₦airaland Forum

Welcome, Guest: Register • Login • With Google • Trending • Recent • New

Stats: 3,344,387 members, 8,511,599 topics. Date: Monday, 02 November 2026 at 02:24 AM

Toggle theme

I Dey Beg In The Name Of Love - Romance - Nairaland

Nairaland Forum › Nairaland General › Romance › I Dey Beg In The Name Of Love (824 Views)

1 Reply (Go Down)

I Dey Beg In The Name Of Love by hungryboy(op):
Since dis week waka come,
I have been sipping garri for breakfast, lunch and supper,
Today so my garri sef don come finish.
Since i hear say some people dey do christmas give away for internet, i say make i come 'beg away',

Abeg in the spirit of the season,
Make una show me love,
Make hunger no kill una boy,
I just dey house now dey inhale the aroma of my neighbour chicken stew for an hour now, but i never still belleful,
Abeg if you wan wire me small thing make i take maintain, inbox me make i give you account details,
I dey accept internet banking, western union, moneygram and even bitcoin too,
Nothing is too small but no send me wetin you no fit put as offering for church,
In case you wan give me food, abeg i dey Calabar, you fit send am through Aero afternoon flight if you dey Lagos, i go go airport go collect
God bless all that will help a brother in need,
Merry Christmas to una
But my own christmas no get merry at all,
Make my christmas merry too
Re: I Dey Beg In The Name Of Love by hungryboy(op): 12:21pm On Dec 25, 2015
Abeg no be joke i dey oh, make una help una boy, Cc Ylaa, Mr cork, Yuzedo, Tonye barcanista, Caracta, Flow 1759, farano, naijaboiy,
Beenkumar, Victoriousvic, Prettythicksme, Seun And all others too numerous to mention
Re: I Dey Beg In The Name Of Love by Nobody: 12:59pm On Dec 25, 2015
Ok so ow exactly cn we help u?
Re: I Dey Beg In The Name Of Love by CUM4WHAT(m): 1:32pm On Dec 25, 2015
Op d help u need is a little brain surgery and i can connect u with an express doctor at yabaleft
Re: I Dey Beg In The Name Of Love by hungryboy(op): 3:46pm On Dec 25, 2015
naughtynaughty:
Ok so ow exactly cn we help u?
you can cut me cheque,
Or invite to your house to come and chop
Re: I Dey Beg In The Name Of Love by hungryboy(op): 3:50pm On Dec 25, 2015
CUM4WHAT:
Op d help u need is a little brain surgery and i can connect u with an express doctor at yabaleft
connect me with the doctor abeg,

I will allow them perform the surgery on me, if it comes with a plate of jollof rice and chicken and a cash reward
Re: I Dey Beg In The Name Of Love by hungryboy(op): 3:52pm On Dec 25, 2015
Abeg make una use una church mind abeg,

I'm still expecting my first gift, Abi na so una wicked reach?
1 Reply

'Rape & Beg': UnilagOlodo Who Was Accused Of Rape Takes Legal Action (Photos) • UNILAG Girl Recounts Her "Rape & Beg" Experience With A Man, Unilagolodo • She Wan Straff Me But I Dey Fear Ooo (pic) • 2 • 3 • 4

See The Message A Lady Received On Facebook • A Touching Story From A Poor Lady • From Eritrea With Love