Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,194,393 members, 7,954,572 topics. Date: Friday, 20 September 2024 at 10:55 PM

Naija Got Talents,but Why? - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Naija Got Talents,but Why? (582 Views)

Sunday Oliseh ;We Don't Have The Talents To Win The Next World Cup / Naija Got Talent: Nonsense!!! / Raw Talents Or Football Academy? (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Naija Got Talents,but Why? by djfiifi(m): 11:30am On Aug 14, 2012
I dey vex give dis country wey dem
born me 4 no be joke oooo!!! Small
thing Ogoni man go jump enter
water like fish for days we no go see
dem. See olympics nah, go
swim,dem dey fear water.
Zero medal 4 Naija Hausa man go
enter boat dey shout argungu
fishing festival.
See rowing 4 olympics, dem no dey.
Zero medal 4 Naija Fulani herdsmen
fit shoot arrow from 1km kill anyone
wey wan steal dem cow, olympi
cs reach make dem go do archery,
dem no sabi shoot again.
Zero medal 4 Naija Igbo man go run
from Sokoto to Aba at the slightest
provocation by Boko. See marathon
4 olympics, dem no shw face.
Zero medal 4 Naija Agbero for park
no mind pursue bus for road. See
100metres race 4 Olympics, dem no
sabi run again.
ZERO medal 4 Naija Yoruba man go
remove clothes, wrist watch and
pant to fight 4 Ojuelegba. See
boxing 4 olympics,we no see dem.
Zero medal 4 Naija Warri man go say
warri no dey carry last..... na wetin
Blessing Okagbare, our own warri
babe dey do for last 4 women
200metres race abi she think say
one person dey her back?
Zero medal 4 Naija Na who even
start that nonsense called NAIJA GOT
TALENT sef...?!

(1) (Reply)

Ivory Wins Another Gold For Nigeria / would you let your wife be a football ? / Nigerians Shines In Champions League Match For Chelsea Fc

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 12
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.