Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,114 members, 7,814,914 topics. Date: Wednesday, 01 May 2024 at 11:16 PM

Question Jam Answer (part I) - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Question Jam Answer (part I) (583 Views)

"Question And Answer Part 1B" By Dare To Be One / Tis The Season For LOVE (A Nigerian Romance) - Part I (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Question Jam Answer (part I) by WordsmithE(m): 9:54pm On Apr 08, 2017
Question

Na who you be,
wey you carry your yeye Monday craze
come jam me for my Friday enjoyment?
As I dey kampe,
with my bottle of Star
and suya wey I buy from Mallam Bala,
you come bring your yeye hand wey look like chicken waka,
come dey chop my goat meat with you big mouth like sallah cow!

Na who you be,
wey you dey talk about he and she
wey you no even sabi,
as if you no get your own big katako for eye?
Dem say dem say,
I hear, I hear,
na so so bad belle you dey bring everytime.
Me sef I no even try,
na because I sidon for near gate like almajiri,
na why you give me your gossip gossip
like say I ask you for your 50kobo.

Na who you be - tell me!
Na who send you,
say make you come throw sand for my garri.
Dis one wey you dey pose
like dem waka waka gehs,
wey dey 11pm until 5am
infront of NAF Club and Command Guest House,
wey dey wait for Oga carry me home,
and Mr. I no get wife for house.

So,
na because we do play play once
for back of stadium,
because of small kiss kiss and touch touch
wey no even sweet me sef,
because I no get data to Whatsapp
for dis economi wey no get head no get tail,
na im you come jack my dress,
come hold my trouser like padlock for prison,
dey shout for my head like yeye politician
wey wan chop my vote and chop my money after.

Kai, see me see wahala.

© 2017 WordsmithE

1 Like 2 Shares

Re: Question Jam Answer (part I) by maltharzaer(m): 4:03pm On Apr 09, 2017
WordsmithE:
Question

Na who you be,
wey you carry your yeye Monday craze
come jam me for my Friday enjoyment?
As I dey kampe,
with my bottle of Star
and suya wey I buy from Mallam Bala,
you come bring your yeye hand wey look like chicken waka,
come dey chop my goat meat with you big mouth like sallah cow!

Na who you be,
wey you dey talk about he and she
wey you no even sabi,
as if you no get your own big katako for eye?
Dem say dem say,
I hear, I hear,
na so so bad belle you dey bring everytime.
Me sef I no even try,
na because I sidon for near gate like almajiri,
na why you give me your gossip gossip
like say I ask you for your 50kobo.

Na who you be - tell me!
Na who send you,
say make you come throw sand for my garri.
Dis one wey you dey pose
like dem waka waka gehs,
wey dey 11pm until 5am
infront of NAF Club and Command Guest House,
wey dey wait for Oga carry me home,
and Mr. I no get wife for house.

So,
na because we do play play once
for back of stadium,
because of small kiss kiss and touch touch
wey no even sweet me sef,
because I no get data to Whatsapp
for dis economi wey no get head no get tail,
na im you come jack my dress,
come hold my trouser like padlock for prison,
dey shout for my head like yeye politician
wey wan chop my vote and chop my money after.

Kai, see me see wahala.

© 2017 WordsmithE
True descriptive of the current Naija life

(1) (Reply)

Our Ordeal In Sambisa Forest / Poem: Till We Meet Again By Soibi Polymath / Jeel is a Scammer

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 13
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.