E Dey Pain But Wetin Man Go Do Na!! !! - Politics - Nairaland
Nairaland Forum › Nairaland General › Politics › E Dey Pain But Wetin Man Go Do Na!! !! (1676 Views)
| E Dey Pain But Wetin Man Go Do Na!! !! by zanebaddo(op): 7:28pm On Sep 11, 2016*. Modified: 10:58pm On Sep 11, 2016 |
Last week abi two weeks around 7 am already on my way into the street for hustling since man no see white collar job.. As I just climb dat pedestrian bridge na for car wash for lugbe Abuja... Na so siren from no where on a high speed de blow I come look e come be say na presidential convoy Chai I shout!!! ! !! See as the first soldier wey dey drive power bike stand on top the bike with naija flag dey salute while the bike dey fire speed. . Then other sophisticated bullet proofed cars come follow... the speed at which they moved was magnificent... Chai! !!! And the kind hunger wey dey wire me dat day ehh as I never chop even days before and this man dey enjoy all these at his age. Chai.. My people make I talk true, with the kind things wey i see dat day guns no fit touch buhari sef not to talk of curse wey we dey curse am from miles away.. Even on nairaland... Make una use dat strength enter Street huzzle for daily bread my brother.... This life sef!!! I get many things to yarn but make I stop here. Lala baby!! Abeg move am to front page !! Tori dey come as e de hot. . |
| Re: E Dey Pain But Wetin Man Go Do Na!! !! by greatgod2012(f): 7:35pm On Sep 11, 2016 |
![]() Sorry dear. E go better! |
| Re: E Dey Pain But Wetin Man Go Do Na!! !! by policy12: 7:43pm On Sep 11, 2016 |
Hmmm @op true talk but.. .
|
| Re: E Dey Pain But Wetin Man Go Do Na!! !! by hybridtm(m): 7:45pm On Sep 11, 2016 |
Bros.. .no b only u dey d struggle ......... Him dey pain, but wetin man go do.. .. Nigeria Don tumble |
| Re: E Dey Pain But Wetin Man Go Do Na!! !! by zanebaddo(op): 7:51pm On Sep 11, 2016 |
greatgod2012:you de laf baa.. You think it's funny Chai abeg make we exchange our conditions.. take my own give me your own Chai |
| Re: E Dey Pain But Wetin Man Go Do Na!! !! by greatgod2012(f): 7:57pm On Sep 11, 2016 |
zanebaddo:Lol..... Do you know my condition? How are you sure my condition is better than yours ![]() See, whatever whatever, thank God that you're still alive, when there is life, there is hope! If you just continue thinking about what you typed in your original post, you will just use brooding to kill yourself. Life has never treated people equally. Accept your conditions with the faith and decision to make it better. |
| Re: E Dey Pain But Wetin Man Go Do Na!! !! by Davash222(m): 8:04pm On Sep 11, 2016 |
We will get there.. Keep the hustle legal and legit. |
| Re: E Dey Pain But Wetin Man Go Do Na!! !! by zanebaddo(op): 8:07pm On Sep 11, 2016 |
Sometimes when I enter nairaland come see the kind money wey efcc dey quote say dem trace for person account my phone go de vibrate for my hand.. Chai.. One man has to him sef 10 private Jets.. Nna eh Mbok make una fear God small Yesterday I hear say saraki say him de feel our pain, as he returned from vacation with his family from Spain Chai Why does God not strike like amadioha!!!!! Dino melaye after touring USA with his family released some wailing statement about how he wants buhari to start biting.. Oga Dino na now you wan turn buhari to suares. You no no say him teeth no strong again considering his age... drama everywhere |
| Re: E Dey Pain But Wetin Man Go Do Na!! !! by zanebaddo(op): 8:10pm On Sep 11, 2016 |
greatgod2012:my sister I don accept am tey tey na for those of us wey still dey waste time dey hope for govt dey curse buhari.. make dem wake up o!! ! Say time no de |
| Re: E Dey Pain But Wetin Man Go Do Na!! !! by anibi9674: 10:02pm On Sep 11, 2016 |
this life enh. |
| Re: E Dey Pain But Wetin Man Go Do Na!! !! by deji68: 10:05pm On Sep 11, 2016 |
![]() zanebaddo: |
| Re: E Dey Pain But Wetin Man Go Do Na!! !! by daveyjay(m): 10:07pm On Sep 11, 2016 |
greatgod2012:Some are livinq a life of hopelessness |
| Re: E Dey Pain But Wetin Man Go Do Na!! !! by zanebaddo(op): 10:37pm On Sep 11, 2016 |
deji68:my brother it's not funny o I de Yarn d tori as e de hot 4 my mind ![]() |
| Re: E Dey Pain But Wetin Man Go Do Na!! !! by zanebaddo(op): 10:51pm On Sep 11, 2016 |
daveyjay:if I had seen this quote in another thread I wouldn't have bothered to reply you but since you could not respect your self enough to read and comprehend a simple comical note that is directed to well meaning youths to stop cursing and brace up for the task ahead, I'm just tempted to pour some e-venoms at you but what good will it bring to my pocket? Swerve brother!!! Keep doing what the likes of you are known for on nairaland, to curse away your generations on a faceless forum.. When was the last time you fought a fellow man in your area? If I hear.. you get strength.. Lol nairaland e-thug enter Street na |
| Re: E Dey Pain But Wetin Man Go Do Na!! !! by zanebaddo(op): 11:19pm On Sep 11, 2016 |
E no easy for street o especially for graduates wey never try huzzling on there own before.. If dem tell you say easy my guy leave am na set up. As I enter Abuja I don see many things, but na God still de keep me.. I swear nothing be like say every morning say man de commot from house whether money follow you come back e no matter... Idleness bad.. Person wey say nothing de happen na person wey never see anything.. Na person wey wear shoe know where e de pain am too |
| Re: E Dey Pain But Wetin Man Go Do Na!! !! by daveyjay(m): 6:03pm On Sep 12, 2016 |
zanebaddo:I perceive U are learned, since U didn't insult me, I see no reason why I should.... I quoted someone's comment b4 typinq what I typed, when the quy typed "when there is life, there is hope" that was when I typed my comment, do well to read throuqh b4 criticisinq... On the issue of fiqhtinq someone on the street; U are riqht, I have never fouqht anyone and don't hope to... I have inner peace, and I try as much to live at peace with every peace lovinq individual.... |
Ipob: Love Adds No Pain ...but Hate..? • "Wetin Dem Know Wey Be Biafra?" - Obasanjo Speaks On Agitation On BBC (video) • 'Governor Wey Dey Pay Killers': Protest In Abuja Over Southern Kaduna Killings • 2 • 3 • 4
Photos:remains Of Lt Col Muhammad Abu Ali Being Transferred By His Comrade • What's The Real Size Of Africa? • Buhari’s Former Doctor Speaks, Reveals Things About The President, IBB Buhari’s
