RetiredHoe's Posts
Nairaland Forum › RetiredHoe's Profile › RetiredHoe's Posts
1 (of 1 pages)
Which of the pics is before and after? No difference. |
There was this girl gbemisola in my early secondary school years. I think I was in js2 thereabout. So she joined our class in js2. We wey dey that class na old student, right from kindergarten to nursery to primary and to secondary. So we know ourselves well. So she joined in js2. The way she behaves and carry herself make people dislike her. She became the talk of the school. Even other classes Junior and senior dislike her. Them go call hairstyle she no go do am she go use attachment braid her hair and teacher no dey talk sef but those wey no do the style, dem dey flog them ehn. Chai And the girl like trouble. She go initiate fight even though she no Sabi fight. If una two dey fight any small thing she go faint. You never touch her sef, she don faint. Naso the gbemisola girl dey always find my bestie Tochukwu trouble. Tochukwu been dey ignore initially. And Tochukwu na one of those Igbo girls with yam legs wey dey always get plenty strength. On a particular Friday, during fellowship I no remember wetin e do tochukwu o, Tochukwu wait make fellowship finish, inside the hall wey we take do fellowship, Naso Tochukwu beat this girl abeg... E beat am sotey she faint, all the attachment for him hair she use hand pull am. Na that day we know why she dey use attachment. She no get hair for head. So maybe na true true faint or usual fake fainting, I Sha know say this girl passed out. Them con need water, teachers dey scream say make we bring water, as a good Samaritan wey I be, I go carry water inside WC, I didn't even pass it to the teacher I jus threw it on her head, walai she wake up begin vomit. Na later I tell tochukwu wetin I do. That Friday was the last day I saw that girl in that school till I graduated |
1 (of 1 pages)