Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,307 members, 7,819,042 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 10:26 AM

Steadyguy's Posts

Nairaland Forum / Steadyguy's Profile / Steadyguy's Posts

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (of 9 pages)

Sports / Re: The Last Portraits Of Muhammad Ali By Zenon Texeira by steadyguy: 11:13am On Jun 06, 2016
haunting...? na wa oo! i think he looks good, considering what he was going through.
he was 74 and he is expected to look old

4 Likes

Culture / Re: You May Be Shocked About How Less You Know by steadyguy: 12:05am On Jun 05, 2016
na wa for nigerians oo.i just checked it and it's only about N150
Culture / You May Be Shocked About How Less You Know by steadyguy: 10:49pm On Jun 04, 2016
my fiance showed me dis ebook on OKADABOOKS website
it reveals very interesting facts about each state in nigeria.
you should check it out

Education / Urgent-check This Out by steadyguy: 12:03pm On May 11, 2016
check this book out on [size=20pt]www.okadabooks.com[/size]

Culture / Black Woman Dey Breastfeed White Pikin by steadyguy: 3:13am On Sep 04, 2015
If you don watch dat film wey dem call THE HELP, you go see as life been dey for dis yankee around 1950s. Dat time, na mostly akata women dey do house helep work for onyibo women. And dat time, na de most popular work wey akata women fit get.

But dis tin no really start today. Even for way back, na akata women been dey take care of onyibo pikin dem. Wetin dat one mean na say onyibo pikin dey spend more time with akata house helep pass dem own mama.

And I believe say dat one dey make akata women to no get too much time to spend with dem own pikin dem. But I fit dey wrong about dis one, na just sometin wey I dey tink.
Den when I begin research dis history about yankee, I come discover sometin wey really shock me!! De tin wey I been find out na say during dos olden days, akata women been dey breastfeed oyibo pikn wey dem been dey take care of. If you dey doubt me, make you check internet and you go still see some photo.

Na wa oo! Dis country history take style dey ova complicated. And dis na time wey dem been dey treat akata people really bad, but dem still allow de akata women to breast feed dem pikin. No be small tin oo! And my quesion come be say, where de onyibo women been dey or wetin dem been dey do when anoda woman dey breast feed dem own pikin?

Imagine say naija woman allow her house helep to breastfeed her own pikin..., lol. I no even wan imagine dat one. Just imagine how a typical naija woman go react when she enter room den come see as her house helep breast dey inside her baby mouth. Ya guess dey as good as my own!!

Any way sha.., dem say culture dey different different. So me I believe say dem get dia reason why dat one been happen during dat time sha...!
Politics / Re: List Of Alleged CIA Agents In Nigeria by steadyguy: 10:07pm On Aug 29, 2015
Saraki seem very suspicious to me too
Politics / Akata Comedians by steadyguy: 5:31pm On Aug 29, 2015
check my profile for my BLOG website

One of de ways wey I dey take pass time when I no get anytin to do, na to go for youtube to watch jokes from stand up comedy. Sometimes, I go spend hours just dey watch stand up comedy. I go watch white, akata, latino and even naija stand up comedian.


But I dey usually enjoy akata stand up comedy. De style of dis comedians just dey different. Dem no get filter for dem mouth when ee come to POLITICALLY CORRECT topics. Dem go talk about any and every tin. Dem no send at all.


And when ee come to dat word- NIGGA, dem dey use am like chewing stick. Dem don make dat word popular for everywhere. No mata how news people try to criticize akata comedians as dem dey use dat song, dem no wan slow down at all.


Den anoda tin wey I notice, na how dem dey always attack Africa and people wey come from Africa. No be small tin oo! Some kind tins wey you go hia from dem mouth go just make ya body shiver. And de audience dey enjoy de jokes well well.


But as pessin wey come from Africa you go see de ignorance for some of de tins when dem go talk about Africa. And den when you meet some people, you go see say dem dey get most of dia ideas about Africa from wetin some of dis comedians dey talk for dem show.


But wetin pessin fit do? Well..., you go just shake head and behave like say de tins wey you dey hia no dey bother you at all. You no wan begin argue with anybody, because dis one fit cause serious quarrel. Trust me, I don see dis one happen before!!



check my profile for my BLOG website
Politics / Dark Skin VS Light Skin by steadyguy: 5:15pm On Aug 29, 2015
Among akata people for hia, dem get dis tin wey dem dey always argue about. Dat tin na de color of dem skin. Yes oo! Dos wey get light skin dey tink say dem beta pass dos wey get dark skin. And dos wey get dark skin no like light skin people.


Dis tin wey I dey tell you be VERY serious mata for hia. Ee dey even cause serious quarel for among family members. Light skin family members dey feel say dem beta pass dos wey get dark skin. Even sef some parents dey show more love to de pikin dem wey get light skin. Dis na sometin wey I don witness with my own korokoro eyes.



And as skin color dey separate one akata pessin from anoda one, na so de way dem hair dey too dey separate dem. De more ya hair take style dey resemble onyibo pessin hair, de more suprerior wey you go feel. No be small tin oo!


Even for office, you go hia tory as light skin akata and dark skin akata dey jam head for. De light skin pessin dey feel say im dey closer to onyibo people pass dos dark skin akata. Light skin dey feel say dem get more onyibo blood pass Africa man blood for dem body.


For hia, de more you separate ya sef from Africa, de beta wey tins go be for you. Lol. Africa don suffer for dis yankee people hand oo! I no blame dem sha..., na we wey dey allow dem to do us anyhow.


Now how dis light skin vs dark skin wahala really start? Well..., history say de tin been start during de slavery time. Dat time de oga dem (slave masters) been dey sleep with de slave women. And when dem born pikin, de oga no go wan make dat pikin to mix with de oda slaves.


So na dis pikin wey get light skin like de oga wey dem dey keep for house. Dis light skin pikin go do de house work instead of to dey work outside for sun and rain. And dem dey eat beta food and wear dress wey beta pass dos wey de regular slaves dey wear.


And den as time come dey pass, dis light skin pikin go come begin feel superior to de oda slaves wey no dey live for main house. Den de light skin people come begin call dem sef CREOLE. Dem begin separate dem sef from de oda akata people.


And as time dey pass, dem begin see dem sef like onyibo too. Aftarall dem papa na de oga of de house. But trust de onyibo wife of de oga! She no go eva give dem chance to claim anytin. Most times, de onyibo people dey reject dis half caste pikin dem. And even till today, onyibo no dey too accept pikin wey any of dia memeber born with black pessin (dat one na sometin I go write about oneday).


So since onyibo no accept dem as one of dia own, and dem no wan mix with dark skin people, most of dis light skin people dey always look down on dark skin akata people.


Now dis one come dey make me to wonda. As far as I know, skin color no too get importance as I been dey grow up for naija. Although some people dey bleach dem skin to dey light in complexion, we still no accept de culture say light skin pessin beta pass. In fact, wetin I know be say, people dey marry opposite dem skin color so dat dem fit mix de color for dem pikin body.


No be until I come dis country wey I come see how skin color among dos wey get African ancestor dey ova important. Na wa oo!


check my profile for more details about my BLOG address
Politics / Re: Buhari Appoints Ogbonnaya Onu As The Secretary Of The Federation by steadyguy: 4:38pm On May 31, 2015
Pangea:
Na the work of okorocha be dis o!

Anyway
Good

Let the work start
Let's go there!
Up change

Who dash okorocha?
You think say na today buhari and onu begin rub minds?
They have been associates for a very long time

1 Like

Politics / Moonshine, Onyibo People Kai Kai by steadyguy: 8:18pm On May 28, 2015
Me and drinks sef, we dey like five and six. Na beer be my drink. Any day any time, na beer I prefer. Sometimes I go drink wine or hot drink. I no too like dis ones. Wine or hot drink dey shack me quick quick. All my friends know say anytime I wan drink, na beer be my choice of "poison".

Guilder be my friend for Naija. "The ultimate" and me dey like five and six. If guilder no dey den I fit go for Star. But as Guilder or Star no dey for yankee and person get to drink beer, I dey "manage" de brands wey dem get here. Most of de beer here dey like wata to me, lol. De tin no dey enter my body like my Guilder. Infact I dey drink am like say na wata I dey drink.

No mind me oo! Alcohol no too good for person body. I know dat one. But I believe say everybody get wetin be dem own vice, and my own na beer. I dey try to no drink too much and come begin miss yan or stagger anyhow. Beer na my own way to cool down my brain afta a "hard days work". Person get to cool down im stress somehow, abi?

Like I talk before, anytin wey no be beer no too dey good for my body. I realize dis one again last weekend when I been drink one kind drink wey dem dey call moonshine. Dis na yankee people dem own KAIKAI. dem dey make am with corn. My friend bring out dis bottle wey contain dis tin. Him tell us say im bros brew am and say de tin strong well well.

For my mind I tink say na just regular home brewed wiskey. But when I test de tin, ee dey like say my body dey on fire. Dis tin dey very hot, de tin burn me from my mouth to my throat and down to my belle. De tin really SHINE my body. Dem ask me to do anoda shut and I tell dem no (for my mind, I tell dem "shey me una wan kill abi?"wink.

I say eh..., dis tin strong to de point wey de odor from ya mouth afta you drink am fit catch fire. Even to make am dey very risky. If de place wey you dey cook am no get enough air to circulate, ee fit explode because of all de vapor wey go dey de air.

I don dey hear moonshine for long, but nothing prepare me for de experience wey I get when I taste am. De drink strong well well.
Politics / Re: Fani- Kayode Shares New Photo Of His Girlfriend In A Swimming Pool by steadyguy: 3:52pm On May 28, 2015
Foolish girl,
Of all de guys wey dey naija, na dis confirmed crazy man you go see to friend.

No worry when time reach, him go write book about how him destroy ya TOTO
Politics / See As Airport Dey Everywhere by steadyguy: 2:07pm On May 28, 2015
Now wey all man don dey buy private jet for naija, I feel say now na de time for us to build at least one airport for the thirty six states wey we get. So dat all dis people wey we no know how dem make dis dem money fit dey land for any state wey dem dey go. But seriously, I also feel say dis one go make ordinary people waka around naija to dey more easy and fast. People no go too dey rely for moto to travel around.

Just like for yankee, every state get at least two or three international airport. You fit dey for ya state and fly out to any part of de world wey you wan go. And den dem get uncountable small small airports wey dey helep serve local travel. Towns we get population like fifty or sisty thousand get dem own airport. And de tin dey work well. If you wan travel go any big city, wetin you need na to join connecting flight from de airport for de small towns.

All you need do na to go online, buy ya ticket and if you buy very early, ee dey dey very cheap. No mata for where you dey live for yankee,you must to find at least one local airport near you wey go connect you to any where you wan travel go.

And no be like awa Arik Air wey just dey take dem passengers do yeye every time. For hia, if any airline mess up with dem service, na so dem business go end be dat. And as competition penty, na so all de airlines dey try to out do odas to attract more customers. So no time for bad service. Air transport dey very efficient for hia. If you no come on time, na so you go miss ya flight. Dat one almost happen to me once. And unless na weather, dem no dey ever get delay.

And even for small towns wey population fit be like five thousand, dem get dem own tinkili airport. Dis one na for mostly people wey get small single engine planes. Na for dos wey just like to fly for entertainment or where people fit go begin to learn how to fly. Most of dis kind airport get flying clubs where people dey come with dem small planes to practice or just fly. And for hia, dem get almost 2000 flying skools where people fit go learn how to fly plane. And all of dem get dem own airstrip where dem training planes fit land and take off.

Even sef, some big companies get dem own runway and planes for dem to transport dem goods and workers from place to place. And depending on ya levels for de owo (money) department, you fit build ya own personal runway for ya compound. Most of dis big people hia wey no wan wahala dem sef to begin drive go airport, go just fly direct from dem house. Now na dis one wey I dey call LEVELS.

For naija we still dey see air transport as one kind big tin, but for hia ee dey like normal tin. Infact, depending on how early wey you buy ya plane ticket and how far you dey go, ee fit dey very cheap (not to talk of fast and safe) to fly dan to drive or use train.
Celebrities / Re: Wizkid Babymama Shares Her Story by steadyguy: 12:42pm On May 27, 2015
NeduLuiZ:
What's the inspiration here angry

So young girls should go around and open their legs to celebs and mother kids out of wedlock in order to get inspired undecided

My dear I tire oo!!

She no know say she still get the shame.

I guess the ashawo needs an OSCAR award

2 Likes

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (of 9 pages)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 48
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.