Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,150,645 members, 7,809,438 topics. Date: Friday, 26 April 2024 at 09:36 AM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills (10269 Views)
Nigeria Pidgin Proverbs & Their Meanings / ****oyinbo Wey Love Pidgin DIE**** / Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN (2) (3) (4)
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (Reply) (Go Down)
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 5:40pm On Jun 15, 2008 |
ikamefa: LOL. I don b reverse catalyst wey u dey tek style run I dey pull u back? Hehehehe! I no bin kno say my amebo strong reach so! From now on I dey proclaim say I b d Okwaputu reversal 1 of Amebo! My nose long, how u tek know?! D tin long pass pinocchio own sef! Ex-gamuchi = current gamuchi so qualms no dey na im dey take me on d tour! I go mek sure say I dry ihn pocket! LOL. No, ah no wicked reach as dat! |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by ikamefa(f): 8:21pm On Jun 15, 2008 |
omoovie: na wah! wah! @omooovie wetin d i s onye-ocha do you na? hahahahaha you just turn CSI or FBI for onye-ocha ! omoovie: na today? omoovie: Gbam! okwamputu reversal 1 of Nairaland! omoovie: ! |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by drrionelli(m): 8:25pm On Jun 15, 2008 |
@omoovie: Thank you for your questions. I'll be more than happy to try to explain. I seek to expand my familiarization with Pidgin for several reasons. One of which is that I perceive it, rightly or wrongly, to be a common communicative connection among the peoples of Nigeria. Yes, I am aware that English is an official language of the country, and it is a language which I, too, speak and write. Pidgin seems to be a language which has enough similarities to languages with which I am familiar that I feel that it would be reasonably straightforward to learn. As I have posted earlier in this very thread, I feel that a conversancy, if not a fluency, in Pidgin would benefit my better understanding the cultures of Nigeria. No, I am not married to a Nigerian lady (perhaps someday, though!), although I have known (and hope to know more) Nigerian people. I also--again, as posted earlier--would at some time like to visit Nigeria and feel it would be respectful of its citizens to at least attempt to use a language that is indigenous to and comfortable with its people. Now, if I may ask you (and I do so with no antagonism and with no intent to be confrontational): How is it that you feel that I have played the "clever dodger" with respect to answering the questions you pose? And, please know that I have in the time I've spent here at nairaland.com, never felt the need to feel, let alone feign, that I was being unduly attacked. Far from it. Even those with whom I might disagree have afforded me respect of my opinions, which, I assure you, is categorically reciprocal. That being said, you can see that an ability to communicate in Pidgin very well might serve me well when I spend time on this site (something I enjoy doing). Ikamefa--among others--can vouch for me on that! (Incidentally, I don't know if the term "oyibo" refers to a person of Caucasian ancestry or if it is used to refer to non-Africans in general. Just so it might be known, though it is surely of no consequence, I am black.) |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by ikamefa(f): 8:29pm On Jun 15, 2008 |
drrionelli: " " (hahaha black coffee no sugar no cream!) and yes! @drrionelli oyinbo is a yoruba word refering to a person of Caucasian ancestry |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 9:01pm On Jun 15, 2008 |
drrionelli: Ok good! Now that you have answered my questions, thou art free! Carry go! |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 9:03pm On Jun 15, 2008 |
ikamefa: |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by drrionelli(m): 10:02pm On Jun 15, 2008 |
@omoovie: I trust that my most recent posting in this thread has satisfactorily answered the questions you raised. For that I am pleased. However, I note that you did not answer the questions that I raised. Certainly, this is your prerogative, but it still leaves things unanswered. Might I prevail upon you (with all due punctiliousness) to address those that I have raised? By the way, thank you for "freeing" me! |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Mustay(m): 5:51pm On Jun 16, 2008 |
uns mennnnnnnnn i loff this thread o! |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by NegroNtns(m): 9:43pm On Jun 16, 2008 |
Omoovie, ah ah, na u i see so? How u dey manage? Soon as i step foot for ground see ya name i say Oritshe me bee o, last time i run jam dis girl i laff so tey i lock jaw. Omo, e no go tire u, Yar Adua no go come look for u unless to propose marriage, wen d'em discuss contract for Abuja ya name no go comot for list, if Obama become president na you go be im right hand pesin for Africa & Middle East, efrytime politicians and wayo piple dey distribute and share money if dem no give you ya portion of the millions d'em own go baje. ehn e go better, e remain small mah sista Take sofly sofly do. We go eyeball again nah. |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 3:35pm On Jun 17, 2008 |
Negro_Ntns: Hahahahahahah! NO BE GOD?? You jus know na my hand e dey! Infact early this momo my hand plus in b/w my toes sef bin dey scratch me! E b laik say flenty flenty kudi wan enta my hand soon! (To Jah b de glory!) Sha I still use styl tek cross out d runs wey I no want mek e happen! Me & Yara-wetin? Tufiakwa! But eh why u kon dey drag my Urhobo wayo leg out now? No put K leg 4 my runs oh! stillwater: Shuooo! Na so Lag do u sotay broken dey break your head? Ok. Since you b aje of d highest capacity I fi translate am for you jus because am nice! She said: Did they tell you I don’t know that “torchlight” means to have seen someone before? Godddd! See how this Warri girl is just twisting my words and what I was talking about! (I’m trying to run away and you keep pulling me back) Back to the “torchlight” thing! I have asked you about it for sooo long I even grew a hunch back! If I have seen the foreigner before or not then what? What’s your concern? I haven’t seen someone that’s so nosey! So your Indian ex-boyfriend wants to bring you to Jaipur! What will your current Indian boyfriend do? Sit down and watch y’all have fun? Ajes! A sad fact of our country! Me wey no kon sabi my language if I no kuku sabi pidgin I go dey fear to answer Naija! Listen to me! Some kpako is good for you! I bin b aje as pikin but I kon turn kpako by force when I reach 11. Govt college dey bring am out! Once them yab you small you go learn kpako quick quick! |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 3:41pm On Jun 17, 2008 |
drrionelli: Dear drr--I jus tire-- What I posted is called a "jazzman tactic" in my inner encyclopaedia! It was meant to incite you enough to answer the questions in a straightforward manner without mincing words. As you have answered my questions so thoroughly u don't have any worries again. Feel free to learn Pidgin! Who knows, maybe u will get a homegirl to gree for you with enough struggle eh? *wink* *wink* *blink* *blink* |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Ikomi(m): 4:07pm On Jun 17, 2008 |
omoovie: Na jazzman u carry enter here agannn? Air comodore. Ur own too musssh, na soso question with big grammar u go dey ask onye ocha, u be satellite? shhhheeeeewwwwww. Na wetin u do sooteeeeey wey make Negro Lock Jaw. I pray make Yaradua con find u carry u comot 4 Nairaground. LOL I hope am down. |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 4:21pm On Jun 17, 2008 |
Ikomi: Na lie you tuk oh! Na VERY BIG LIE! If na da 1 u dey wish 4 me I reject! I go loss enter Waffi interior! Amadioha + Shango and Olokun sef will baptize Yar Adua with thunda before ihn reach my house! By d time all those ones finish ihn go reverse quick quick! Papa God no even need to show! If Papa kon show ihn own don finish b that! E go need almost thirty voyage to Mecca to tek forget me! Satellite na Stalactite wetin kwonshain me with technology and insai of cave? Wey author of this thread I wan yan Japanese with am since na Japan e dey! Nihongo o hanashite kudasai ne! |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Mustay(m): 9:12am On Jun 18, 2008 |
na wa for this nairaland o! if u no quick participate for thread, them go turn am to one clique thread wey you no go fit participate in |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 6:14pm On Jun 18, 2008 |
Mustay: O-oh! C nao you don put idea 4 ma head! Oya all further enterers from now on mus to pay gate abi na toll fee N1000 gbam! |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by NegroNtns(m): 6:40pm On Jun 18, 2008 |
Omoovie, Belle sweet me as I take eyeball u again so U yasef know say mah tongue no go efa make dat mistake lai lai come misspoke about mah Urhobo pipl. If u comot Urhobo for de equation na hin be say no more trade an comace for obodo Nigeria, de tresury go dry, budget papa go get hunchback. Abeg, no send Yar'adua go Mecca oo. E be like u forget de time Idiagbon go Mecca Babangida come capsize hin administration. Sometime sef I wonder if no be for Warri dem born IBB, hin calculation for opotunity no dey efer miss. Abi I lie? Ikomi make u tell ya sista oo. E go better o, u no go sleep jam Abacha for dream lai lai, the oiel well wey dey ya backyad no go dry. Sofly sofly for the Japanese, make u no begin wakabout wrapper no fit ya body simply for the consequence say you dey yarn hanashite kudasai. |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by drrionelli(m): 7:16pm On Jun 18, 2008 |
@omoovie: "Jazzman tactic"? "Inner encyclopaedia"? |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by smile4kenn(m): 7:34pm On Jun 18, 2008 |
na wa oo, this tread don go far oo |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 8:35pm On Jun 18, 2008 |
drrionelli: Heheheheheeh! Did I lose you? Negro_Ntns: Awwwwww! You sho shweeetttt! You yasef know say mah tongue no go efa make that mistake lai lai come misspoke about mah Urhobo pipl. If u comot Urhobo for de equation na hin be say no more trade an comace for obodo Nigeria, de tresury go dry, budget papa go get hunchback. Abeg tell them oh! Abeg, no send Yar'adua go Mecca oo. E be like u forget de time Idiagbon go Mecca Babangida come capsize hin administration. Sometime sef I wonder if no be for Warri them born IBB, hin calculation for opotunity no dey efer miss. Abi I lie? Ikomi make u tell ya sista oo. Amen and Ase plus Ami include Ise till da end of infinity fa! As 4 ya last sentence Y e b say pepper dey pepper u say I sabi rap d tin? You dey jealous say my tongue fi do dagbo dagbo pass ya own? Heheheheheeheheh! No worry, God dey! smile4kenn: For realz o! Wey u mek we nak tori for nihongo! |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by NegroNtns(m): 2:06am On Jun 19, 2008 |
Omoovie, Your aggregate for backside na TKO. I dey behind you last time u reach down grab something for floor. Lord haf mercy, this woman go make me passout! The flashing wey u flash me still dey my head since nefer comot. Na God save me sey I no dey on top ladder de time, na so i for loose balance fell off. Efen sef sey my two foot dey ground i still catch wobble for my waka. e consain me say u go begin yarn "hanashite kudasai" all dat ikebe come turn flat and ya eye begin squint nah. |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Ikomi(m): 10:37am On Jun 19, 2008 |
Negro_Ntns: Holy Moses. Now thats way beyond me. |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Mustay(m): 10:39am On Jun 19, 2008 |
omoovie that one na e-corruiption ole! i nefa tell u say na efcc i dey work for |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 3:37pm On Jun 19, 2008 |
E-corruption my giant ikebe! Shuooooo! Na Efcc u dey work 4 & den? What kwonshains u? I dey dissapia laik magic u no fit find me! Wah! Vwoskidia! Against u and all ah them! Una no go shake not to talk of break my pedestal of shishi lai lai! Come first! Otapiapia dey wait you! I go buy u plus your landlord! LOL! Na joke I dey joke oh! No quote man pikin abeg!
Chineke me ni hiojo c this datty boi! Na which kain microscope u dey use tek e-stalk man pikin wey u tek c my ikeberide? Small time u go kon dey e-block man pikin 4 Yahoo Messenger! I don dey fia u oh! Me? Flash u? Abeg no let my future husby hear am doh! I b Oghene pikin! Sotayyyy sotayy u don formulate time wey I benn down flash u too plus ladda tori fa?! Jehovah Jire, I cast Negro out! Papa God free me from da clutches of sin!
hahahaahahah! You b raZzzzzz! Agbaya man! Na real my eye begin squint! No b squint 4 them oh na management! Na so Papa God create d tin! Plus this ikebe full ground e no dey go nowia! Owo and starch is stronger dan the sushi! Pounded yam and egusi go repump d tin no worry! LOL.
Ikomi we don lost u? Ee-yahhh! Area! We no dey carry last! I don raise d toll fee 4 dis thread to N5000. Going! Going-er! Going-est! |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by NegroNtns(m): 6:46pm On Jun 19, 2008 |
Omo, On mah behalf spik tell ya husband hin get lucky boku well well for to get woman laik u for hin right hand o. God forbid I go look for another man treasure. You make my jaw begin ache afta I read "otapiapia" but I take jeje release de ache before e go enter lock position Otapiapia dey bring memory wey i no fit narrate for dis room for sake of sey I don put hand for Bible swear I no go efer tell de joke again. Comot joke put for side. Tell me 'bout de nunyabizness thing. Na true? |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 3:58am On Jun 20, 2008 |
Negro_Ntns: Wetin u wan kno about d nunyabixnix tin make I explain? I have accepted your apology on behaf of my future husband. I still dey single ready 2 mingle sha till ihn show face as Papa God will am. I wan hear d Otapiapia tori! I wan hear d Otapiapia tori! Oya tell me! I don settoh like say I dey watch tales by moonlight! Oya! Tori Tori! Tooooori! No worry, I go mek sure I no tell Papa God 4 prayer say u break ya promise! |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by NegroNtns(m): 5:20am On Jun 20, 2008 |
Omo, Efrytime u step foot for door, e be like new moon appear for sky, na so de place bright like say u carry lantern for hand shine ya way enter. "Come hither with Thine oil burning lamp, blind I am, but in Thou I sense a glorious spirit" ehn, de business ting, e for better make i whisper you for letter. Our elders, when diem split kolanut, if hin get too many eyes diem dey postpone consultation of the ancestors till anoda day, hehm, too many eyes dey here. I felldown yesterday, I no know if na cause of palmy or somebody spill oiel for ground, I nak skull for rubber plastic wey dey for side, now I don loss memory. ehn nah, i no fit remember de otapiapia tory again ooo. ehn no vex mah sista. mi ni wado. |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Mustay(m): 8:29am On Jun 20, 2008 |
hmm I dey suspect somethin - \negro and Omo Hmm hmm hmm I be investigator o! |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by drrionelli(m): 5:37pm On Jun 20, 2008 |
@Ikomi: It seems that omoovie seems to take great delight in "losing" people. Seems she lost me and she lost you, too. That's a shame. I thought that a language served the purpose of communication, not obfuscation. |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 8:55pm On Jun 20, 2008 |
Mustay: Even to say u laik investisgate till you turn to mouse sef u no fi fain nathin! Negro_Ntns: mm-mm! C toasting! Look me laik ayana with my spear! Sotay u quote Bible verse on top! E b lai say u don dey code my heart oh----------------------------------------------------------------------------------He he he! Psyyy-che!
All da 1 na jazzman d-more-u-luk-d-less-u-c u dey try do me oh! Not to Urhobo wayo I sabi? If u no nak me d tori I no dey gi u d korret tin se u get? Eh-hen! I wan hia tales by moonlight today today! Go bring da memory comot 4 where e don loss enta! @ drrrr*sigh* Obfuscation is my middle nameeee! How did you know?! Obfuscation na im dey sweet me 4 belle! Ah! Tru-tru d tin dey mek me koo-leh! But hey, I did translate Ikamefa's post somewhere on this thread i'n it? Go learn some pidgin from that! See? I'm helpful! *chessire cat grin* B.T.W., jazzman tactic connotes a magician's flair. As for inner encyclopaedia---I don't think I should have to explain that one. What's your inner encyclopaedia__________? Get it? Wey that mai sis Ikamefa? Una dey miss am like me? No worry sebi na me b Okwamputu reversal 1 of ND, I go drag am back from ihn cafe 4 gamuchi-land! |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by NegroNtns(m): 9:20pm On Jun 20, 2008 |
Mustay, You no lie, u be true true infestigator, ehn nah da way you take wrap efrything up draw conclusion make me belief say u sense someting. Oga, i know better ting wen i see one nah. mah own no go baje ooo Omo no be da kin woman u go let pass no pay attention. Abi I lie? Drri, u sabi mess man pikin up efrytime i curl mah tongue and suck mah lips to pronounce dat word nah so i dey shower pipl face with spit. I don give up 'fore some pesin go vex come start misunderstanding. Omo, i hear ya footstep, turn head look i see ya approach light, so i know sey u don enter. Which one u dey, no mind mustay oo. Abeg make you write me, I no lie i wan know 'bout de business ting. Dis no be shakara, i dey serious. nwanne i get question, no tell me say na you dey dat picture so. ehn? |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 9:27pm On Jun 20, 2008 |
No b me 4 da pishure oh, na jus dancer. I like as d bead them tek turn to rainbow! I fyne but na only special peeps dey c my pishure se u get? If to say u c mai pishure nao u go faint think say na another jazzman I dey try run! I no lepa at all! I be korret thick madam! |
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Esss(m): 9:31pm On Jun 20, 2008 |
i dey hail o! |
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (Reply)
Origin Of Why Hausas Call Igbos Nyamiri / Meet These Beautiful Shuwa-arab Girls In Nigeria (photos) / Not Being To Lagos, a 'bush person'?
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 103 |