₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,330,780 members, 8,447,093 topics. Date: Friday, 17 July 2026 at 04:30 PM

Toggle theme

If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? - Christianity Etc (2) - Nairaland

Nairaland ForumNairaland GeneralChristianity EtcIf God Lives On Earth, Can He Make Heaven? (2755 Views)

1 2 3 4 Reply (Go Down)

Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Dtruthspeaker: 6:11pm On Mar 04, 2021
kingxsamz:
Of course dem be man and woman, but shey dem know good or bad before eating the fruit? Shey na that simple question dey choke you? Answer am na. grin
Bros, Person way Sabi give names to things, wey Sabi work, wey like woman, e don Already Know good and bad.

For e know say Work Good, therefore e know say "No Work dey Bad"! grin

He gave names to things d4 e know say to identify things dey Good so dat e no go make mistake.

Therefore, e know say to make Mistake dey Bad. grin

E no say Woman dey Good, therefore e know say "Konji na bad thing" grin grin

As you can see They Surely knew "Good and Bad"! grin grin

My guy just reverse! Road No dey here! grin grin
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by kingxsamz(m): 6:23pm On Mar 04, 2021
Dtruthspeaker:
Bros, Person way Sabi give names to things, wey Sabi work, wey like woman, e don Already Know good and bad.

For e know say Work Good, therefore e know say "No Work dey Bad"! grin

He gave names to things d4 e know say to identify things dey Good so dat e no go make mistake.

Therefore, e know say to make Mistake dey Bad. grin

E no say Woman dey Good, therefore e know say "Konji na bad thing" grin grin

As you can see They Surely knew "Good and Bad"! grin grin

My guy just reverse! Road No dey here! grin grin
Lmao... You dey point out these things dey laugh grin, shey you no know say you dey prove my point? You no know say you dey prove my point say your bible dey contradict it self?
Your bible talk say dem no know good and bad before eating the fruit. Na still your bible talk say Adam know good and bad. Which one person go con believe? E be like say you no really sabi this your bible wey you dey read so o. grin grin.
I know your next move. You go make another excuse talk say na hidden context, or na hyperbole abi na symbolic meaning. grin Or your classic excuse. "You need the holy spirit to understand" grin grin

@bolded, shey your bible talk am abi e no talk am?

Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Dtruthspeaker: 6:29pm On Mar 04, 2021
kingxsamz:
Lmao... You dey point out these things dey laugh grin, shey you no know say you dey prove my point? You no know say you dey prove my point say your bible dey contradict it self?
Your bible talk say dem no know good and bad before eating the fruit.
Nna, e no dey any where for Bible (KJV) wey e talk say "dem no know good and bad" even Satan bible no contain am! grin grin

Bros, broosu, No Road! grin grin
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by kingxsamz(m): 6:40pm On Mar 04, 2021
Dtruthspeaker:
Nna, e no dey any where for Bible (KJV) wey e talk say "dem no know good and bad" even Satan bible no contain am! grin grin

Bros, broosu, No Road! grin grin
Bro this road you're going won't favor you o. cheesy
How many of your colleagues go gree with this your personal opinion? cheesy
Okay, make I ask you two questions.
Why is it called tree of knowledge of good and evil?
Why did they realize that they were naked after eating the fruit, since you don talk say dem already know good and bad before eating the fruit?
Okay, bible no contain am abi?
Okay make I drop verse. cheesy

E talk am abi e no talk am?

Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by 1Sharon(f): 6:55pm On Mar 04, 2021
Dtruthspeaker:
Sheybe glass window, moto and iPhone dey your house, make your wife break one of them, whether you no break her face? grin

Tell me whether you no go answer anybody wey ask you foolish question, whether you no go tell dem say "na my house, na me build am and na me put efritin wey I like for inside free. Nobody, I say Nobody get Right to touch anything wey I tell dem say make dem no touch. Anybody wey try am, Na Die e dey? grin

As Dare Art Alade take talk "Na your fault be dat"! grin
Oh is this what you'll do? Keep exposing yourself
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by 1Sharon(f): 6:56pm On Mar 04, 2021
kingxsamz:
E be like say you don forget say ur sky friend wan test wetin ihn create, con put ihn creation inside the same place wey ihn put tree of good and evil. grin grin you don forget say this your sky friend know say dem go still chop from the tree (as per omniscient) but as your sky friend no too wise, ihn no comot the tree, con allow them chop from am. Later this your sky friend con dey regret dey blame them. Like, who send am message before? grin grin
God is NOT omnipotent lol if you read the Bible..Christians gave him that grand label
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by kingxsamz(m): 7:02pm On Mar 04, 2021
1Sharon:
God is NOT omnipotent lol if you read the Bible..Christians gave him that grand label
grin True...
But they refuse to see the obvious contradictions.
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by kingxsamz(m): 7:04pm On Mar 04, 2021
1Sharon:
Oh is this what you'll do? Keep exposing yourself
He's the type who makes excuses for genocide and killing of babies in the bible. So don't be surprised when he makes such comparison. grin
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by sonmvayina(m): 7:06pm On Mar 04, 2021
God lives everywhere....God is everywhere, He is just hiding in the least place you will ever look to find him.

In Man.

Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Dtruthspeaker: 8:48pm On Mar 04, 2021
kingxsamz:
Bro this road you're going won't favor you o. cheesy
How many of your colleagues go gree with this your personal opinion? cheesy
Bros, dem no join our head oh, so each of us go get e own view as dia eye take dey work.

kingxsamz:
[
Okay, make I ask you two questions.
Why is it called tree of knowledge of good and evil?
Why did they realize that they were naked after eating the fruit, since you don talk say dem already know good and bad before eating the fruit?
Okay, bible no contain am abi?
Okay make I drop verse. cheesy

E talk am abi e no talk am?
Bros you say 2 questions but dis one na 3 questions and na anoda long talk wey you want make I talk dis night on top d one I don talk today.

Abeg, tomorrow go soon come, besides we don travel well-well comot from wetin we dey talk about before, so raise fresh thread tomorrow, den our match go start grin

Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by kingxsamz(m): 9:09pm On Mar 04, 2021
Dtruthspeaker:
Bros, dem no join our head oh, so each of us go get e own view as dia eye take dey work.

Bros you say 2 questions but dis one na 3 questions and na anoda long talk wey you want make I talk dis night on top d one I don talk today.

Abeg, tomorrow go soon come, besides we don travel well-well comot from wetin we dey talk about before, so raise fresh thread tomorrow, den our match go start grin
If you no get point just say so. cheesy
Na simple question I ask, but you want make I open thread make you type epistle. Funny guy.
Shame no gree you give straightforward answer. grin grin it is well.
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by LordReed(m): 9:33pm On Mar 04, 2021
Dtruthspeaker:

Wetin Eve/Adam do eh, already done dey beyond wetin my pikin fit do me!

Dem, wey destroy a Whole World and everything wey dey inside Pata-pata, even before the world get Belle. grin

Ah! Na Over-World Record be dat!

Massive World Proportions Genocide, Infanticide, Animalicide, Worldicide! Hitler, Idi-amin, Saddam combined no still reach dia record.

Na dem hold The World Record (WR) of The First to Commit A Crime.

First Man To Do Bad thing!

First Family to be the Worst Family!

World Record Holders of The Worst Family of the world.

Unbeatable World Champion of Being Worst Family Ever.

Most Proficient Killers (like Rango) "All it takes is One Bullet!

Infact I don get idea, I go try listing out their World Record Achievement!

Nna, My UHD no even near wetin dem do, Nna, e no deserve to die!
Na who make this people dem, no be the god? Why him make jaga jaga people?
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by kingxsamz(m): 9:54pm On Mar 04, 2021
LordReed:
Na who make this people dem, no be the god? Why him make jaga jaga people?
The same perfect God wey dey see the future o. Lmao. grin
These guys be making their god look weak fr. grin grin
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by 1Sharon(f): 10:16pm On Mar 04, 2021
sonmvayina:
God lives everywhere....God is everywhere, He is just hiding in the least place you will ever look to find him.

In Man.
Lol thought you were jewish
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Nobody: 11:01pm On Mar 04, 2021
Dtruthspeaker:
Bros, dem no join our head oh, so each of us go get e own view as dia eye take dey work.

Bros you say 2 questions but dis one na 3 questions and na anoda long talk wey you want make I talk dis night on top d one I don talk today.

Abeg, tomorrow go soon come, besides we don travel well-well comot from wetin we dey talk about before, so raise fresh thread tomorrow, den our match go start grin
Wetin you wan talk about religion wey HellVictorinho never hear before?
E be like say u don dey do too much.
Small thing,you don dey talk too much.
FEEEEEMMMMM!!!!!!!!!!!
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by LordReed(m): 6:26am On Mar 05, 2021
kingxsamz:
The same perfect God wey dey see the future o. Lmao. grin
These guys be making their god look weak fr. grin grin
Had a conversation with some JWs yesterday and they started saying I was blaming their god. Hey, who created things the way they are?
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Dtruthspeaker: 8:12am On Mar 05, 2021
LordReed:
Na who make this people dem, no be the god? Why him make jaga jaga people?
Torch wey no dey work, no go enter market.

Moto wey no move, go still dey factory.

"And God saw every thing that He had made was VERY GOOD, (not just good oh but VERY GOOD)"

And The People wey dey With Him dat time, Dem even Follow Am make every Thing, Dem too Confirm say "It was Very Good".

So, bros Torch wey work for market, if e no work for house after yime don pass Nna NA YOU SPOIL AM!

So leave Matta for Martins!
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by LordReed(m): 8:25am On Mar 05, 2021
Dtruthspeaker:
Torch wey no dey work, no go enter market.

Moto wey no move, go still dey factory.

"And God saw every thing that He had made was VERY GOOD, (not just good oh but VERY GOOD)"

And The People wey dey With Him dat time, Dem even Follow Am make every Thing, Dem too Confirm say "It was Very Good".

So, bros Torch wey work for market, if e no work for house after yime don pass Nna NA YOU SPOIL AM!

So leave Matta for Martins!
You never hear of factory defect before?
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Dtruthspeaker: 8:27am On Mar 05, 2021
HellVictorinho:
Wetin you wan talk about religion wey HellVictorinho never hear before?
E be like say u don dey do too much.
Small thing,you don dey talk too much.
FEEEEEMMMMM!!!!!!!!!!!
Bros, I be Mr Doubting Thomas, I no dey gree anything wey I No see for Nature. Eg That nonsense supposed maths question: 1 egg boils at 7 minutes, 2 eggs shall boil at?

Den come talk say the answer na d same 7 minutes. Bros, I no gree! I no ever write d same 7 minutes, I agree to fail.am dan for anybody to deceive me for wetin me I don see and I get small sense enough to know say E No True.

My Answer be say E no go ever be d same 7 minutes Lai Lai, d increased no of eggs must change d time, even if na small, but make nobody tell me say na d same 7minutes, I no go ever gree!

So now I don understand Evidence and how to find d Natural Evidence, na im make me dey talk d kain thing wey you never hear before.

And when person know say dis world people Sabi Lie, Lie, den person must turn Detective to Uncover that which is True!

So, na so I don be now and now from dere I dey talk.
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Nobody: 8:31am On Mar 05, 2021
Dtruthspeaker:
Bros, I be Mr Doubting Thomas, I no dey gree anything wey I No see for Nature. Eg That nonsense supposed maths question: 1 egg boils at 7 minutes, 2 eggs shall boil at?

Den come talk say the answer na d same 7 minutes. Bros, I no gree! I no ever write d same 7 minutes, I agree to fail.am dan for anybody to deceive me for wetin me I don see and I get small sense enough to know say E No True.

My Answer be say E no go ever be d same 7 minutes Lai Lai, d increased no of eggs must change d time, even if na small, but make nobody tell me say na d same 7minutes, I no go ever gree!

So now I don understand Evidence and how to find d Natural Evidence, na im make me dey talk d kain thing wey you never hear before.

And when person know say dis world people Sabi Lie, Lie, den person must turn Detective to Uncover that which is True!

So, na so I don be now and now from Derek I dey talk.
Actually, I don hear talk wey dey related to religion before.
You,LordReed and budaatum dey talk about wetin dey inside Bible the other time.
Wetin remain?
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Dtruthspeaker: 8:45am On Mar 05, 2021
LordReed:
You never hear of factory defect before?
grin Bros,.Na una do factory defects as una don defect una-self as A diseased Corn Seed Must Produce Diseased Products!

As Dare Alade take sing, "Na your fault be dat"! grin

No Road here, bros!
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Dtruthspeaker: 8:49am On Mar 05, 2021
kingxsamz:
If you no get point just say so. cheesy
Na simple question I ask, but you want make I open thread make you type epistle. Funny guy.
Shame no gree you give straightforward answer. grin grin it is well.
grin You dey Fear! grin

Open fresh Thread make the issue for clear! We don too disturb dis op nonsense thread! grin
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by LordReed(m): 8:52am On Mar 05, 2021
Dtruthspeaker:
grin Bros,.Na una do factory defects as una don defect una-self as A diseased Corn Seed Must Produce Diseased Products!

As Dare Alade take sing, "Na your fault be dat"! grin

No Road here, bros!
Potter make pot, the pot get hole you say na pot get the fault, no be potter wey make pot with hole we go blame?
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by sonmvayina(m): 9:06am On Mar 05, 2021
1Sharon:
Lol thought you were jewish
Lol....Noo oh, i just stated that the jewish beliefs are very similar to the Igbo odinani. I just quote the jewish scripture because that is what people are conversant with....
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Dtruthspeaker: 9:39am On Mar 05, 2021
LordReed:
Potter make pot, the pot get hole you say na pot get the fault, no be potter wey make pot with hole we go blame?
Wen Potter finish the pot, hole no dey, if not you no go carry d pot go house!
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by kingxsamz(m): 9:44am On Mar 05, 2021
LordReed:
Had a conversation with some JWs yesterday and they started saying I was blaming their god. Hey, who created things the way they are?
grin grin I just tire.
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by kingxsamz(m): 9:45am On Mar 05, 2021
Dtruthspeaker:
grin You dey Fear! grin

Open fresh Thread make the issue for clear! We don too disturb dis op nonsense thread! grin
Lol, fear ko.
Abi na you dey fear to answer simple question. You dey find thread to type epistle. cheesy
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by LordReed(m): 9:53am On Mar 05, 2021
Dtruthspeaker:
Wen Potter finish the pot, hole no dey, if not you no go carry d pot go house!
So pot fit put hole for hinsef?
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Dtruthspeaker: 10:32am On Mar 05, 2021
LordReed:
So pot fit put hole for hinsef?
Once Pot carry e-self go house, Na im Must to spoil e-self when e spoil!
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by Dtruthspeaker: 10:35am On Mar 05, 2021
kingxsamz:
Lol, fear ko.
Abi na you dey fear to answer simple question. You dey find thread to type epistle. cheesy
grin i need space make I blow you well-well, make you fly comot! grin

I no want ring, I want stadium with lights, camera and spectators! grin
Re: If God Lives On Earth, Can He Make Heaven? by LordReed(m): 11:29am On Mar 05, 2021
Dtruthspeaker:
Once Pot carry e-self go house, Na im Must to spoil e-self when e spoil!
Person wey make pot come put am where the pot fit fall break, na him we go blame.
1 2 3 4 Reply

Apostle Suleiman- If God Lives In Heaven Then Where Was He When Heaven Was MadeGod Form The Light And Create Darkness, He Make Peace, And Create Evil. Isaiah 4You Can’t Make Heaven If You Take Vitamin C And Eat Titus Fish – Preacher )234

Christianity Would Have Been In The Dark Without Paul's LettersIs Having Sex In The Dream A Sign Of Being Possessed