Deeper Life at it Again??? - Christianity Etc - Nairaland
Nairaland Forum › Nairaland General › Christianity Etc › Deeper Life at it Again??? (991 Views)
| Deeper Life at it Again??? by RADDY1(op): 10:19pm On Dec 07, 2015 |
Enter with your change ooo because i no fit shout... (Bus on the move)..... Hello my people ... I don come again ooo, your famous medicine seller...if you sabi this bus, you go know me wella!! This time we get another korect product wey don enter market gidigba ... it fit cure your physical sickness, Spiritual sickness, Mental sickness, Financial sickness, Marital sickness, and even academical sickness.. But wetin dey be say na five days we wan take give you this correct and confirm medicine... This medicine too big you no fit finish am...Na coming soon product b dis oo for Dec 24-27 2015 I go advise you make you come straight to our company make alaba boys no go sell fake give you. Our company da round d world#any Deeper life camp ground closer to u.. go dey for all we branches at Deeperlife camp. E no far at all oh. Passenger: how much be your medicine Seller: (laughs) just come with your faith and believe because dis Tested and Trusted medicine na free of charge oooo... No come alone oh, come with your family,friends even ur enemies because spiritual food go plenty full everywhere , Miracles sef no go stop, Signs and Wonder go dey flow like water and you sef go collect your own for free. Jesus na Baba... # Deeper life 2015 # Tell a Friend |
| Re: Deeper Life at it Again??? by Kyase(m): 10:38pm On Dec 07, 2015 |
Deeper life don dey do worldly tins ooo ![]() |
| Re: Deeper Life at it Again??? by RADDY1(op): 1:49pm On Dec 08, 2015 |
Kyase:WHAT MADE U SAY THAT |
| Re: Deeper Life at it Again??? by Kyase(m): 4:12pm On Dec 08, 2015 |
RADDY1:Haba no tell me say you no sabi them |
"Dead Pastor, Anderson Chinenye, Back To Life At The Mortuary" - Facebook User • Why Do Nigerian Girls Complain About Deeper Life Weddings? • One Of The Victims Who Lost His Life At The Collapse Reigners Bible Church (pic) • 2 • 3 • 4
Open Heavens Daily Devotional 16/01/16 • Ten Major Flaws Of The Evolution Theory • Masturbation Causes And Cure
