drop ur owl line let's see.
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by KingTom(m): 1:06pm On Jun 20, 2015
immortalvoices:
Lol. grin

Nasoo joor
Minna babes grin
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by KingTom(m): 1:06pm On Jun 20, 2015
wordbank:
The babe b like she dey stay for waterside n u know say dia own no good at all at all. Her brothers be like dem dey use ogogoro n monkey tail take brush teeth, igbo na wetin dem dey take warm up n d way things b,if dem catch me dey run package with dia fine small sister... omo mehn na die cos dem go pump my jaw scatter, d other one wey him chest big like two storey building naim I dey fear pass. The babe dey hia sef n I no know weda her brothers dey hia but kingtom resemble one of them naim make to quote am sometimes dey do me one kain.
Babe, I no know how e go b, but if anything do me na ur yansh go hiaram!
If u love me no talk am, no even write am until I give u belle then I fit talk weda I luv u or not.
Weyrey grin grin grin
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by dharay99: 1:07pm On Jun 20, 2015
pbs4real:
no be smal tin oohcheesy
not gud for a mahn. lipsrsealed
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by KingTom(m): 1:07pm On Jun 20, 2015
ggrin:
aunty migrin
Egbon grin
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by KingTom(m): 1:07pm On Jun 20, 2015
ggrin:
make I go do surgery againhuh
You wan be Caitlyn? grin
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Nobody: 1:08pm On Jun 20, 2015
Trypa:
Loooooooll
Mumc
My boob n ass dey shootout wella grin
Lol...... beta pikin wink

#TEAM SCENT
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by TheSonOfMark(m): 1:08pm On Jun 20, 2015
elantraceey:
Sonofmark come show your skill grin

Babe, I sure say even Adam liver been fail when im first sight Eve but as man no fit fight im heart na im im come surrender to you, my Eve.
Forget my Queen's English, make I tell you plainly - you dey distinguished.

Dem say emotions no get language that's why I wan drop you my package. I like the fact say you dey be yourself plus you dey like yarn your mind even when people dey against you.

You na the kind woman wey I fancy. Because of you dem my formings na im I don 'fashi'.

I stubborn somehow, no be lie but your qualities go make us work. Adam and Eve been live for Eden but I sure saw together we go reside inside our private and na you go be the only queen.smiley

I no fit brag say I dey live extra-large but with our hustle I know say cars for full our garage.wink
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by immortalvoices(m): 1:09pm On Jun 20, 2015
Trypa:
Shuu tnkz for d pishure

Madam own correct

No woo anoda girl for here o lipsrsealed
Yes ma!!!!
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Nobody: 1:10pm On Jun 20, 2015
dharay99:
shaa come drop ur owl line let's see.
But chics dont toast nau
Lol how do u even toast a guy self ...
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by TheSonOfMark(m): 1:10pm On Jun 20, 2015
pbs4real:
ma guy all dis demo? Oya shootcheesy

Check page 11.

Cc: Ronald4lif
Naijaboiy
CuteHector
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Nobody: 1:11pm On Jun 20, 2015
Shamstiel:
Abeg help me halla am come, e be like say my head no wan correct again. Na only her yansh face I just dey reason embarassed
Lolz naijaboiy dey teach u bad tin
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by pbs4real(m): 1:12pm On Jun 20, 2015
dharay99:
not gud for a mahn. lipsrsealed
lyk ciriouslyhuh I dn too woo ladies nw nah dem turn to return amtongue
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by dharay99: 1:12pm On Jun 20, 2015
LadyBoss1:
But chics dont toast nau
Lol how do u even toast a guy self ...
stop forminq 4me. undecided
U girls know hw 2get wah u want na.

Oya just drop urs, tag a name.
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Idowuogbo(f): 1:12pm On Jun 20, 2015
AgapeCharis:
Dearer Misssclassy

Fine girl wey sweet pass shiit wey person don hold for days wey e finally release.. smiley How you dey na? E get one thing wey I wan tell you. The thing sweet well well naim make I go lick sweet before I talk am. Since I don dey see you for this nairaland, my body catastrophe no remain the same again. Every time wey I dey see your comments, body go just dey do me like say I dey see coloured television for the first time.
WTF? LWKMMMMMMD!!!

Mad people everywhere
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by Trypa(f): 1:12pm On Jun 20, 2015
peeparty:
waiting
Clear throat





To d person wia I wanna dedicate dis tin to (PP) loool

Since the day wen u com nack mi followers request I come dey follow u bomber to bomber u dey make my head dey swell if I lie eh make rain no fall again till next year grin

I no dey fit concentrate again e con dey aS if u carry my name go do juju anytime wia my father call mi na so I dey respond am with ur name cheesy

So tay my mumc fly come back becus of my new madness wia u dey cause check my dp now u go see say na fine girl dey woo u so no be any kind one cheesy how e go be na if we see for back of NL I know say e go make sense grin


No take am personal oo cheesy
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by KingTom(m): 1:12pm On Jun 20, 2015
ggrin:
kingt omangry
Who be draifyhuh
A Doctor named Aify grin
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by immortalvoices(m): 1:13pm On Jun 20, 2015
KingTom:
That babe? shocked
grin grin
Baba wetin man go do na.... Lol
Re: Oya Come Toast That Babe or Guy wey You Like For PIDGIN!!! by KingTom(m): 1:14pm On Jun 20, 2015
immortalvoices:
grin grin
Hehehe... ... Kin gtom to the rescue.... Help naijaboiy decode the one which near middle alphabet name becomes the fourteenth alphabet in the 26 alphabet
grin grin grin
1 2 3 ... 9 10 11 12 13 14 15 ... 39 Reply

Can You Marry A Lady Or Guy Who Already Has A Child?6 Places You Should Never Toast A Nigerian GirlAdvice To That Babe Wey Say Her Guy Gives Her ONLY 1K234

10 Ways Ladies Act To Avoid Sex When They Visit Guys14-Year-Old Boy Forced To Marry His Older Girlfriend After Impregnating HerVillage In Africa Where Man's Joystick Will Be Flogged Before He Can Marry (Pix)