₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,326,822 members, 8,428,226 topics. Date: Wednesday, 17 June 2026 at 07:22 AM

Toggle theme

Question Jam Answer (part I) - Literature - Nairaland

Nairaland ForumEntertainmentLiteratureQuestion Jam Answer (part I) (769 Views)

1 Reply

Question Jam Answer (part I) by WordsmithE(op):
Question

Na who you be,
wey you carry your yeye Monday craze
come jam me for my Friday enjoyment?
As I dey kampe,
with my bottle of Star
and suya wey I buy from Mallam Bala,
you come bring your yeye hand wey look like chicken waka,
come dey chop my goat meat with you big mouth like sallah cow!

Na who you be,
wey you dey talk about he and she
wey you no even sabi,
as if you no get your own big katako for eye?
Dem say dem say,
I hear, I hear,
na so so bad belle you dey bring everytime.
Me sef I no even try,
na because I sidon for near gate like almajiri,
na why you give me your gossip gossip
like say I ask you for your 50kobo.

Na who you be - tell me!
Na who send you,
say make you come throw sand for my garri.
Dis one wey you dey pose
like dem waka waka gehs,
wey dey 11pm until 5am
infront of NAF Club and Command Guest House,
wey dey wait for Oga carry me home,
and Mr. I no get wife for house.

So,
na because we do play play once
for back of stadium,
because of small kiss kiss and touch touch
wey no even sweet me sef,
because I no get data to Whatsapp
for dis economi wey no get head no get tail,
na im you come jack my dress,
come hold my trouser like padlock for prison,
dey shout for my head like yeye politician
wey wan chop my vote and chop my money after.

Kai, see me see wahala.

© 2017 WordsmithE
1 Like 2 Shares
Re: Question Jam Answer (part I) by maltharzaer(m): 4:03pm On Apr 09, 2017
WordsmithE:

True descriptive of the current Naija life
1 Reply

"Question And Answer Part 1B" By Dare To Be OneTis The Season For LOVE (A Nigerian Romance) - Part I234

Every Nigerian Youth Should Read This! (thought-provoking Piece)Unorthodox Sexual RelationsDisk Drill 3.7.942 With Crack