Okocha Make Us Disobey Our Coach - Diouf - Celebrities - Nairaland
Nairaland Forum › Entertainment › Celebrities › Okocha Make Us Disobey Our Coach - Diouf (1925 Views)
| Okocha Make Us Disobey Our Coach - Diouf by AKPOSbaba(op): 6:30pm On Aug 06, 2015 |
Two times African footballer of di year and Jay Jay Okocha forma team mate for English primiaship, El Hadji Diouf, don yarn say, Okocha make dem disobey dia coach Sam Allardyce for Bolton wen dem play togeda. Akordin to wetin africanFootball.com report, Diouf say Okocha dey always tell dem for Bolton Wanderers say make dem play wetin dem like and make dem no listen to only di coach yarns. Diouf say wen Big Sam giv dem orders, Okocha go giv dem anoda order to play wetin dem want. Di Senagal forma winga El Hadji Diouf say,for two good years dem finish for numba six position bicos of dia biutiful football. He say na dem play di most entataining football for England dat time and he enjoy to dey play wit Jay-Jay Okocha, Fernando Hierro, Vincent Candela and Nicholas Anelka for dose years. SOURCE....http://ogakpatakpata..co.uk/2015/08/okocha-make-us-disobey-our-coach-diouf.html?m=1
|
| Re: Okocha Make Us Disobey Our Coach - Diouf by OKorowanta: 6:35pm On Aug 06, 2015 |
Okocha,mr skillachi ![]() |
| Re: Okocha Make Us Disobey Our Coach - Diouf by AKPOSbaba(op): 6:41pm On Aug 06, 2015 |
Jay Jay, So good they named him twice
|
| Re: Okocha Make Us Disobey Our Coach - Diouf by nikkiking(m): 6:41pm On Aug 06, 2015 |
Lol. Okocha na master na. Na who wan coach person wey sabi him work. |
| Re: Okocha Make Us Disobey Our Coach - Diouf by Pierocash(m): 6:54pm On Aug 06, 2015 |
ok noted |
| Re: Okocha Make Us Disobey Our Coach - Diouf by lurdabdaniels(m): 1:56am On Aug 07, 2015 |
Okocha unserious footballer |
| Re: Okocha Make Us Disobey Our Coach - Diouf by AKPOSbaba(op): 8:19am On Aug 07, 2015 |
lurdabdaniels:Hater I diasgree. Pele,Wenger,Roger milla cant all be wrong wen they said okocha na magician. |
Tuface And Banky W Laugh Over Hilarious Meme Featuring Him, Kanu And Okocha • Charles Okocha's Stomach Bursts After Surgery • Mikel Obi, Kanu Nwankwo & Okocha Make Africa's Top 10 Richest Footballers Of All • 2 • 3 • 4
Burnaboy And Cynthia Morgan Finally Shares A Kiss..(see Photos) • Hot Sizzling Photos Of Nigerian Instagram Model Adamara Ajuzie (@prettyxgirlswag • Burna Boy Announces New Endorsement Deal With G-wagon [PICS]
