Zedegit's Posts
Nairaland Forum › Zedegit's Profile › Zedegit's Posts
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 (of 166 pages)
seeteazain:Baba even if dem no dey give anything. Try run am sha. |
Sonnobax15:Odogwu Parana(Love in every word and A tribe called Judah) movies I don watch so no bad. I nobi Nollywood fan though especially after most of our veterans don leggo. Infact to find better Nollywood watch na by recommendation. Funke Akindele dey try too. |
peanutbutterr:If na personal account you fit run am. 2% no bad. Na ya strategy and experience matter but if na prop account omo I no dey o even if na you discover forest. |
JasonNOTStatham:I get question. Abeg person fit use USDT pay for something in Euro? I dey ask because FTMO charge Euro. |
FTMO get academy. How many people here don run course there? Omo na student I be like this o. I don enroll. The courses fa make sense. |
JasonNOTStatham:Yeah the app fine pass the mobile site. But na Dot io for site. Dem even dey send email for activity update. |
JasonNOTStatham:Na better update be this o. Me wey been dey fear crypto. If you get another legit site like that you fit still drop am. Na so crypto site suppose be. Nobi only send and receive. This one you fit swap, trade, send, receive, store. Chai my body dey totori me... Thanks. |
JasonNOTStatham:Na Dot io or na Dot com? |
Banat89:Chai dem go don dey miss my babe Oshoala by now. No tell me say her goals for no matter because that one na lie. |
randy01:On top the rules na only 7% of ya account you fit withdraw even if you make 50% profits. Na that one nobody wan talk here. I no mention say ya challenge money no dey refundable. |
randy01:Bro nobi say the rules too complicate o. Because you go don calculate am know whether na 100 pip or so you go dey target. You go need like 6 to 10 trade to pass am if losses enter. Na the forced lot be the main Koko. Dem go force you trade 0.05 minimum on top $3k account. If you blow 100pip 5 times otilor unless na the $1k instant be 0.01, you go need blow 100pip 9 times but if you reduce am to 60 or 70 pips you fit get like 12.. chance. I hope say dem go last make you see withdrawal collect. Las las no buy prop account if you no get better strategy. |
LincolnOnyeabor:Even if you be guru, remember say market nobi ya mate. Na on top $18 you knack 0.03 lot?Na even almost same position you open am. Come still talk say na investor money? So person give you $1000 na so you wan run am? Hmm. This one na gamble. Because any mistake that money go enter Forest. Na why you go hear story like I flip $25 to $300 but I come blow am. |
randy01:No wahala. But you need open a cent account make the money fit last for you. Let's say you deposit $15, dem go convert am to 1500 cents for you. If you come knack 0.01 lot for cent account, 100pip go be 100cents or $1. You see say your account go last? But I hope say you get good strategy o. Remember say nobi must to trade everyday. |
randy01:Ya highest profit in a trade over the total profits in percentage no suppose pass the profit score. Example If profit score na 25% You buy $3000 hoping say you suppose make 10% to pass evaluation.($300) Ya highest daily profit come be $60 ie highest amount you make for one trade So $60/$300 × 100 20% na ya profit score. E dey below 25% nothing does you. But if e pass 25% you go continue dey trade until e reduce. You go still work am before you go withdraw otherwise you go start again from beginning. |
Bowwow11:Nobi because of 2k Sha na the slapping cause am. If younger brother slap senior brother wife naim mean say he no rate the senior brother at all. But nobi wetin go make am kpai him blood. Normal beating suppose dey alright unless dem don get bad blood or beef taytay. |
My question be say na who come lose for this matter on top #2000? |
JasonNOTStatham:You fit store, buy and sell your crypto and dem fit pay you in naira to your bank account? How long you don dey use them? |
LincolnOnyeabor:I no know wetin happen and I no wan know until market close but as e take be gold technically dey bearish but fundamental come dey reason bull. As e be all man suppose rest as gold vomit over 900 pips from Tuesday to Wednesday. For Ten trade their profit score fit no allow you to chest am. Na like 300pips or 400pips na why I tire. |
JasonNOTStatham:Funded next dey use korapay? You fit recommend 2 website for crypto account? |
Elliotwaveforec:No wahala. But na you go close the trade yourself. Na 70% of that 10% Dem go still pay you. Let's say your account na $3000 you come make $500. Na only $210 you go see collect assuming you pass profit score-25% |
The only good thing though be say dem remove 3 minutes rules and their account na 1 step. |
Elliotwaveforec:Oga go download and read new rules wey go start from June 1. Make Dem no use you shine. |
Elliotwaveforec:Nobi am. If you make pass 10% any Jara na their own. Who dey talk 10% in a day? |
I no say person no go fit still pass dem rules but omo your guru go get level first. Forest hard, I no know why dem wan harder am more. Before you fit pass dem challenge with 1 or 2 trades, come do abrakadabra for 3 more trades to complete 5. Go try am now. You go explain tire until BOOM. Account otilor. |
nzechu:Consistency for lotsize still dey o. No jonse. Go download and read their rules. Even e worse pass. |
nzechu:Omo I think say na only me know wetin dem wan do. ![]() E go loud. People wey no get regulation for Naija. CBEX go be child play. Okay nah. Dey play. |
Elliotwaveforec:Wetin you dey call consistency rule. For $3000 account dem dey force you to trade 0.05 lotsize Total drawdown na $270, 100 pips na $50. You no go lose pass 5 trades, your account otilor. Abi na the profit score I wan talk ? Abi na 10% maximum withdrawal. People wey go fail that challenge no go be here. Bottom line Dem wan Rob Peter to pay Paul. You gat reason am Wella to understand. |
russy1:Any prop firm wey dey use consistency or profit score na scam be that. Marvin, Nostro and Ten trade get am. Run. If you get better prop firm wey no use consistency score and get naira transfer. I go get interest. |
wellmax:You dey naive my brother. You no see as Tinubu dey play chess replace governors or dey sub them like football e.g Rivers? For those wey no gree change party na Efcc he go use pursue dem until their life tire them. Wike wey be FCT minister suppose tell you something abi na how dem take name Inec chairman? Credible no suppose dey dictionary for Naija election. |
Chilipepper:Younger girls have gotten married to far older men. If she no dey ready make she getat. Small pikin still dey worry her. |
Why Dem no use am catch BH? |
pocohantas:You read say he forgive am but your gender still go back to OS. She dey bleep dey send her husband pictures make he dey count scores. |

. Honestly,since the demise of Dem Sam loco,Mr. Ibu, I've stopped watching Nollywood movies cuz they are mostly nowadays an eyesore.
? 😮😮 😮😮