Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,720 members, 7,809,733 topics. Date: Friday, 26 April 2024 at 02:06 PM

People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills - Culture (5) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills (10270 Views)

Nigeria Pidgin Proverbs & Their Meanings / ****oyinbo Wey Love Pidgin DIE**** / Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (Reply) (Go Down)

Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Mesmerize(f): 6:43pm On Jun 26, 2008
Mustay:

wetin that one mean?
cool cool
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 7:04pm On Jun 26, 2008
luck007:

omo boy!na so we go de dey!! like edede when nor dey eat food when peppe dey!!!! very so una go hear say person don write book wit pigin

Chai! Omo e fi be o! Not to Acata bin dey this thread dey copy note laik photocopier earlier? Wetin b d guy name again sef---drrrrrr*Chai! Chineke I don tire!*
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Mustay(m): 2:58pm On Jul 03, 2008
shworrrrrrrr shocked shocked shocked

na so dis thred go dye so?
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by shuppie(f): 3:35pm On Jul 03, 2008
una do well, grin grin grin grin grin
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Mustay(m): 9:40am On Jul 04, 2008
we nor do well o!
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by smile4kenn(m): 12:48pm On Jul 04, 2008
na wa ooo, abi to type pidgin dey hard?
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Mustay(m): 11:33am On Jul 08, 2008
i still dey wonder o!
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by NegroNtns(m): 9:13am On Jul 09, 2008
My people how una dey? Man don waka go come back nah say make I step foot for ground see how una manage. E get as market be o, money don dry for pocket, rich man sef dey halla no know where to turn double hin money. Nah wa wa for dis obodo. Se una go still dey? Make una no comot make i run go for yonder quick quick see how Chief dem dey. I hear hin don sack two of hin wives for sake hardship done land for him door post. grin

E be like omo still dey vex for man pikin. She don carry herself go dance disnambari for obodo khatmandhu. Na wa for dis urhobo pikin.
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 4:14pm On Jul 10, 2008
Negro_Ntns:

My people how una dey? Man don waka go come back nah say make I step foot for ground see how una manage. E get as market be o, money don dry for pocket, rich man sef dey halla no know where to turn double hin money. Nah wa wa for this obodo. Se una go still dey? Make una no comot make i run go for yonder quick quick see how Chief them dey. I hear hin don sack two of hin wives for sake hardship done land for him door post. grin

E be like omo still dey vex for man pikin. She don carry herself go dance disnambari for obodo khatmandhu. Na wa for this urhobo pikin.

Eeehyahhh! you don get broken-plate heart? No worry if thine love be true, then to thee I shallst return. wink grin keep d toasting coming cheri I need more amusement ______erhhhmmm loving. LOL. *wink*
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Joan2(f): 10:27am On Jul 11, 2008
I just reach work now, say make I check wetin dey happen. I get University where dem dey study pidgin english incase anybody wan learn. Make I kukuma use dis ogbonge oppotunity let una know say some pple dey really try to learn this language but dem know fit. So if u sabi am, dey proud dey speak am. I bin get one friend for school wey we dey yab because ehn no fit talk one complete sentence for pidgin and ehn say ehn grow of for Lagos for Surulere for dat matter. Anyway sha un do well
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Zhea(f): 10:35am On Jul 11, 2008
i dey try small small for lean dis kain language

no be easy o

i never know them dey get school for learn am!

i fi talk am betten than write. to write pidgin na difficult o!
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Zhea(f): 10:36am On Jul 11, 2008
a hope nobody go laugh about me , grin una go think me i dey yeye person
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 3:26am On Jul 15, 2008
Zhea:

a hope nobody go laugh about me , grin una go think me i dey yeye person

No-o we no go laf u d mata b say at least u sef dey try learn d tin. E get peeps wey no sabi go kon dey yan kpata about peeps wey sabi laik say all them na kpako in d highest extreme. You no get to live 4 face me I face u to tek sabi pidgin. D tin no hard as lai that. Gudu luck o. Continue to dey learn d tin.

As 4 another mata were my Negro dey? Bros I dey miss you oh. I don dey feel lonely. You no wan toast me again? I go cry oh! & I dey wowo wey I cry! I no go Khatmandu abi na gamuchi gam gam land again I don gri for u y u kon desat me at my lowerest awa? cry cry cry ehn? Na wetin I do u? Oya toast me quick quick b4 I vex kon begin cry laik omomo kon dey rap French instead!! nnhhhhhhhnnnnnnnnn je vais pleurer----nnnnhhhhnnnnnn-----est-ce que tu vois que tu as fait maintenant?
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Pataki: 8:29am On Jul 15, 2008
Shuooo. . . .Na so this kain thread dey here? shocked shocked

How far my people? As I dey take read this thread, I see say pidgin yinglish get levels for area!!!! E don tey wey pesin yarn hin own better talk. . . . . na so so yinglish full guy man mouth this days.

As e take be now, man go gast dey represent and vomit for this kain thread everly, make pesin dey rub minds wit greater minds. or I for do now? grin grin

Nothing do us walai! Nothing do me enter sef. . . . We everly dey solid like aso rock. cheesy cheesy
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by NegroNtns(m): 1:40am On Jul 16, 2008
Hahahahahaha, Omo, you make laff so tey I nearly lock jaw. eeyah, wado :-) I like as u tek french blow the cry nah, e get as e do me, u sabi ya game well well. Na God don catch u, u see how e be for bodi? U waka comot, jus disapea poooff, no luk back, lef me for hia for inside dark. E bad reach say i no fit siddon hia again, na so i dey knock enter quick quick leave comot. Evfrywhere i go na so i dey luk left, right say i fit see ya light, i come be like agbero wey lost something. Belle sweet me as i take eyeball u so my sista. grin
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by NegroNtns(m): 1:41am On Jul 16, 2008
I don spit tire and I still no see whispa, Omo, wetin happen? Oya put action for ground make u knock dat one comot for list naw cool
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Mustay(m): 5:34pm On Jul 31, 2008
una nefa notice say this site don dey automatikali correct awa language?

if persin wryte d.is e go schange to THIS! angry
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Viante(f): 1:39am On Aug 03, 2008
@Mustay

No be una two wey kon hash dis wikkid plan

now you dey form say u no dey amongst
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by smile4kenn(m): 5:52am On Aug 04, 2008
dis kin thread self, nobody sabi pigin again?
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by chamotex(m): 2:56am On Aug 07, 2008
omo. hungry don scatter my head like dis. . , man must wack sontin o

some people dey yarn correct vibes for hia but all d same, pigin pass pigin

i be want make all of una dey represent pigin for anywhere una dey

me like dis, i must to nak pigin everyday. . . .abi no be so? grin grin grin
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by omoovie(f): 2:20pm On Aug 07, 2008
Negro_Ntns:

Hahahahahaha, Omo, you make laff so tey I nearly lock jaw. eeyah, wado :-) I like as u tek french blow the cry nah, e get as e do me, u sabi ya game well well. Na God don catch u, u see how e be for bodi? You waka comot, jus disapea poooff, no luk back, lef me for hia for inside dark. E bad reach say i no fit siddon hia again, na so i dey knock enter quick quick leave comot. Evfrywhere i go na so i dey luk left, right say i fit see ya light, i come be like agbero wey lost something. Belle sweet me as i take eyeball u so my sista. grin


C nao u kon reply when dem don ban me from Nairaland for work. My boss say wetin I dey do for chat site everyday from sunup to sundown? Na d work dem send me b dat? Naim me I desat nairaland o until I fit enter am from home. Ekabo my dear.
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Moyola(f): 2:22pm On Aug 07, 2008
i tInk sey i sabi pidgin 4 writin!! smiley

buh i bite myself speakin it!!! cry
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by pfeifer(f): 1:59am On Aug 16, 2008
omo, guys me na pproverbs i for like drop for ere o

our pipo say na tree wey near each oda na im make monkey dey smart,

na from clap na im dance take dey start,

who belleful must to hungry again,

siddon look na dog name

na with full coperation na im rice take full pot

who dey cry still dey see road o,

no mata wat,ogoro(frog) must jump, lol

i still dey come back, make i do oda tins, nairalanders i hail una oooo
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by alarainey(m): 8:21am On Aug 27, 2008
Na wa o!

Why Ogoro must jump? shocked shocked
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Mustay(m): 4:12pm On Aug 27, 2008
no use proverbs dem spam dis site o! tongue
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by ssRhino: 1:01pm On Aug 28, 2008
How Una dey now, i dey all una guys oh
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Nobody: 1:15pm On Aug 28, 2008
Abeg who fit tell me d name of d owner of obino music.
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by KnowAll(m): 12:56pm On Sep 03, 2008
Proverbs in Pidgin " Man no die, Man no rotten
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by KnowAll(m): 1:00pm On Sep 03, 2008
Proverbs in Pidgin " Man no die, Man no rotten - what does it mean, it means you are fine. Used when someone ask you how you are fearing or how are - you say " Man no die, Man no rotten ". you can also use " Body de inside cloth " same meaning.
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by spben(m): 9:13pm On Sep 14, 2008
i troway salute , as una dey take your ogbonge hand dey type sense here , i love una kiss
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by carmelily: 2:39pm On Oct 29, 2008
spben:

i troway salute , as una dey take your ogbonge hand dey type sense here , i love una   kiss

you don fumble! your = una. grin
Re: People Wey Sabi Write Pidgin: Make Una Show Una Skills by Nobody: 12:50pm On Nov 09, 2008
Ol boi eeeh. Na me hapi pass to see dis thread. In fact eh, I don tire to dey teach all my people for dis obodo oyibo wey I dey now. Everybody wan learn broken, dey say d thing is soo coooool. Omo, and we wey get d language go dey form for am, abegi make we proud oh. twaleee!!! I go recommend dis thread for all dose my oyibo friends wey too like naija.

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (Reply)

Origin Of Why Hausas Call Igbos Nyamiri / Meet These Beautiful Shuwa-arab Girls In Nigeria (photos) / Not Being To Lagos, a 'bush person'?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 39
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.