₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,330,959 members, 8,447,961 topics. Date: Sunday, 19 July 2026 at 12:07 PM

Toggle theme

Share Your Funny Akward Dreams Here - Nairaland General - Nairaland

Nairaland ForumNairaland GeneralShare Your Funny Akward Dreams Here (1788 Views)

1 Reply (Go Down)

Share Your Funny Akward Dreams Here by MichaelSokoto(op):
At some point in our lives, we do dream some funny, stupid awkward dreams.
pls let's share cool


so just dis nite, I just woke up 4rm a chilling akward dream.
una know dat Commando film starring Arnold Schwarzenegger? during d time he went to break into an arms warehouse to collect those arsenal of weapons, my broda, na me follow am with army camo bag. grin

as d guy dey load em own, na so him put one machine gun & a mini rocket launcher for my bag wey I carry for back like backpack.
Arnold come waka leaving me to take d weapons to my house. I enter my bike ride comot 4 d compound, it was fast getting dark & I was riding towards king square center, ring road in Benin city.
unfortunately, our Naija police chose dat very evening of all every evenings to mount dia tax collection checkpoint. 4 dis very dream, dem contract agberos to help dem block loop holes so dat if u try avoiding dem for one side, agbero boiz gor kpanke u for d oda side undecided

as I dey turn round a bend na so I sight dem, small chill hold me but been say I carry army camo bag 4 back, been think say dem go soji then lemme pass, highest I go form esprit 'd corp.
dis police dem carry gun for one hand still hold long stick for d oda. as I dey near dem dey form soja man, dem dey flank me down but I dwy fire on. police man carry him stick take wipe me with all of dem also tryin to but I managed to escape. come see agbero dem sef for front wit em stick to wipe me join but I still escape. pheww!

I haven't even riden more than two NEPA poles, I still jam anoda set of police checkpoint wit em agbero platoon. same previous escape scenerio played out again.

I ditched d bike & was now jogging onto a street wit a kinda slow moving traffick.

as I was jogging on one side of d road, my broda come see our Nigerian soldiers for inside dia military truck wit some of dem fully armed & me na, I carry camo bag wen I nor be soldier.

army truck was discharging off some officers (close of work for d day tinz), me for my mind I say "ee don be for me today" for d weapons wey I carry? heaven dey await pesin today grin

but I summon courage, hold my liver put for right hand dey form solja man walkin style but tryin to avoid eye contact in case I hear, "hey you! esprit 'd corp, wats ur army numba? wat unit are u? why are u not in full carmo? wats in d bag?"

but I managed to bypass dem & quickly cornered into a nearby street then I woke up.
grin grin
Re: Share Your Funny Akward Dreams Here by Joiceee(f): 7:20am On Oct 14, 2017
Lol.............ensure you treat malaria this week.
Re: Share Your Funny Akward Dreams Here by bidexolumanish(m): 4:04pm On Oct 14, 2017
Joiceee:
Lol.............ensure you treat malaria this week.
this one pass malaria
Re: Share Your Funny Akward Dreams Here by bidexolumanish(m): 4:05pm On Oct 14, 2017
Joiceee:
Lol.............ensure you treat malaria this week.
joicee whatsup
Re: Share Your Funny Akward Dreams Here by Joiceee(f): 10:34pm On Oct 17, 2017
bidexolumanish:
joicee whatsup
am gud
1 Reply

Share Your Funny And Weird Pictures Here10 Practical Ways To Make Your Dreams Come True And Enjoy LifeShare Your Most 'WEIRD' Experience Of 2017.234

NERFUND Loans To Small Business OperatorsVal Is Near! But These Are The Hidden Secrets About VALENTINE DayWhere To Buy Akwete Cloth In Lagos