Nebuchadnezzar Children Collect Back Wizkid Award And Givam To Unknown Soldier - Celebrities - Nairaland
Nairaland Forum › Entertainment › Celebrities › Nebuchadnezzar Children Collect Back Wizkid Award And Givam To Unknown Soldier (1168 Views)
| Nebuchadnezzar Children Collect Back Wizkid Award And Givam To Unknown Soldier by OKorowanta(op): 10:33pm On Nov 11, 2016*. Modified: 2:53pm On Feb 17, 2017 |
Mtv Europe Miuzik Award organizers don show us say na devil dem dey serve as Dem dey disgrace diasef tinking say na Wizkid and Naija dem dey disgrace. Can u imagine say di award wey dem carry giv Wizkid as di 2016 best African miuzishan five days ago, Dem Don say na mistake dem make as Dem don giv di award to Alikiba of Tanzania. Upon all wetin Wizkid achiv for 2016. Sombodi wey him miuzik wit Drake "One Dance" be nomba one for two months for di whole world,and yet you tritam like shiit? Sombodi wey him jam with Tinnie Tempah "Mamacita" enta world chart and even reach No 45 for U.K. Chart, una nor rekognaiz am? Sombodi wey Jamaicans dey shout say,'who be dis boy? afta he reliz Shabba wit Chris Brown,French Montana and Trey Songz. Alicia Keys wey Wizkid Ojuelegba song sweet Sotay, she burn Indomie wey she dey cook for her hosband,Swizz Beat. So,Alikiba wey be say na only Tanzania and dia family compound dem for know am,una carry di award givam? Thunda go fire una for dia! Nebuchadnezzar shidren! Source...http://ogakpatakpata..com.ng/2016/11/it-is-lie-mtv-europe-awards-organizers.html
|
| Re: Nebuchadnezzar Children Collect Back Wizkid Award And Givam To Unknown Soldier by royallord1(m): 10:34pm On Nov 11, 2016 |
what the F are u saying |
| Re: Nebuchadnezzar Children Collect Back Wizkid Award And Givam To Unknown Soldier by PoosPoos: 10:36pm On Nov 11, 2016 |
Lol ![]() Dem be pharaoh descendants |
| Re: Nebuchadnezzar Children Collect Back Wizkid Award And Givam To Unknown Soldier by Eliza5050(f): 10:41pm On Nov 11, 2016 |
This will only make Wizkid improve much better than what he is already. He is talented |
| Re: Nebuchadnezzar Children Collect Back Wizkid Award And Givam To Unknown Soldier by AKPOSbaba: 10:44pm On Nov 11, 2016 |
royallord1:Tanzanian Spotted |
| Re: Nebuchadnezzar Children Collect Back Wizkid Award And Givam To Unknown Soldier by royallord1(m): 10:47pm On Nov 11, 2016 |
| Re: Nebuchadnezzar Children Collect Back Wizkid Award And Givam To Unknown Soldier by Nature8(m): 6:34am On Nov 12, 2016 |
Lol |
19th of October! Starboy Fest Is Back, Wizkid Announced. Photos • If I Bang Your Girl, You Are Not Getting Her Back (wizkid) • If I F*ck Your Girl, You’re Not Getting Her Back - Wizkid • 2 • 3 • 4
Joke Of The Day::: Our Chicken Is Relocating [pics] • Clarion Chukwurah Celebrates Son, Clarence Peters On His Birthday • Basketmouth Gets Knighted By The Queen Of England (photo)
